World Cup qualifiers, Lenten, Chimamanda book, UCL and oda tins wey dey happun inside March

Chimamanda Adichie, Ahmed Musa and one india girl for Holi

Wia dis foto come from, BBC/ Getty Images

Read am in 5 mins

Omo!!! Di world of today don turn upside down but e be like pipo look di month of March she say e get 31 days and tok say make we add as many tins as possible say time dey.

As di month just dey start na im di movie awards wey di world like dey torchlight bin happun wey dem call Oscars say make e torchlight.

So we go try to torchlight some major activities for Nigeria and di rest of di world wey go happun for di month of March.

March 1 - Ramadan start

Ramadan, wey be di month wen muslim faithfuls dey go on dia month long fast from all ova di world start for di faithfuls for March 1 dis year.

Inside dis month, Muslims all over di world dey expected to fast from sunrise to sunset, for 29 to 30 days depending on wen dem see di moon.

March 2 - Academy Awards

Winners of di Oscars 2025

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Oscars break records for black pipo on Sunday as di first edition wey black man go win di award for best costume design.

Paul Tazewell wey do di costume to di popular musical feem wey dem dey call Wicked gbab dat award.

Zoe Saldana also break records dat night as di first pesin of Dominican heritage wey go win Best Supporting Actress for her role for id controversial feem Emilia Perez.

Di Academy Awards wey happun for Los Angeles, see Anora pack di most awards, while Conclave, The Brutalist, Wicked and Emilia Pérez also take oda prizes.

March 4 - Chimamanda new book, 'Dream Count'

Popular Nigerian author, Chimamanda Ngozi Adichie release her first novel in 12 years wey she call Dream Count.

In di meantime, she drop di feminist manifesto, The Thing Around Your Neck and even pikin story book wey dem call Mama's Sleeping Scarf.

She bin start to dey write dis book, afta her mama die for 2021. She say she bin no tink say she dey write about her mama until she don almost finish writing di book and find say, plenti tins about mama and daughters dey inside.

For interview wey di 47 year old author do wit di BBC, she tok say, "I bin feel strongly say, in many ways, my mama open door for me to enta dis magical place wey mean say I fit write fiction. I bin reason say she dey comfort me and e bin actually dey deeply emotional for me wen e click for me."

March 4 - Champions League

Di round of 16 for di Uefa Champions League dey start on Tuesday, March 4.

Di last sixteen wey dey di competition till now na Club Brugge, Aston Villa, Borussia Dortmund, Lille, PSV, Arsenal, Real Madrid, Atleti, Feyenoord, Inter, Bayern München, Leverkusen, Benfica, Barcelona, Paris and Liverpool.

March 5 - Lent

Cathloc church

Lent wey dey observed by millions of Christians all ova di world go start on 5th March 205 wit Ash Wednesday.

On Ash Wednesday, churches go hold special services and worshippers go dey marked wit ash.

Ash Wednesday na holy day for some Christians all over di world as e dey mark di beginning of di 40-day period for fasting, prayer and repentance.

On dat day, Catholic and some oda orthodox church members go waka go dia church to collect ash in form of cross sign for dia forehead to remind dem say dem be dust and dem go still return to dust wen dem die.

March 9 - Canada new Prime Minister go emerge

Canadian Prime Minister Justin Trudeau resign im position on Monday 6 January for one press conference.

Card holding members of di Liberal Party for Canada go vote for 9th of March to vote for who go replace oga Trudeau as Prime Minister and di leader of di party.

Di new leader go also be di party candidate go into di kontri general elections wey go hold on or bifor di 20 October, 2025.

Di choices for Prime Minister now na former govnor of di banks of Canada and England Mark Carney, former finance minister Chrystia Freeland, House goment leader Karina Gould and businessman and former MP Frank Baylis.

March 14 - Holi

Holi celebration from 2022

Wia dis foto come from, Getty Images

Holi na im dey mark di last full moon day of di lunar month.

Di festival of Holi na to mark di start of spring for di kontri.

Before di festival proper-proper, pipo go light big fire to show say good don win over evil.

March 17 - African World Cup Qualifiers

African qualifiers for di World Cup wey go dey hosted by United States, Mexico and Canada dey expected to resume for March 2025.

E dey expected to start from March 17- 25, 2025.

Di qualifiers dey picked na from di nine groups wey don dey already arranged wit six teams for each group.

Di nine group winners at di end of 10-match campaign go qualify for di 2026 World Cup, while a 10th African team go qualify through di intercontinental play-off.

March 20 - Anambra Govnorship Primaries

Calendar for Anambra election

Wia dis foto come from, INEC Nigeria

Nigeria electoral commission Inec don announce how di election season for Southeastern state, Anambra state go run dia election dis year.

Anambra na one of di states for Nigeria wey dey get dia election in di off-season of di election cycle.

Inec don announce say di election go hold on di 8th of November but as for di start of dis election period, na inside di month of March e go happun.

Dem say di primaries dey start for di 20th of March.