Federal high court Kano cancel law wey remove Aminu Ado, oda emirs from thrones

Wia dis foto come from, Kano State Government/Facebook
One Federal high court don cancel di law wey dem use remove Aminu Ado and oda Emirs from dia thrones.
Di court wey sit for Kano on Thursday cancel all di steps wey Kano State goment take to reverse di Kano Emirates Council Law.
Justice Abdullahi Muhammad Liman order Kano goment to maintain di status quo.
Justice Liman say di pipo wey di case concern sabi say one court interim order dey, but dem no gree obey am, instead dem go ahead implement di law.
Di judge add say, di court go use im power to make sure pipo obey im orders.
Di court order say make di interim order wey tell parties to maintain status quo ante remain.
But, di court no gree to declare di law null and void.
Dem transfer di case to Justice Simon Amobeda for continuation in view of im elevation to di court of appeal.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na Kano House of Assembly repeal di law and Govnor Abba Kabir Yusuf sign am into law.
Govnor Abba Kabir Yusuf come remove Alhaji Aminu Ado Bayero as Emir of Kano and replace am wit Sanusi Lamido.
Di govnor also reverse di creation of four emirates: Bichi, Rano, Karaye, and Gaya.
Di Kano Emirates Council Repeal Law 2024 cause kasala between Lamido Sanusi and Aminu Ado Bayero.
Na di same law di govnor of Kano, Abba Kabiru Yusuf bin rely on to bring back Muhammadu Sanusi II as di 16th emir, afta di former govnor of Kano state, Abdullahi Umar Ganduje remove am for 2020.
Alhaji Aminu Ado Bayero bin dey appointed by di former govnor Abdullahi Umar Ganduje as di 15th Emir of Kano for 2020 bifor govnor Yusuf comot am for 2024.
For May 2024, govnor Abba Kabir Yusuf bin remove Emir of Kano, Aminu Ado Bayero, and di oda four emirs for Kano state.
Di govnor reinstate Sanusi Lamido Sanusi back as Emir of Kano.
Di govnor announce dis one for one press conference wey e hold for goment house, wia e sign di new law wey di Kano State House of Assembly pass and dissolve all five emirates for Kano and remove di emirs.
For im speech on Thursday 23 May, di govnor tok say: "E dey necessary to bring back di tradition wey don dey for Kano for ova 900 years, so we don cancel di 2019 law wey create extra emirates during former govnor [Ganduje] time."
Di govnor instruct di five dethroned emirs to quickly hand ova dia offices to di correct authorities for di state.
Dis decision come less dan seven hours afta di Assembly approve di law wey cancel di 2019 law wey former govnor Abdullahi Umar Ganduje make, wey create five emirates for Kano.
How di law take come?
For 2019, former govnor of Kano state Abdullahi Ganduje, present one bill for di State House of Assembly to create four new emirates.
But, di court reject di creation of di four new emirates, say dem no follow procedure to make di law.
For May 2019, govnor Ganduje sign di bill into law, to create di new emirates of Gaya, Rano, Karaye, and Bichi - all of dem get district heads under di Kano Emirate.
Di law get 51 provisions, as di Kano State House of Assembly tok during di amendment process for 2019.
Some key provisions inside di old law include;
- Di govnor go get power to select di chairman of di council of emirs to be established later.
- Di governor go appoint kingmakers wenever di need arise.
- Any Emir wey di govnor choose to lead di council of emirs go serve for two years.
- Any emir wey fail to attend di council meetings three times witout valid reason go lose im throne.
For di same month, Ganduje remove di 14th Emir of Kano, Sanusi Lamido Sanusi, and appoint new emirs for di newly created emirates.
Di former govnor tok say di reason for creating di new emirates dat time na to unify di community, improve security, and promote development for Kano State.
Bifor di 2019 law, na di colonial "Emirs Deposition and Appointment" law dem dey use remove emir from im throne and send am to anoda town.













