Nigeria goment don bring Benjamin Best Nnayereugo alias 'killaboi' back to face murder charges

Wia dis foto come from, @AUSTA_XXO @KILLABOIGRAM/INSTAGRAM
Di Nigeria Police Force don successfully complete di deportation of Benjamin Best Nnayereugo wey allegedly kill im girlfriend run, from Doha, Qatar, come back Nigeria.
Benjamin alias "Killaboi," wey police return to di kontri on Saturday morning, bin run comot from di kontri afta im allegedly kill im girlfriend Augusta Oseodion Onuwabhagbe.
Inside one statement wey di Police Force Public Relations Officer, ACP Olumuyiwa Adejobi bin sign, im say di extradition successful sake of di collabo wit di Nigeria Ministry of Justice, International Police (INTERPOL) National Central Bureau (NCB), di Force Headquarters Abuja and di Qatari Judicial Authorities.
Oga Adejobi say, dem do di extradition afta Augusta family do one petition wey dem submit on 29 September 2024.
Benjamin Best Nnayereugo, allegedly kill 21-year-old Onuwabhagbe, wey be first-class student for Lead City University, Ibadan, for im house for Ajah, Lagos, on 13 July 2023 as di two bin dey argue.
Di accused run leave Nigeria bifor im come release videos for online wia im do confession say im commit di murder.
For videos wey im post for im Instagram account, Benjamin say: "I deeply regret di series of events wey lead to dis tragedy, born from a place of pain, betrayal, and toxic arguments.
"I wish say e no ever happun. I no plan for any of dis. Afta di incident, fear take over, and I run away."
For di Video, di suspect bin claim say im dey "prepared to face di consequences, even if e mean death… I dey ready make dem hold me accountable for my actions."
But since afta di confession, Benjamin don run from justice, hide for kontris for Middle East, West Africa and East Asia.
Di statement say Lagos State Police Command bin declare Benjamin wanted on 13 October 2023, and INTERPOL issue for im arrest for any part of di world.
Police claim say dem first arrest am for Freetown, capital of Sierra Leone, on 20 October 2023 under im fake identity "KANU PRINCETON SAMUEL," but im later escape custody during di prison break wey bin happun for di Freetown for November 2023.
Authorities bin track di suspect to different parts of di world, wit orishirishi fake passports, but dem eventually gbabe am for Doha, Qatar for January, 2025, wit fake Guinea passport under di name "Toure Abdoulaye."
"Through robust international cooperation and use of advanced biometrics, INTERPOL NCB Abuja, collabo wit INTERPOL NCB Doha, to confam im identity.
"Qatari authorities arrest am for February 2025. Official extradition request, wey we process through Federal Ministry of Justice, Abuja, bin get approval from Qatari judicial authorities, resulting to im repatriation to Nigeria.," Adejobi tok.










