Who be di most prominent leaders of Hamas?

Abdullahi Barghouti, Mohamed Al-Deify, Yahaya Ibrahim Al-Sinwar
    • Author, By
    • Role, BBC News Mundo

Since Operation "Storm al Aqsa" start on Saturday, October 7, questions don rise about Hamas' military capabilities.

Although e no reach dat of Israeli Army, but di truth na say dem manage to surprise Israel wit dia attack.

Dis na di most popular Hamas political and military leaders as at today.

Mohamed Al-Deif

Al-Deif dey known by di nickname "the guest."
Wetin we call dis foto, Al-Deif dey known by di nickname "the guest."

Wen dem announce di establishment of Hamas, e join di rank without delay.

Israeli authorities bin arrest am for 1989 and e spend 16 months for detention.

During im time for prison, Al-Deif bin agree wit Zakaria Al-Shorbagy and Salah Shehadeh to create one movement wey different from Hamas to capture Israeli sojas. Dis na di Izz al-Din Al-Qassam Brigades.

Afta dia release from prison, di al-Qassam Brigades start as military formation. Al-Deif na one of im founders.

Al-Deif na also di engineer wey build di tunnels through which Hamas fighters take enta Israel from Gaza, and na im promote di strategy of firing more rockets into Israeli territory.

Di most serious charges against am, if anything, na im supervision and planning of plenty revenge operations for di murder of engineer Yahya Ayyash, wey lead to di death of about 50 Israelis for early 1996, plus im plan to capture and kill three Israeli sojas for di mid-1990s.

Israel arrest and put am for prison for 2000, but e manage to escape from im captors for di start of wetin dey known as di "Second Intifada." E don dey missing since den.

Na three fotos of am dey: one dey very old, di second one show im masked face and di third one na image of im shadow.

For one attempt to assassinate am for 2002, Al-Deif miraculously survive but lose one eye. Israel claim say e lose one leg and one hand join, and e no fit tok well-well sake of di attacks e suffer.

For 2014, during di war wey Tel Aviv launch for di Gaza Strip wey last more dan 50 days, di Israeli army bin also fail to assassinate am but dem kill im wife and two of im children.

Im ability to survive earn am di nickname "di fighter wit 9 lives".

But above all, e dey known as "di guest", because e no dey stay for di same place for more dan one night and every day e dey spend di night for new house to escape Israeli persecution.

E also dey popular wit di nickname "Abu Khaled" for im acting role for one play dem call "The Clown". For di play, e act di role of dis historical figure wey bin live during di period between di Umayyad and Abbasid dynasties.

Marwan Issa

Foto show Issa in circle also survive Israel attacks
Wetin we call dis foto, Issa also survive Israel attacks

Marwan Issa, alias "the shadow man" na Mohamed Al-Deif right-hand man, e also be di deputy commander-in-chief of di al-Qassam Brigades and member of Hamas political and military bureau.

Israeli forces bin keep am under arrest for five years during di so-called "First Intifada" sake of im activity for di ranks of Hamas, one group e join wen e dey small.

Israel describe am as man of "action, not words" and claim say e smart so tey e fit "turn plastic into metal". Dem believe say as long as e dey alive, di "brain war" wit Hamas go continue.

Issa na better basketball player and dem nickname am "di Palestinian commando". However, e no progress for im sports career as Israel arrest am for 1987 afta dem accuse am say e dey wit Hamas.

Di Palestinian Authority later arrest am for 1997 and did not release am until after the outbreak of what became known as the "Al-Aqsa Intifada" in 2000.

Afta im release, Issa play ogbonge role for di development of di Al-Qassam Brigades military systems.

Sake of im prominent role for Hamas, Israel begin pursue am and dem put im name on di list of most wanted pesin. Dem bin try to assassinate am during one 2006 General Staff meeting wit Al-Deif and senior leaders of di Al-Qassam Brigades, but e only injure.

Israeli fighter jets bin also destroy im house for Gaza two times for 2014 and for 2021, dem kill im brother.

