Appointment of new SSG and oda tins Vice Admiral Ibas don do since e become sole administrator of Rivers state

Vice Admiral Ibok-Ete Ibas and Professor Ibiba Lucky Worika

Wia dis foto come from, Rivers State Government

Read am in 5 mins

E don reach one week since Nigeria president Bola Tinubu declare state of emergency for oil rich Rivers State, Southern Nigeria.

Di president declaration follow di political kasala wey dey happun for di state.

As a way to "stabilize di tension" wey di crisis dey cause, oga Tinubu appoint rtd Vice Admiral Ibok-Ete Ibas as di Sole Administrator of di state.

A day afta di declaration, oga Ibas resume work as di new head of Rivers state government - position wey e go hold for "an initial six months period", according to di president.

However, since e come out of retirement as a former Naval chief, oga Ibas don take some kain steps to show im presence for Rivers state as di sole administrator.

Meeting wit security chiefs for di State

As im resume, di first tin wey di Sole Administrator of Rivers State, Vice Admiral Ibok Ete Ibas (Rtd) do a hold closed-door meeting wit senior security officers, federal goment delegation and state goment officials for Goment House, Port Harcourt.

Dis na afta im enta di state alongside some top military personnel and a representative of di National Security Adviser.

Di meeting hold for di Rivers State executive chambers wit di head of service, permanent secretaries and security personnel.

State broadcast wia e warn against 'lawlessness'

Retired Vice Admiral Ibok-Ete Ibas hold state broadcast on Thursday – a day aft aim arrival.

Di Sole administrator assure residents say im role dey non-political and im aim na at restoring governance and stability.

E reaffirm im commitment to safeguarding civil liberties and ensure safety of citizens.

However, e issue strong warning against crude oil sabotage and violence, and urge residents to reject any attempts to resume attacks.

"Dos wey wan sabotage di social and economic stability of Rivers State and national infrastructure within di state or wey attempt to scata di peace for selfish ends no go like wetin go happun to dem.

"Chance for lawlessness no go dey, no place for violence and no patience for actions wey threaten our collective wellbeing," e tok.

Inspection duties

On Saturday, di sole administrator advise di contractor wey dey handle di state House of Assembly Complex project to finish am fast fast.

Ibas tok say part of im mandate include restoring full and effective legislative activities for Rivers state.

Di sole administrator tok all dis one wen e carry waka go inspect di ongoing reconstruction of di Assembly Complex along Moscow Road for Port Harcourt Local Government Area.

Fresh appointments and resignation

By Monday, oga Ibas start to set up im on goment wit di appointment of some pipo wey go follow am work.

Apart from im Chief of Staff wey don start work already, di Rivers State Sole administrator appoint Professor Ibiba Lucky Worika as di new Secretary to di State goment.

Dis appointment dey come few days afta im enta office for di Southern state afta President Bola Tinubu suspend di govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Prof Ngozi Odu and di house of assembly members for six months sake of di political crisis inside di state.

Ibok-Ete Ekwe Ibas also announce di resignation of head of service for di state.

Dis na all you need to know about di new Rivers State SSG and di head of service wey resign.

Meanwhile di Administrator appoint Dr Inyingi Brown wey be Permanent Secretary Welfare in acting capacity for di Office of di Head of Serviceuntil dem appoint new Head of Service.

Who be Professor Ibibia Lucky Worika

Professor Ibibia Lucky Worika, come from Okirika, for Rivers State.

Im be legal expert, and administrator wey get experience for public service and institutional leadership.

ProfessorWorika get in Ph.D. for International Environmental and Comparative Petroleum Law & Policy from University of Dundee, United Kingdom.

Im don serve for several roles across academia, international organizations, and goment advisory capacities.

Currently im be di Director for di Centre for Advanced Law Research for Rivers State University.

Professor Worika bin previously serve as Dean of di Faculty of Law for University of Port Harcourt, wia im play key role for dia curriculum development, accreditation processes, and collaborations between di university and public institutions.

Aside from academia, Professor Worika also make significant contributions to public policy and international governance.

As senior legal adviser for Commonwealth Secretariat for London, im provide expert counsel to member nations on natural resource management, energy policy, and regulatory reforms.

Im tenure as General Legal Counsel for di Organization of di Petroleum Exporting kontris (OPEC) for Vienna solidify im reputation as a strategic thinker, im role gibve am di opportunity to give advise on complex international agreements, litigation, and energy diplomacy.

Professor Worika consultancy work for goment, include Namibia, Malawi, and Guyana.

Im get several awards too sake of im work.

E collect OPEC Secretariat Award for Distinguished Service and Ogu Council of Chiefs for Rivers State honour am too.

Dis administration believe say im experience for policy formulation, conflict resolution, and inter-governmental relations go help well-well to ensure stability, efficiency, and transparency.