Influencer mama narrate for video how Sierra Leonean police gbab her daughter alleged killer

Augusta and Benjamin

Wia dis foto come from, @AUSTA_XXO/INSTAGRAM, @CORDELIAOKONYE/FACEBOOK

Cordelia Okonye, di mama of Lead City University student Augusta Osedion wey her boyfriend chop accusation of her murder don narrate how dem arrest di suspect for Sierra Leone.

Sierra Leonean police bin Benjamin Best Nnanyereugo aka Killaboi for di alleged murder.

Di tok-tok for di Lagos State Police Command Benjamin Hundeyin tell BBC News Pidgin say di Sierra Leonan police na dem gbab di suspect and di next tin na to extradite am come Nigeria.

"We fit confirm say police for Sierra Leone don arrest di suspect and we dey work wit dem to extradite am come Nigeria," SP Hundeyin tell BBC News Pidgin.

Di state police command on 10 October bin declare 26-year-old Killaboi wanted afta accuse say im allegedly kill im 21-year-old girlfriend and student of Lead City University.

For July, Killaboi bin confess on im Instagram story say im and im girlfriend bin get argument and im mistakenly stab am to death.

Killaboi say im go surrender to di police and face di consequence of im action.

For series of updates for im Instagram story, e also share screenshots of di message im send to di girl mama where e tok say im no intend to kill im girlfriend.

'E change im name to Kanu Princeton Samuel'

For one video for her Facebook page on Saturday, Augusta mama tok say she bin send Killaboi passport photograph to all her relatives and friends across di world.

She tok say she tell pipo about Killaboi tattoo wey dem fit take identify am.

Cordelia say her cousin for Sierra Leone tell am say dem see pesin wey look like Killaboi. She say her son and anoda cousin travel to Sierra Leone.

She say her cousin bin meet wit di commissioner of police for Sierra Leone and also go to di hotel wey Killaboi bin dey lodge.

Cordelia say dem tell dem say e don comot for di hotel but dem print im Sierra Leonean passport for dem.

She say di suspect get Sierra Leonean passport on 28 July and change im name to Kanu Princeton Samuel.

"Wit dat passport and local number, di police bin dey work for us for di past two weeks," Cordelia tok.

“One per cent of di pain don comot now wey Benjamin don dey caught," she tok.

Tori for social media be say Killaboi allegedly spend over $25,000 to change im identity for Sierra Leone wey include buying di kontri passport and oda tins.

Social media pipo wey also share di tori tok say na night club dem gbab Killaboi.

Benjamin Best Nnanyereugo aka Killaboi

Wia dis foto come from, Lagos State Police Command

Wetin we call dis foto, Police bin declare Killaboi wanted for 10 October

Who be Killaboi?

Benjamin Best Nnanyereugo aka Killaboi

Wia dis foto come from, @KILLABOIGRAM/INSTAGRAM

Killaboi for im Instagram profile say im be Blockchain Developer and Crypto Purveyor. Di young man no get too many posts for im Instagram but di few posts wey im get show say im be big boy wey dey chop life.

One of im post wey im pin for im Instagram page show am dey pose behind one private jet. For di caption of di pictures, im say di way im dey live fit make pipo dey tink say im dey use cheat codes.

For di series of posts for im Instagram story, Killaboi claim say im make ova 300 million naira on betting between 2022 and 2023, wey mean say na punter.

For im Instagram story, di Nigerian man say im ruin im life at 26 years wit di alleged killing of im girlfriend and say im no fit face im family and im only brother wit wetin im don do.

Who be Augusta

Augusta Osedion

Wia dis foto come from, @AUSTA_XXO/INSTAGRAM

Onuwabuagbe Augusta Osedion aka Austa na 21-year-old student of Lead City University, Ibadan, di Oyo State capital.

For her Instagram bio, Austa describe herself as public figure.

Her Instagram account of 109k followers get plenty pictures of her wey show say she be fashionista.