AbdulRasheed Bawa be "new EFCC chairman"

AbdulRasheed Bawa: AbdulRasheed Bawa be "new EFCC chairman" President Buhari nominate

Wia dis foto come from, EFCC

Wetin we call dis foto, Di 40 years old AbdulRasheed Bawa fit become di youngest EFCC oga since dem create di commission for 2003.

Nigeria president Muhammadu don nominate di new head of di kontri corruption police Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

Oga Buhari forward di name of Abdulrasheed Bawa to di Nigeria Senate to confirm am as di permanent chairman of di commission.

Inside statement wey presidential aide, femi Adesina, release, im say Oga Bawa na trained EFCC investigator wey get orishirishi experience for di investigation of advance free fraud mata, official corruption, bank fraud, money laundering, plus oda kains of economic crimes.

If dem confam am, di 40 years old oga Bawa go become di youngest EFCC oga since dem create di commission for 2003.

Presido Buhari bin remove di form EFCC oga Ibrahim Magu for July 2020 on top accuse of corruption wey connect wit how im agency bin take make moni plus property dem wey dem bin recover from corrupt individuals and organisation.

Afta Magu comot, anoda officer Mohammed Umar bin dey work as acting chairmo.

Fight against corruption na one of di main di main priority of di Buhari goment since im enta office for 2015, but some pipo believe say, so far im neva to make progress.

[Abdulrasheed Bawa biography] - See who be dis new EFCC Chairman nominee

40 year old Bawa na one of di first cadet officers EFCC bin get for 2005. He be di current head of di commission zonal office for Lagos state, South West Nigeria.

He go take over from Mohammed Umar, wey don dey work as di acting chairman since July afta presido suspend di former acting Chairman Ibrahim Magu, on top accuse of corruption.

Bawa get Bachelor of Arts degree for Economics, and a Master’s degree for International Affairs and Diplomacy.

He be di chief investigator for di alleged multi-billion naira fraud case against former Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke.

Oga Abdulrasheed Bawa na from Kebbi state and dem born am for 1980. He like to dey watch football, tennis, reading, current affairs and international politics.

He say im be “trained Economic and Financial Crimes investigator and e get plenty experience for inside investigation and to dey prosecute cases like Advance Fee Fraud, Official Corruption, Bank Fraud, Money Laundering and other Economic and Financial Crimes related offences.

According to am, “He be Certified Fraud Examiner (CFE), Certified Anti-Money Laundering Specialist (CAMS) wey don collect training for United States Federal Bureau of Investigation (FBI), United States Financial Crime Enforcement Network (FINCEN), The World Bank, The United Nations Office of Drug and Crimes, The Nigeria Police Force, the Nigeria State Security Services. The EFCC Academy and United Kingdom’s Global Training Consulting”.

Di new EFCC Chairmo say im don successfully investigate and testify for prosecution of several cases wey don lead to imprisonment and recovery of billions of naira and millions of US dollars in cash and properties across di world.

Before im nomination, he be di Deputy Chief Detective Superindent-DCDS since 2016.

Dis na some of di ogbonge cases wey Bawa don handle as e dey im CV:

(A) Supervising di biggest operations zonal office of di EFCC for Lagos. E get 604 officers and men and e don secure 227 convictions despite di Covid-19 pandemic.

B) Supervising di investigation of all di cases for Port Harcourt Zonal office and 215 sentences dey secured in eleven months and securing Final Forfeiture of hundreds of properties to di Federal Government.

C) Supervising di investigation of all cases for di Ibadan Zonal office in which 113 were concluded and 54 dey charged to court within 6 Month.

D) Diezani Alison-Madueke-2015-Date: Recovered Millions of Dollars worth of properties in Nigeria, UK., USA, and UAE including 92 properties in Nigeria.

E) Atlantic Energy Group-2014-2015: Recovered Millions of Dollars worth of properties in Nigeria, UK, USA, Switzerland, UAE and Canada.

F) Crude Oil Swaps and OPA-2014-2015: Recovered Billions of Naira.

G) Petroluem Subsidy Fraud-2012-2015: Idenfied Fraud of about N70Billion, Recovered Billions of Naira and Prosecuted several companies.

H) Former Governor of Niger State, Dr. Muazu Babangida Aliyu I) “Operation Cyber Storm One”, across Nigeria in which over 60 Suspected Advance Fee Fraudsters and Cyber Crime Perpetrators dey on prosecution- 2008

J) He participate for several other Periodic Raid on Notorious (419) Cyber-cafés.