Abdulkarim Chukkol: Meet Acting EFCC Chairman wey Tinubu appoint to take over from Abdulrasheed Bawa

Wia dis foto come from, EFCC
Abdulkarim Chukkol don step in as Acting Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC.
Dis na afta di suspension of Abdulrasheed Bawa, as Executive Chairman of di commission.
Until dis new role, Chukkol na di Director of Operations of di Commission, EFCC tok.
Nigeria President Bola Ahmed Tinubu suspend di oga of di kontri corruption police Economic and Finacial Crimes Commission, on Wednesday.
Di suspension of di 43-year-old na indefinitely and na wit immediate effect.
President Tinubu approve di indefinite suspension of di EFCC Chairman, Abdulrasheed Bawa to allow for proper investigate into im office.
Bawa don receive order to immediately hand over di affairs of im office to di Director Operations of di Commission.
Di director operations go run tins for di Office of di Chairman pending wen dem conclude di investigate, na so di statement from di president office tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
DSS invite Bawa

Wia dis foto come from, EFCC
E no tey wen di president suspend am before tori come out say Bawa dey wit di Department of State Services (DSS).
Tok-tok pesin for di DSS Peter Afunaya for statement say dem invite am to ansa kwesions based on di investigation wey dem dey do.
"Di Department of State Services (DSS) don invite oga Abdulrasheed Bawa, di suspended Chairman of Economic and Financial Crimes Commission (EFCC). Bawa arrive a few hours ago.
"Di invitation relate to some investigative activities wey concern am," Afunaya tok.
Immediate past Nigeria president Muhammadu Buhari na im appoint Bawa as head of di kontri corruption police Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
For 2012 Oga Buhari forward di name of Abdulrasheed Bawa to di Nigeria Senate to confam am as di permanent chairman of di commission.
At 40 years old oga Bawa become di youngest EFCC chairman since dem create di commission for 2003 wen Buhari appoint am.
Abdulkarim Chukkol profile
Chukkol na pioneer staff of di agency and one ogbonge member of di EFCC Cadet Course One.
EFCC add say Abdulkarim Chukkol na skillful investigator wey get better experience wit specialty for cybercrime and money laundering.
Oga Chukkol don head different command within di EFCC.
Dis appointments include spells as Head of di Advance Fee Fraud and Cybercrime Sections of di Lagos and Abuja Zonal Commands between 2011 -2016.
E be pioneer Commander of di Uyo Zonal Command for 2017 and Commander of Port Harcourt Zonal Command for 2020.
Chukkol don participate for some special operations wit international law enforcement organizations.
E get close relationship wit Law enforcement agencies like FBI, UK National Crime Agency, United States Postal Inspection Service (USPIS), United States Secret Service, Australian Federal Police, Dutch Police, German Police, South African Police and odas.
Di acting EFCC Boss don work closely wit oda goments to develop law and infrastructure to carry out law enforcement actions.
Chukkol na di Nigeria Contact person for di International Mass Marketing Fraud Working Group wey dey represent key goment regulatory, law enforcement, prosecution, immigration and customs.
Also financial intelligence, consumer protection agencies and trade and competition bureaus wey dey deal wit mass marketing-related issues from Spain, Nigeria, Belgium, Europol, Canada, United Kingdom and di United States.












