South Africa Julius Malema push for single African presidency and currency

Wia dis foto come from, Leon Sadiki/Bloomberg via Getty Images
Di president of di Economic Freedom Fighters (EFF), Julius Malema, don call for united Africa under one president, one currency, one parliament, and one military command.
E tok dis one during di Nigeria Bar Association (NBA) Annual General Conference wia e tok on di problems wey Africa dey face.
Dem invite am as keynote speaker to di conference wey hold for Enugu State, southeast Nigeria for presence of thousands of lawyers.
Malema bin don enta different kwanta wit world leaders including US President Donald Trump and South African President Cyril Ramaphosa.
Di South African opposition leader tok during di NBA conference say time don reach make African kontris wake up and make dem no dey depend on foreign organisations for help.
Malema describe loans wey Africans dey take as 'debt trap' wey fit put di future of di continent into wahala.
Five points wey Malema make
'Loan na debt trap'
Malema say African kontris no suppose dey get loans from wetin e call 'foreign colonisers'.
"Di debt trap of Africa to our foreign colonisers gatz stop, and dat go start by regulating dis loans wey our leaders commit future generations to, becos dem no go sabi wen di colonisers go come to collect."
Di South African politicians tok say im kontri parliament dey take some moves to chook eyes into how dem dey collect loans from foreign institutions.
E say e don tell South Africa parliament say di Treasury Department gatz seek approval bifor dem source foreign loans.
"Di Public Finance Management Amendment Bill go deal wit problem wey dey face di whole continent, and dat na di unregulated borrowing of money by our govments from di World Bank and di International Monetary Fund (IMF).
Malema say dis bill go allow transparency for any loan wey dem wan borrow and oda conditions wey dey behind am.
"One presidency, one currency"
Di 44-year-old Malema na politician wey believe say Africa fit get one president to make di continent dey strong.
E bin call say make Africa get one president and one currency including combined military command to add to di strength of di continent.
Malema say make Nigeria and South Africa begin dey lead di tok about di African Continental Free Trade Area so e go fit get benefits for ordinary pipo.
"Togeda, wit di minerals wey dey power modern technology, di energy resources wey dey fuel global industry, and di human capital to build a self-sufficient continent.
"Nigeria and South Africa gatz industrialise togeda, build factories togeda, and process our resources for African soil," e tok.
"We gatz harmonise trade policies, align visa regimes, and build continental infrastructure wey go connect our pipo."
Malema say visa no dey needed between South Africa and Nigeria and same for oda kontris within di continent.
'Xenophobia na betrayal of African unity'
Xenophobia na anoda mata wey Malema address during di NBA conference wia e say di problem dey betray African kontris.
E say Africans suppose love demsefs and make dem no dey kill demsefs.
"Africans gatz love demsef, not to kill one anoda. Black pipo no dey loved for Africa, and no dey loved abroad too, but we gatz learn to treat oursefs beta."
Malema say make Africa reject bad name wey oda continent dey call am, becos plenti mineral resources dey to prosper.
"Xenophobia na betrayal of African unity. Na sickness borne of poverty, inequality, and govment failure. Di victims na African brothers and sisters. Nigerians, Zimbabweans, Congolese, and Somalis no be di cause of South Africa unemployment crisis."
E say Africa gatz embrace unity and not division.
'Africa get raw materials'
According to Malema, Nigeria get enough mineral resources while South Africa also get some mineral deposits.
"Nigeria dey blessed wit oil, natural gas, and growing agricultural sector. South Africa get some of di richest deposits of platinum, magnesium, and coal for di world. However, Malema say despite di mineral resources for Africa, di continent still dey depend on oda continents wey go come extract di resources for dia use.
"Yet both our nations remain for neo-colonial arrangements, wia raw materials dey extracted cheaply and exported to Europe, America, and Asia, only for dem to sell am back to us for crazy prices as finished goods."
Malema say Africa gatz break dis dependency so dem go fit build dia own factories wey go help process di mineral resources.
'Africa na dia own saviour'
Malema say Africa na dia own saviour and nobodi go come save dem from anoda continent.
Di South African politician believe say na Africans go fit save di continent and not any foreigner.
"We gatz reject di illusion say our salvation go come from Washington, London, or Beijing. Our salvation lie here for Lagos and Johannesburg, for Abuja and Pretoria, and di hands of Africans wey refuse to dey divided.
Meanwhile, for June 2025, dem permanently deny Malema entry into di United Kingdom.
UK Home Office tok say dem deem di controversial politician 'non-conducive to di public good', as dem cite both im character and association concerns.
Also, di EFF leader bin react to di meeting between US President Trump and South African President Ramaphosa wey happun for US on Wednesday 21 May, wia e tok say di outcome no good.
While Malema dey Nigeria, e also visit di govnor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu, for im office.