Nobody sabi im face until 2011, wen e show for one group foto dem take during one reception for prisoners wey dem release under di exchange agreement for di release of Israeli soldier Gilad Shalit.

Yahya Sinwar

Sinwar found di Hamas security service

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sinwar found di Hamas security service

Dem born Yahya Ibrahim Al-Sinwar, leader of di Hamas movement and head of dia political bureau for di Gaza Strip for 1962.

E found di Hamas security service wey dey known as "Majd". E dey deal wit internal security, wey include interrogations of suspected collaborators wit Israel. Dis body dey also track Israeli intelligence and security services.

Dem arrest Sinwar three times, di first time na for 1982, wen Israeli forces hold am for administrative detention for four months.

On im third arrest for 1988, dem sentence Sinwar to four life sentences. As e dey serve im prison sentence, Israeli soja Gilad Shalit tank bin come under Hamas missile attack, wey make am hostage of di Islamist fighters.

Shalit in many ways, bin be just normal pesin - wey many sabi as "everybody man". Di public see say e fit be their son, or brother and pressur di Israeli govment to do everitin necessary to release am. Dis happen through prisoner exchange deal wey some Palestinians refer to as “Loyalty of the Free”, wey include many prisoners from di Fatah and Hamas movements, and among dem na Yahya Sinwar, wey dem release for 2011.

Sinwar later return to im position as prominent leader of di Hamas movement and member of dia political bureau afta im release.

For September 2015, di United States put im name on dia blacklist of "international terrorists."

On February 13, 2017 Yahya Sinwar dey elected head of di political bureau.

Abdullah Barghouti

Abdullah Barghouti
Wetin we call dis foto, Barghouti, na explosives expert, e still dey for Israel prison

Dem born Abdullah Ghaleb Al-Barghouti for Kuwait for 1972. E move go Jordan afta di 1990 Gulf War.

E obtain Jordanian citizenship and study electronic engineering for one university for South Korea for three years, wia e learn how to manufacture explosives.

E no complete im studies becos e get entry permit to enter Palestine territories.

Im cousin Bilal Al-Barghouti na im ask Abdullah to join di ranks of di Qassam Brigades on di commander orders.

Barghouti bin work for di production of explosive devices, detonators and toxic substances. E establish one special factory for military manufacturing for one warehouse for im town. Di total number of pipo wey die for di operations Abdullah Barghouti coordinate reach 66 Israelis, plus 500 pipo wey injure.

Israeli special forces arrest Barghouti by chance for 2003 by and dem interrogate am for three consecutive months.

Plenty families of di dead Israelis bin attend im trial and e receive di longest sentence for di kontri history. Dem give am 67 life sentences and a total of 5,200 years.

E stage one hunger strike wey end im solitary confinement.

Dem nickname Barghouti, wey still dey for Israel prison, "The Shadow Prince" afta e write one book from inside di prison wey di title na "The Shadow Prince." For di book, e tok about im life and details of im dealings wey e carry out wit oda prisoners.

For di book, e describe how e take smuggle explosives through Israeli military checkpoints and how e carry out remote bombing operations, in precise detail.

Ismail Haniyeh

Ismail Haniyeh

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Haniyeh na di head of di political bureau of di Hamas movement and di prime minister of di tenth Palestinian Authority government

Dem born Ismail Abdel Salam Haniyeh, wey also dey known as "Abu Al-Abd", for one of di Palestinian refugee camps.

Im be di head of di political bureau of di Hamas movement and bin be di prime minister of di tenth Palestinian Authority govment.

Israel imprison am for 1989 for three years and dem send am go exile alongside several Hamas leaders to Marj al-Zuhur, wey dey di Lebanese-Palestinian border, wia e spend one full year for 1992.

Afta dat year for exile, e go back Gaza and for 1997 dem appoint am head of di office of Sheikh Ahmed Yassin of di Hamas movement, wey strengthen im position for di Islamist movement.

For February 2006, Hamas nominate am as Palestinian Authority prime minister and na on di 20th of dat month dem appoint am.

One year later, Palestinian National Authority Chairman Mahmoud Abbas remove Haniyeh from im post afta di Al-Qassam Brigades bin take control of security apparatus headquarters for di Gaza Strip.

