Eid el Fitr in photos - How Nigeria, rest of di world take mark end of Ramadan

Nigeria President Bola TInubu attend Eid morning prayers.

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Nigeria President, Bola Tinubu
Read am in 4 mins

Nigerians join di rest of di world to mark di Eid el Fitr on Sunday, di Islamic event wey mark di end of di Ramadan season.

Di Nigerian Supreme Council for Islamic Affairs (NSCIA) under di leadership of dia President-General and Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammad Sa'ad Abubakar III, declare Sunday as di first of Shawwal and Eid day.

To celebrate di Eid Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammadu Sa'ad Abubakar, advise Nigerians make dem no insult dia leaders.

Nigeria President Bola Tinubu on im part tell Muslims to kontinu wit di good deeds wey dem learn during di month of Ramadan.

Im tok dis one call afta im observe di Eid-El-Fitr prayers forn di National Eid ground Abuja on Sunday.

Oga Tinubu tell Nigerians make dem no go back to di past but to live a religious and charitable life and dey committed to good deeds.

Ontop im official social media handle, oga Tinubu pray say "As Ramadan dey end, may di blessings remain with us. May our sacrifices born renewal, and our dear nation find peace and progress.

Di Vice President Kashim Shettima, Deputy Senate President, Barau Jibrin, National Security Adviser, Nuhu Ribadu, and some members of di Federal Executive Council and lawmakers join am do prayers for di National Mosque.

Muslims around di world dey celebrate Eid-El-Fitr, wey mark di end of di holy month of Ramdan.

Eid-El-Fitr, wey mean di festival of breaking di fast, na time to thank Allah, do plenti good tins ey go bring peace.

Fotos from Eid-El -Fitr celebrations

Nigeria President Bola Tinubu wear creamy-brown attire, im sitdon for chair beside Vice President Kasim Shettima wey wear greencap and sky blue cloth with dark sunglasses.

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Nigeria President, Bola Tinubu showface for National Mosque Abuja for Eid prayers
Nigeria President, Bola Tinubu wit oda cabinet members go pray for national mosque.

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, President Bola Tinubu for National Mosque Abuja
President Bola TInubu wear light brown cloth for di far right, near Vice President Kashim Shettima wey wear hite cloth and green cap.

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, President Bola Tinubu during Eid prayers.
Muslims perform di morning prayer around

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims perform di morning prayer around di Kaaba for di Grand Mosque for Saudi Arabia holy city of Mecca for di start of Eid al-Fitr.
Muslim women

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslim women gada to perform di morning prayer for di Grand Mosque for Saudi Arabia holy city of Mecca for di start of Eid al-Fitr
Govnor of Kano State, Abba Kabir Yusuf wear all white cloth wit red cap, e sitdown for ground for prayers.

Wia dis foto come from, Kwankwasiyya Reporters

Wetin we call dis foto, Govnor of Kano state, Abba Kabir Yusuf Kano state Alhaji Abba Kabir Yusuf attend di Eid prayers for di big mosque of Idi in Kofar Mata area.
Foto of his royal highness, Emir of Kano, Malam Muhammadu Sanusi Lamido II. E wear black and whir robe wey cover all im body.

Wia dis foto come from, Kwankwasiyya Reporters

Wetin we call dis foto, His royal highness di Emir of Kano Malam Muhammadu Sanusi Lamido II, do Eid prayers for di big mosque of Idi in Kofar Mata area. Kano state.
Muslim gada for Eid prayers for Kano state, northern Nigeria.

Wia dis foto come from, Musa Alqasim

Wetin we call dis foto, Nigerians gada for Bayero University, Old site Kano for Eid prayers
Foto of a family as dem gada go Eid ground for prayers for Abuja, Nigeria capital.

Wia dis foto come from, Ismail Sadiq

Wetin we call dis foto, Families gada for Eid prayer ground to celebrate Eid-El-Fitr for Abuja, Nigeria capital
Muslims wey dey pray

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims pray during di Eid al-Fitr morning prayer to mark di end of di Holy month of Ramadan, on March 30, 2025 for Rome, Italy.