Appeal court order fresh hearing on ruling wey remove Aminu Ado, oda emirs from thrones

L-R Aminu Ado Bayero and Sanusi Lamido

Wia dis foto come from, AMINU ADO BAYERO/INSTAGRAM/GETTY IMAGES

Read am in 3 mins

Di Court of Appeal for Abuja don order fresh hearing into di Kano Emirate legal dispute between di 15th Emir of Kano Aminu Ado Bayero and di current Emir Mohammed Sanusi.

One three-member panel of di appellate court wey Mohammed Mustapha lead, reverse di judgement wey one Kano state high court deliver on 15 July, wey remove Ado Aminu Bayero and four oda emirs from dia thrones.

Di Court of Appeal hold say dem deny di appellant right to a fair hearing, sake of how di Kano High Court carry out proceedings against am.

Neither di Kano state goment or Emir Sanusi don react to dis ruling.

For di Friday 10 January sitting, di court say Kano High Court no dey fair, as dem go about di case without serving Bayero a hearing notice, and dem deny am di opportunity to present im case.

Justice Mustapha hold say all courts dey bound to ensure justice by giving all parties equal opportunities to present dia cases.

Di panel add say dem suppose serve Sanusi too notice to submit im grievances, bifor di court deliver im judgement.

Di appeal court note say di high court decision challenge di credibility of di judicial process and dis don make di intervention of di higher court necessary.

Di panel rule say di proceedings of di Kano High Court bin amount to mockery of justice.

Sake of dat, di Court of Appeal don direct di Chief Judge of di Kano State High Court to reassign di case to anoda judge for fresh adjudication.

Di court as e dey determine one of di issues wey di appellant raise wey gatz do wit fair hearing, hold say dem suppose don notify di appellant and allow am access to counsel aft aim lawyer withdraw from, di mata during proceedings on 4 July, instead court continue to hear di mata without proper notification where necessary.

Di court hold say dat kain action amount to nullity of di entire proceedings wey happun for dat day.

Di appellate court uphold di appeal on di issue of fair hearing in favour of di appellant.

Di court however no award costs against di respondents of di appeal wey Ado Bayero file.

Na for May 2024, Kano state govnor, Abba Kabir Yusuf remove Emir of Kano, Aminu Ado Bayero, and di oda four emirs for di state, and put Sanusi Lamido Sanusi back as Emir of Kano.

Di govnor for one press conference wey e hold for Goment House bin sign one new law wey di Kano State House of Assembly pass, wey dissolve all five emirates for Kano and remove di emirs.

"E dey necessary to bring back di tradition wey don dey for Kano for ova 900 years, so we don cancel di 2019 law wey create extra emirates during former govnor [Ganduje] time." Govnor Yusuf tok.