'I feel like say I be angel of death'

Rafael speaks into a microphone

Wia dis foto come from, Handout

Wetin we call dis foto, Rafael don live for Israel for 20 years and im don dey serve for army since 2009
    • Author, Julia Braun
    • Role, BBC World Service
    • Reporting from, São Paulo

Di family members of all Israel pipo wey die for military operations or attacks wey dem classify as terrorists by dia goment don recieve special support, wey include visit from one army officer wey go give di official notice of di death.

But since Hamas invasion don kill 1,400 pipo for di kontri, dem don overstretch dis service like dem no ever do am before.

As a result, officers from di Israel Defence Forces (IDF) wey no dey normally work wit families of victims follow do di work dis time.

Rafael, wey bin originally come from Brazil, na army major and one of di pipo wey dem call up.

Since last Friday (13 October), im bin dey visit like at least three families a day to give dem news about dia family member wey don die.

"Wen I knock on dis families doors, I feel like angel of death," im tell BBC.

"But I know say dis work dey very important, as e dey give di family di opportunity to dey sure about wetin happun to dia loved one and so dem go fit bury dem."

Dis na di first time wey Rafael don do dis kain work.

As pesin wey don dey work for army for 14 years, di Brazilian wey from Rio de Janeiro dey normally work on di legal affairs for di IDF.

"E get pipo for army wey dia regular work na dis, but as di number of pipo wey die reach plenty like giant, di number of officers wey dem train for dis kain mission no dey enough," im tok.

Di officer say im do four hours training before im start di work.

"For our preparation dem say, especially for di first few days, e fit shake us very much, witout appetite or sleep," im tok. "And e dey really happun - e hard to sleep and eat."

"But of course I dey kontinu to eat food and try to sleep, becos I know say if I no do am, e get one, two, three, four, five more families wey no go receive information about dia relatives."

Burned out cars line the road at a music festival which was attacked by Hamas

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Burned and destroyed cars near the electronic music festival attacked by Hamas

Rafael say some of di visits wey touch am di most na homes of families wit children and teenagers.

For one of dem, im break di news of di death of one 17-year-old girl to her papa.

She bin dey spend di night wit her boyfriend for one beach near di Gaza Strip wen Hamas attack di couple.

"Wen we give her papa di news, im say na di day before im see di foto of im pikin for television, among pipo wey wey dem fit don kidnap," Rafael remember.

"Im say im bin ge some kain hope - say she bin still dey alive."

On anoda trip, im visit di parents of one 30-year-old woman wey dem kill for her house. Her husband dey miss.

"Dem live behind behind two 10-month-old twins wey only survive becos dia parents manage put dem inside bunker and lock di room before di terrorists come," im tok.

"E dey very difficult; I no fit stop to tink about di families. E get parents wey no go ever see dia pikin again, e get children wey go grow up witout dia parents."

Major Rafael in uniform

Wia dis foto come from, Handout

Wetin we call dis foto, "It's difficult to sleep," Rafael says

According to Rafael, many of families of di victims of di 7 October attack go gatz wait many more days before dem recieve news about dia loved ones.

"Recognising di bodies difficult, as of dem you no fit identify dem at all. As a result, confirmation of deaths dey take time to come," e tok.

"E get more 600 pipo wey dey miss and mos t of dem, unfortunately don die, but e neva possible to identify dia body."

Di invasion wey happun on 7 Octber fit dey considered as di most serious attack wey don ever occur across di border, wey Israel don face for more dan one generation.

Members of Hamas cross di fence wey separate Gaza from Israel from many different places.

Dem raid villages, kill at least 1,400 pipo. Di estimate be say dem kidnap nearly 200 pipo.

Fighters bin also fire thousands of rockets from Gaza Srip, some of dem hit cities as far as Tel Aviv and Jerusalem.

A burned-out house

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, A burned-out house in kibbutz Be'eri, near the Gaza Strip, after the Hamas attack

In response, Israel launch several bombs against di Gaza Strip di following days afta. Pipo wey die for Gaza Strip don reach 2,700 as of Monday (16 October).

Also, according to Palestine authorities, around one thousand pipo still dey miss, dem dey buried iside di building wey collapse sake of bombing.

Last weekend, di kontri armed forces also announce say dem dey prepare for new attacks against Gaza by land, sea and air.

Israel tell 1.1m Palestine pipo wey dey live for north of Gaza to move go south to escape di assault.

Di humanitarian crises for Palestine territory dey become more and more dangerous and di fear be say di war fit spread to involve oda kontris for di region like Lebanon and Iran.

*BBC hide di officer surname sake of security reasons.