Meet former Attorney-General wey Tinubu appoint as ICPC chairman

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria president Bola Ahmed Tinubu don appoint Musa Aliyu as di new chairman of di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC).
Di announcement of Dr Aliyu dey inside statement wey Ajuri Ngelale, tok-tok pesin to president Tinubu release on Tuesday.
Na oga Clifford Oparaodu go be di secretary to di commission according to di statement.
“In exercise of powers conferred on di President as established in Section 3(6) of di Corrupt Practices and Other Related Offences Act, 2000, President Bola Tinubu don approve di appointment of a new management team for di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC), pending Senate confirmation.
Di pipo na Dr Musa Adamu Aliyu — Chairman/Chief Executive Officer, ICPC and oga Clifford Okwudiri Oparaodu — Secretary to di Commission, ICPC,” di statement tok.
Di presidency say di nomination of di new Chairman of ICPC come afta di president approval of di outgoing Chairman request to go on pre-end of tenure leave wey go start on 4 November ahead of di expiration of im tenure on 3 February, 2024.
Ajuri add say “Di position of secretary to di commission no require Senate confirmation and, therefore, by di directive of di president, di appointment of oga Clifford Okwudiri Oparaodu as Secretary of di Commission take immediate effect."
Oga Clifford Okwudiri Oparaodu na lawyer wit over 30 years of experience.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im don serve well-well for public service as a member of di Rivers State Judicial Service Commission.
Im bin don also serve as chairman of the caretaker committee of Port Harcourt city local goment council.
Di appointment of Dr Musa Aliyu come days afta di president appoint Ola Olukoyede as di new executive chairman wey go head di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Wit dis appointment di current administration don kick-off im own anti-corruption fight.
Presidency say di war against corruption na part of di Renewed Hope Agenda of oga Tinubu
Who be di new chairman of ICPC
Dr Musa Adamu Aliyu na di former Attorney General of Jigawa State.
Tori be say e make some reforms as Commissioner for Justice for di North western state.
Oga Aliyu na Lawyer of many years and a legal professional.
Recently, dem name am as a Senior Advocate of Nigeria-designate.
di former Attorney General of Jigawa State hold Bachelors, Masters and Doctorate degrees in Law.