Haniyeh bin reject di decision as "unconstitutional" and declare say im goment "go continue to fulfill dia national responsibilities to di Palestinian pipo."

Haniyeh bin advocate for Palestinian reconciliation wit di Fatah movement on several occasions and e bin don announce im readiness to step down as head of di goment for di framework of a comprehensive reconciliation agreement. E leave office on June 2, 2014 and Rami Hamdallah replace am.

On 6 May 2017, dem elect am as head of di Political Bureau of Hamas.

For 2018, di US Department of State designate Haniyeh as a terrorist.

Khaled Meshaal

Jaled Mishal

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mishal na one of di founders of Hamas

Dem born Khaled Mishal or "Abu Al-Walid" for di village of Silwad for 1956. E receive im primary education there before im family emigrate go Kuwait, wia e complete im primary and secondary education.

Mishal dey considered as one of di founders of di Hamas movement and don be member of dia political bureau since e start.

E take ova di chairmanship of Hamas political bureau between 1996 and 2017 and dem appoint am leader afta di death of Sheikh Ahmed Yassin for 2004.

For 1997, di Israeli Mossad bin try to assassinate am under direct instructions from Prime Minister Benjamin Netanyahu, wey ask di head of di intelligence agency to prepare plan to carry out di operation.

Ten Mossad agents bin enta Jordan on forged Canadian passports and dem inject Khaled Mishal wit one toxic substance as e dey waka down one street for di capital, Amman.

Jordanian authorities bin discover di assassination attempt and dem arrest di two Mossad members wey dey involved.

Di late Jordanian King Hussein bin Talal bin ask di Israeli Prime Minister for the antidote to di toxic substance dem inject into Khaled Mishal.

Netanyahu bin initially refuse di request, but the assassination attempt bin take anoda political dimension and U.S. President Bill Clinton bin convince di prime minister to finally send di antidote.

Khaled Mishal bin visit di Gaza Strip for di first time on December 7, 2012. Na im first visit to di Palestinian territories since e comot at di age of 11. Palestinian leaders bin receive am inside one mass bath on im way to Gaza City.

On May 6, 2017, di Hamas Shura Council elect Ismail Haniyeh to take ova from am as head of dia political bureau and for 2021, Mishal bin head di movement office for di diaspora.

Mahmoud Al-Zahar

Mahmoud Al-Zahar

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Al-Zahar na one of Hamas most prominent leaders

Dem born Mahmoud Al-Zahar for 1945 to Palestinian father and Egyptian mother for Gaza City. E spend im early childhood years for Ismailia, Egypt.

E receive im primary, middle and high school education for Gaza. E get bachelor’s degree in general medicine from Ain Shams University for Cairo for 1971 and master’s degree for general surgery for 1976.

Afta graduation, e bin work as doctor for hospitals for Gaza and Khan Younis until di Israeli authorities sack am sake of im political positions.

Al-Zahar dey considered as one of Hamas most prominent leaders and member of di movement political leadership.

E dey for prison for Israel for six months for 1988, half a year afta dem establish Hamas, e dey among those wey Israel deport for 1992 go Marj Al-Zuhur, wia e spend one full year.

After Hamas win di 2005 legislative elections, Al-Zahar bin serve as foreign minister for Prime Minister Ismail Haniyeh goment until di den-President Mahmoud Abbas announce di dissolution of di goment afta events wey lead to di Palestinian division.

Israel bin attempt to assassinate Al-Zahar for 2003 wit one half-ton bomb dem drop from one F-16 aircraft on im house for di Al-Rimal neighborhood of Gaza City, for one attack wey cause minor injuries and kill im eldest son, Khaled.

On January 15, 2008, dem kill im second son, Hossam, wey be member of di Al-Qassam Brigades, wit 18 odas for one Israeli air strike for eastern Gaza.

Al-Zahar bin write intellectual, political and literary works, including "The Problem of Our Contemporary Society.... A Quranic Study" or "No Place Under the Sun" in response to Benjamin Netanyahu book "The Islamic Political Discourse".