Senate confam Ola Olukoyede as chairman of EFCC

Wia dis foto come from, Presidency
Senate on Wednesday confam di appointment of Ola Olukoyede as chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Di red chamber also confam Muhammad Hammajoda as di Secretary of commission.
Di confamation na afta di new chairmo and secretary of EFCC ansa kwesion from di lawmakers for di floor of di senate on Wednesday 18 October 2023.
President Bola Tinubu bin appoint Ola Olukoyede as di new executive chairman wey go head di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) alongside oda secretary for di commission.
According to statement wey di Special Adviser to di President on Media and Publicity Ajuri Ngelale release, Olukayode go replace di former EFCC boss Abdulrasheed Bawa wey don resign.
For di statement, Ajuri quote section 2 (3) of di EFCC (Establishment) Act, 2004 give President Tinubu di power to appoint “di Chairman and members of di Commission, oda dan ex-officio members."
Di new EFCC chair go serve for a period of four years wey dey reneweable, pending wen di Senate go confam am.
For June president Bola Tinubu sack 40 years old AbdulRasheed Bawa as EFCC oga.
End of Di one wey oda users dey read well well
E den appoint Abdulkarim Chukkol to step in as Acting Chairman of di ani-corruption agency.
Profile of Ola Olukoyede
Oga Olukoyede na lawyer “wit over twenty-two (22) years of experience as a regulatory compliance consultant and specialist in fraud management and corporate intelligence.”
Im don serve as di Chief of Staff Chief of Staff to the Executive Chairman (2016-2018) and Secretary to di Commission (2018-2023) wey make am qualify to be appointed as chairman of di commission.
For November 28, 2018, di senate bin confam Olanipekun Olukoyede as di Secretary to EFCC wey dey in accordance wit section 2(3) of di 2004 act wey establish di commission.
Olukoyede serve as di Chief of Staff to di former EFCC Chair, Ibrahim Magu, wey dem appoint on September 10, 2018 by former President Muhammadu Buhari.

Wia dis foto come from, Facebook/PastorOlaOlukoyede
E get im university education for Lagos State University; University of Lagos; Institute of Arbitration ICC – Paris, France and University of Harvard (Kennedy School of Executive Education).
Born in Ikere-Ekiti, Ekiti State, on October 14, 1969, Olukoyede dey among di member of di Fraud Advisory Panel (UK) and also a member of Federal Government Technical Committee on the Repositioning of the Nigerian Financial Intelligence Unit.
Olukoyede na pastor for di Redeemed Christian Church of God (RCCG).
As ogbonge lawyer wey im be wit several years of experience at the Bar, Olukoyede na regulatory compliance consultant, wey specialises for compliance management, corporate intelligence and fraud management.
Olukoyede na certified fraud examiner wey EFCC reveal say im don lead and manage investigation wey include civil litigation of fraud and financial crimes for International development project.













