Delta government withdraw query by provost to student nurse over video against Tinubu wife

Wia dis foto come from, Nurse Osato/Oluremi Tinubu/Facebook
Di Delta State goment don withdraw di query wey di provost of one dia institutions knack one nursing student for di State.
Di provost of Delta state College of Nursing Sciences bin say di nurse go face disciplinary actions afta dem accuse her of "divulging unauthorised publication" online about di visit of Nigeria First Lady, Oluremi Tinubu to di school.
Di student wey her name na Osato Edobor bin dey accused of "posting unofficial response to song during di arrival of di First Lady for her tiktok".
Di video later go viral across different social media platforms on Thursday wia students dey sing for Mrs Tinubu.
For di video, di MC of di ceremony go sing: "Na our mama be dis o, we no get anoda one", but di students dey reply, "na your mama be dis o".
But di expected response to di song suppose be "na our mama be dis o".
As di video dey go round, pipo dey comment say di refusal of di students to acknowledge Mrs Tinubu as dia mama na sign of protest against President Bola Tinubu administration wey many pipo say e dey characterised by plenty hardship and rise in di cost of living.
In response to di viral video, Evbodaghe Rita Ogonne wey be di Provost of Delta State College of Nursing Sciences wia di First Lady bin visit, write query give Ms Edobor, di nursing student wey dem suspect say na she film di video and post am on social media.
Mrs Ogonne say di action of Ms Edobor na offence according to di student handbook of di school, and di punishment na expulsion.
"Diafore, you are requested to explain within 24 hours why we no go take disciplinary actions against you for dis act," Mrs Ogonne write for di query wey dey dated 27 March 2025.
BBC Pidgin don make attempts to contact di school and we dey wait for dia comment.
We also reach out to di media team of di First Lady, but dem neva respond yet.
However, as di query bin go viral and pipo start to dey criticise di school and di office of di First Lady, di Delta State goment issue anoda letter on Friday to say dem don withdraw di query.
According to di letter, na di State Commissioner for Health, Joseph Onojaeme, direct di school to withdraw di query.
"You dey requested to return di query letter thru di students affairs officer to di office of di provost," di letter tok.
Brief background

Wia dis foto come from, Facebook
Di event na di ongoing Renewed Hope Initiative Health programme wey di office of di First Lady dey carry out across di six geopolitical zones of di kontri.
Under di programme, Mrs Tinubu dey distribute kits to 10,000 midwives for each zone.
Di programme reach di turn of di south-south zone bin happen for Asaba, Delta State on 25 March, 2025, and dat na wia di incident for di viral video bin happen.
During di event, students from all di nursing schools for Delta State bin gada in Asaba to receive di First Lady as she dey flag off di distribution.
Di goment of Delta State try to explain wetin happen on dat day. Charles Aniagwu a former commissioner for information in di State tok say maybe di nursing students dey express dia displeasure bicos di giveaway wey di First Lady bring na only for Midwives and not di nurses.
Di threat of disciplinary action against di student wey post di video online don cause big tok-tok on social media as 'Remi Tinubu' dey among di leading trends on X in Nigeria dis Friday morning.
Activist Omoyele Sowore post say im team go provide di student with physical and legal support "to make sure say di authorities for Delta State College of Nursing Sciences not carry out dis act of injustice".










