Residents flee, narrate experience afta Israel order pipo to evacuate northern Gaza

Man dey waka wit im pikin

Wia dis foto come from, EPA

    • Author, Ethar Shalaby
    • Role, BBC Arabic

At least 12 pipo, including young children, don die after one convoy of vehicles wey dey head toward southern Gaza dey hit. Palestinian Health Ministry don blame Israel for di attack. Israel Defense Force (IDF) say dem dey investigate.

E come as deadline for Palestinians to evacuate northern Gaza don pass.

Israeli authorities revise di deadline, wey give pipo until 13:00 GMT (16:00 local time) to run.

Dem don tell more dan one million pipo to leave through two safe corridors ahead of one expected Israeli ground assault against Hamas, di Palestinian militant group.

Some of di pipo for northern Gaza share dia experience with BBC afta dem bin get di notice to run.

Awn Abu Sharar wife, Haneen, dey heavily pregnant. "She fit born in five days," di 29-year-old lawyer tell BBC over di phone. "I need to find her hospital for safe place to give birth."

Di husband and wife hear about Israel order to move comot from northern Gaza on Thursday night and dem bin no wan leave dia house for Gaza City wen dem first hear am, but las las relatives convince dem to go.

Dem join many oda civilians wey don dey run leave north of Gaza inside car, truck, some sef dey trek.

E take dem less dan one hour to pack one small bag wit di necessary tins wey pikin go need.

"We leave our house sharp sharp and we bin no know wia we dey go, no arrangement. Nowhere safe," im tok as im voice dey shake.

Now dem don travel go Rafah town for south of Gaza to stay wit one family wey allow displaced Palestinians stay wit dem.

Dem choose Rafah becos dem tell dem say good maternity hospital dey dia.

Di area wia Israel give order make pipo pack comot na di most populated part of di Gaza Strip.

E cover one third of di territory and e dey for di north of one watercourse wey dem dey call Wadi Gaza, wey cut through one narrow band of mainly agricultural land.

Map show density of population in Gaza

Di order to evacuate come afta more dan 1,400 pipo die for Israel for Hamas attacks.

Most pipo wey run from dia house dey rely on friends, relatives and strangers wey dey live for south for wia dem go stay.

Woroud al-Dahdouh, na 24-year-old student, she leave Gaza City wit seven members of her family and now dem dey anoda town for south, al-Balah.

Dem dey stay for one house wey more dan 20 oda pipo dey live. "No single empty chair wey pesin fit sidon," she tok.

Woroud describe how she cry through out di whole journey, she no even notice di heavy traffic for roads. "I no fit describe di feeling of leaving my home," she add.

Dem leave house too quick, time no dey for dem to take anytin except dia passport and one oda item of memory "I take one lovely family picture of all of us wey bin dey hang for my room," she tok as she dey cry.

"Wetin I go tok? Dem ask us to leave and we no get any oda option," Woroud mama, Nagah tok. "We no even know di pipo wey we dey stay wit but bless dem for opening dia home to us."

Boy siddon for open window of heavily packed car

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Some pipo load as many of dia belonging wey dem go fit car inside dia car before dem run

Earlier for morning, Hamas tell pipo make dem no move and some still dey for northern Gaza.

Maysoon al-Batsh, wey dey live for one of Gaza City main roads, decide to stay for im house even though most of her neighbours don run. "E no get any place wia we go fit go for south. Nowhere safe," she say. "Dis na our land. We no go leave our lands. We go die for our houses."

Youssef Haddad, wey dey travel go south to Khan Younis wit im elderly parents and three siblings, tell us: "We lucky say we get close friends to stay wit, but we see hundreds of displaced pipo for street dem no get where to go."

Im say di only tin wey dem bin take na dia phone chargers and underwear.

Tractor carry Palestinians wey dey comot Gaza City

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Pipo dey use any motor wey dem see to transport dem sef go south

Earlier, di United Nations warn say di order to move more dan one million pipo inside 24 hours space go get "devastating humanitarian consequences" and say e dey "impossible" to make am happun.

E get just one main road wey connect north and south, fuel dey scarce, water don almost finish and some areas already dey full of remains of destruction.

Di UN agency for Palestine refugees UNRWA say im shelters, including schools, don pack full.

World Health Organization also criticise di move. "E get many pipo wey dia injuries mean say dia only chances of survival na to dey on life support, like mechanical ventilators," WHO tok tok pesin Tarik Jasarevic say. "So moving dis pipo na death sentence. Asking health workers to do so dey beyond cruel."

Leaflet wey order pipo to evacuate northern Gaza and not return until Israeli forces tok so

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Israel drop leaflets wey order pipo for northern Gaza to leave go south immediately

Many Palestine pipo don dey struggle to find transport, including one group of more dan 500 pipo wey dey take refugee for Gaza only Catholic church.

Father Gabriel Romanelli, na di fada for dia, im tell BBC say arranging for evacuation na logistical wahala.

"We get hundreds and hundreds of refugees for di church, including children and elderly pipo, as well as disabled and sick ones," im explain. "How we go move dem? And den, wetin we go do wen we get dia?"

Meanwhile, US Secretary of State Anthony Blinken say im don ask Israel to take "every possible precaution" to avoid civilian deaths, and recognise say many families for Gaza dey suffer and "no be dia fault".

Im confam say US dey discuss wit Israel and e dey also "lead international organisations" to establish "safe areas" for Gaza and more details go come up soon.

Additional reporting by Ricardo Senra (BBC News Brasil)