Police ban Durbar in Kano for dis year Salah festival

Sanusi Lamido and Ado Bayero

Wia dis foto come from, Sanusi Lamido Sanusi/Aminu Ado Bayero Getty Images

Read am in 5 mins

Di Kano state Police Command don cancel Salah Durbar, wey be festival wey dem dey do during Muslim Eid celebration for Kano, Northern Nigeria for dis year.

Dem announce dis one for press briefing wey Kano Commissioner of Police, CP Ibrahim Adamu Bakori, do for Bompai Police Headquarters on Friday.

CP Bakori tok say dem take di decision afta dem check and analyse di security situation for di state, especially as tension dey rise and uncertainty dey around di Durbar activities, particularly wit di wahala wey fit happun if dem allow am.

"As part of our collective effort to maintain peace and security, we don place ban on all Durbar activities for di whole state during the 2025 Eid-El-Fitr Sallah celebrations."

E still add say, "Dis decision come afta consultation wit di security stakeholders based on strong intelligence report wey show say some pipo don recruit miscreants and dem sponsor plan to use Durbar as way to cause trouble and scatter public peace."

E advise all worshippers make dem do dia normal Eid prayers for di places wey dem suppose do am, just as dem dey do am before, sake of say di police don already arrange enough security to make sure say everywia dey safe.

Even for di last Eid-el-Kabir wey pipo sabi as big Salah, dem still cancel di Salah Durbar, and many pipo believe say e get connection wit di Emir wahala for Kano, afta di state Govnor, Abba Kabir Yusuf, dethrone Aminu Ado Bayero from im throne.

Salah Durbar na big tradition wey thousands of people dey attend for royal horse parade for Kano, and e don dey happun for more dan 200 years. But dis year same as last year, di three-day Durbar, wey be horse parading ceremony, don dey cancelled.

Wetin be Salah Durbar and why e dey important for Kano pipo

Kano State na one of di states wey get long history for di royal Durbar festival. Pipo from neighboring states and even far places dey waka come Kano to see di event.

Salah Durbar na big tradition wey thousands of pipo dey attend for royal horse parade for Kano, and e don dey happun for more dan 200 years. But dis year same as last year for big salah, di three-day Durbar, wey be horse parading ceremony, dey cancelled.

But no be di first time wey dem go cancel Salah Durbar because of different reasons.

Di cancellation of dis year' Eid-el-Fitr Durbar go shock some Kano pipo, but some no go surprise because na di second Salah back-to-back wey dem no do di Durbar.

Sake of dis celebration many pipo for Kano especially youths dey prepare well-well for di festival season as dem dey buy equipment wey include horses or get horse for hire just to participate for Durbar.

E go be anoda disappointment for di 16th Emir Sanusi Lamido Sanusi wey get im throne back afta di govno of Kano state dethrone Aminu Bayero as Emir of Kano.

Dis year durbar cancelation dey connect wit di both Emirs afta for recent week dem both fix separate durbars for Kano den Emir Bayero later cancelled im own durbar in oda to avoid any kain of conflict in di state, according im.

Even though di police for Kano tok say na sake of security wahala dem cancel am, but for many pipo e dey clear say na because of di kasala wey dey between Kano govnor, Emir Sanusi Lamido Sanusi and di 15th Emir Aminu Ado Bayero wey still dey for Kano even say di govno Abba Kabir Yusuf don dethrone am.

Brief background of Emirates tussel for Kano

Na for 23rd May, 2024 Govnor Abba Kabir Yusuf remove Emir of Kano, Aminu Ado Bayero, and di oda four emirs for di state, and put Sanusi Lamido Sanusi back as Emir of Kano.

Di govnor announce dis one for one press conference wey e hold for Goment House, wia e sign di new law wey di Kano State House of Assembly pass, wey dissolve all five emirates for Kano and remove di emirs.

For im speech on Thursday, 23 May, di govnor tok say: "E dey necessary to bring back di tradition wey don dey for Kano for ova 900 years, so we don cancel di 2019 law wey create extra emirates during former govnor [Ganduje] time."

Di govnor instruct di five dethroned emirs to quickly hand ova dia offices to di correct authorities for di state.

For 20th June 2024, one federal court wey sit for Kano on Thursday cancel all di steps wey Kano State goment take to reverse di Kano Emirates Council Law.

Justice Abdullahi Muhammad Liman order Kano goment to maintain di status quo.

Justice Liman say di pipo wey di case concern sabi say one court interim order dey, but dem no gree obey am, instead dem go ahead implement di law.

Di judge add say, di court go use im power to make sure say pipo obey im orders.

Di court order say make di interim order wey tell parties to maintain status quo ante remain.

But, di court no gree to declare di law null and void.

Dem transfer di case to Justice Simon Amobeda for continuation in view of im elevation to di court of appeal.

Na Kano House of Assembly repeal di law and Govnor Abba Kabir Yusuf sign am into law.

Govnor Abba Kabir Yusuf come remove Alhaji Aminu Ado Bayero as Emir of Kano and replace am wit Sanusi Lamido.

Di govnor also reverse di creation of four emirates: Bichi, Rano, Karaye, and Gaya.

Di Kano Emirates Council Repeal Law 2024 cause kasala between Lamido Sanusi and Aminu Ado Bayero.

For 10th January 2025, Di Court of Appeal for Abuja order fresh hearing into di Kano Emirate legal dispute between di 15th Emir of Kano Aminu Ado Bayero and di current Emir Mohammed Sanusi.

For di Friday 10 January sitting, di court say Kano High Court no dey fair, as dem go about di case without serving Bayero a hearing notice, and dem deny am di opportunity to present im case.