In fotos: How Christians celebrate Palm Sunday around di world - all you need sabi about dis day

Wia dis foto come from, Getty Images
Christians around di world don gada to commemorate dis year Palm Sunday.
Churches dey hold processions and share palm fronds wey some dey later save and burn to create ashes for di following year Ash Wednesday.
For some churches, di congregants sometimes dey go home wit di palm fronds.
Palm Sunday na important date in di calendar for dose wey dey follow di Christian faith.
Churches and cathedrals dey hold special Palm Sunday services to mark di occasion.
But wetin be Palm Sunday, and how dem dey celebrate am?

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin Palm Sunday dey all about?

Wia dis foto come from, Getty Images
Palm Sunday na special day for many Christians. Di day dey mark di start of somtin wey dem call Holy Week and e dey always fall on di Sunday bifor Good Friday and Easter Sunday.
E also dey mark di last week of Lent wey be di time wen lots of pipo dey give up somtin dem love for 40 days.
End of Di one wey oda users dey read well well
Palm Sunday dey celebrate Jesus arrival for Jerusalem just days bifor im death. Di Bible, wey be di book wey Christians dey read, say Jesus bin ride into di city on a donkey. Pipo bin wave palm leaves and cheer am.

Wia dis foto come from, Getty Images
E get many different tins wey Christians dey do on Palm Sunday to celebrate.
One of di most common traditions na for worshippers to to hold small crosses wey dem make wit palm leaves. Dis dey serve as important reminder of Jesus arrival for Jerusalem and im death soon afta.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images
Some Christians dey keep di crosses for dia homes, but odas dey burn dem and save di ashes to use on Ash Wednesday di following year.
Palm Sunday also dey give Christians di chance to reflect on di final week of Jesus life bifor dem celebrate Easter.
Why Christians dey celebrate Plam Sunday
For many Christians, di symbolism of Palm Sunday dey beyond historical remembrance – na opportunity for believers to consider di deeper spiritual message wey dey behind Christ entry into Jerusalem.
E bin ride donkey, one humble animal, enta Jerusalem, Dem believe say Jesus bin present imsef not as conquer king, but as messenger of peace.
Palm Sunday dey mark di beginning of Holy Week and commemorate Jesus Christ triumphant entry into Jerusalem as di bible describe am.
Di name originate from di palm branches wey di crowd bin wave to greet and honour Jesus Christ as e enta di city.
Christians worldwide dey celebrate Palm Sunday, wey be di first day of di Holy Week.
For Western Christianity, dis na di beginning of di last week of di solemn season of Lent, bifor Easter.
For Eastern Christianity, Holy Week dey start afta di conclusion of Great Lent.
Di day na both celebration and prelude to di sombre events of Good Friday and Easter Sunday.
Dis year Palm Sunday fall on 13 April.

Wia dis foto come from, Getty Images













