Heavy security mount for Sanusi Lamido Sanusi palace for Kano

Nigerian Police for Kano State, wey dey northern Nigeria, don block di main gate of Emir of Kano palace, Muhammadu Sanusi II, on Friday.
Some sources tok say dem plan to make Emir Muhammadu Sanusi II follow one of di big chiefs for di emirate, Wamban Kano, Mannir Sanusi, go Bichi to start work as district head.
But as police block di gate, e cause wahala - cars no fit enter or comot from di palace.
Even wit di blocking, Muhammadu Sanusi II still do im royal sitting for palace like normal.
Our tori pesin for Kano tok say some district heads wey come out of di palace afta di royal sitting no dey look happy at all.
Afta sitting, one of di Emir sons try to go out for di main gate wit im convoy, but di police no gree open di gate for am.
Dis almost cause quarrel between am and di police.
But befor im reach di police im guards calm am down, and carry am back to im car.
Later, im guards open small gate for am to comot, and di police lock di small gate immediately.
Dis na di first time in months wey heavy security dey for di palace since di emirate wahala wey make dem remove Aminu Ado Bayero and put Muhammadu Sanusi II as Emir of Kano.
Who be Emir Muhammadu Sanusi II?
Muhammad Sanusi II become di 14th Fulani Emir of Kano on 8 June, 2014, wen Rabiu Kwankwaso be govnor of Kano State.
E dey appointed as emir less dan four months afta Goodluck Jonathan, wey be president at di time, remove am as di govnor of Central Bank of Nigeria on top say e accuse Jonathan-led administration of corruption five years into im tenure as di CBN govnor.
Similar scenario go play out during im reign as emir for Kano under di administration of Ganduje.
For 2017, govnor Ganduje and Sanusi II bin disagree sake of wetin e tok about how di state government take dey handle di state finances according to reports.
Sanusi bin accuse di government of mismanagement and corruption, particularly on top di state debts.
Di disagreement between di two of dem escalate for 2019, wey make di Kano State government create four additional emirates, thereby reducing di powers of di emir.
Sanusi challenge di creation of di emirates for court, as e argue say e dey politically motivated and di govnor design am to weaken im position as emir.
However, for March 2020, one Kano State High Court rule say di emirate councils di goment create dey legal.
For March of di same year, di Kano state government remove Sanusi from im position as Emir of Kano, on top accuse of insubordination and disrespect to di governor plus oda officials.
E also dey accused of corruption and dem carry out investigation. Sanusi deny di allegations and challenge im removal for court, but im efforts bin dey unsuccessful.
Dem replace am wit Aminu Ado Bayero, di son of im predecessor, Emir Ado Bayero, wey erign as Emir of Kano from 1963 to 2014.
Dem born Muhammadu Sanusi II for July 31, 1961 to Muhammad Aminu Sanusi and Saudatu Anduwa Hussain.
E be di grandson of King Sanusi wey dem remove from di throne.
E get degree for di field of design and economy and for di field of Islamic religion.
Dem appoint am CBN govnor for June 2009.









