Hamas hostages: Tori of di pipo wey dem take from Israel

One year on from di Hamas-led attacks on Israel, total of 97 hostages remain unaccounted for.
According to Israel, 251 Israelis and foreigners dey taken on 7 October 2023.
Israel official figure for those wey dem hold for Gaza na 101 - dis include four pipo dem take hostage for 2014 and 2015. Two of dis dey believed to don die.
Dis na di stories of those hostages wey still dey captivity, wey don either dey confamed by di BBC or dey credibly reported.
Dis list dey updated and names fit change, as some pipo dem kidnap dey confamed dead or released.
Dis update na on 7 October 2024
Emily Damari, (28), wey hold dual British-Israeli nationality, dem take am hostage from Kibbutz Kfar Aza. For one memorial event for London on 6 October 2024, her mama Mandy tok say hostages dem release last November don tell her say dem get contact wit Emily for captivity.
Alexander (Sasha) Troufanov, 28, dey taken hostage wit im mama Lena, im partner Sapir Cohen, and im grand mama, Irina Tati. All wey dem abduct from Kibbutz Nir Oz as dem dey spend di Sabbath togeda. Irina, Sapir and Lena dey released for November 2023.
Ariel Cunio, 27, and im partner Arbel Yahud, 29, dey abducted for di same attack on Nir Oz. Eitan Cunio, Ariel broda wey escape Hamas, tell di Jewish Chronicle say im last message from Ariel tok say: "We dey for horror movie."
David Cunio, 34, anoda of Ariel brodas, wey also dey kidnapped from Nir Oz. David wife Sharon Aloni Cunio and dia three-year-old twin daughters Ema and Yuly dey released for November 2023. Sharon sister Daniele Aloni, and her six-year-old daughter Emilia both dey released same month.

Wia dis foto come from, Family handout
Doron Steinbrecher, 31, one veterinary nurse, dey her apartment for Kibbutz Kfar Aza wen Hamas bin attack. For 10:30 on 7 October, she bin send voice message to friends: "Dey don arrive, dey get me."
Naama Levy, 20, video dem film show as dem dey bundle am into one jeep, her hands dey tied behind her back. Di footage dey released by Hamas and circulated widely on social media. According to her mama, di teenager bin just begin her military service.
Yousef Zyadna, one 53-year-old Bedouin dairy farmer, e dey abducted from Kibbutz Holit and taken to Gaza along wit im sons Hamza, 23, Bilal, 19, and im daughter, Aisha, 17. Aisha and Bilal dey released for November 2023.
Ohad Ben Ami, 55, dey kidnapped from Be'eri wit im wife, Raz. She later dey released by Hamas.
Twin brodas Gali and Ziv Berman, 27, dey taken from Kfar Aza. Ziv bin dey message one friend as di attack bin happun. Dia family say di IDF tell di brodas say dem dey held for Gaza.
Iraq-born Shlomo Mansour, 86, dey taken captive from Kibbutz Kissufim, wia e bin dey live and work as chicken coop manager. Im wife, Mazal, bin manage to escape.
Daniela Gilboa, 20, na soldier wey base for Kibbutz Nahal Oz. For July 2024, one Hamas hostage video bin dey published, wia she bin appeal to di Israeli govment to bring her and di oda hostages home.
IDF soldier Matan Angrest, 21, bin dey on duty on 7 October and dem dey reason say e dey Gaza.
Eli Sharabi, 52, dey taken from Be'eri wit im broda, Yossi, wey don since dey confamed say don die. Eli wife and two daughters dey murdered for di attack. Ofir Engel, di boyfriend of Yossi daughter, Yuval, also dey taken, but released on 29 November.
Agam Berger, 20, bin dey kidnapped from Nahal Oz. She dey seen as dem take her away for videos wey Hamas release.
Edan Alexander, 20, na Israeli-US citizen wey bin volunteer to join di Israeli army. E bin dey serve near di Gaza border dat time of Hamas attack. Edan family tok say Israeli officials don tell dem say dem don take am to Gaza as hostage.
Matan Zanguaker, 24, dey taken wit im partner Ilana Gritzewsky, 31, from Nir Oz. Ilana, Mexican national, dey released on 30 November 2023.
Eitan Horn, 38, and im broda Yair, 46, both Argentinian citizens, also bin dey Nir Oz dat time of di attack. Yair na construction worker while Eitan dey work for education.

Wia dis foto come from, Family handout
Keith Siegel, 65, and im wife Adrienne - often known as Aviva - Siegel, dey taken from dia home for Kfar Aza. Adrienne dey released for November 2023.
Bipin Joshi, 23, one Nepalese agriculture student, dey believed to don dey taken from Kibbutz Alumim. Di Joshi family say dey bin receive confirmation from Israeli intelligence say im phone dey located for Gaza.

Wia dis foto come from, Family handout
Oded Lifshitz, 84, one retired journalist, dey taken hostage from Nir Oz. Im wife Yocheved also dey kidnapped but she dey freed for October 2023.
Omer Neutra, one 22-year-old Israeli-American and grandson of Holocaust survivors, dey serve as tank commander near Gaza wen Hamas bin attack. Omer parents say na Israeli embassy bin tell dem say e don dey kidnapped.
Itzik Elgarat, 69, dey kidnapped from Nir Oz, and reportedly shot for di hand during di attack. Im phone dey traced to Gaza afta di attack.
Gadi Moses, 80, also dey abducted from Nir Oz, wia e bin dey work as agricultural expert. Im partner, Efrat Katz, dey killed for di attack. For September, im family bin tell Times of Israel say dem never hear any informate about am since December 2023, wen e bin appear for one Hamas propaganda video.
Nimrod Cohen, 20, dey taken from Nahal Oz. Afta e dey kidnapped, im father dey invited to meet Pope Francis for Rome along wit oda hostages families.

Wia dis foto come from, Family handout
Yarden Bibas, 34, dey abducted from Nir Oz along wit im wife, Shiri, and dia two young children, Ariel and Kfir. For one TV interview for June, Israeli minister Benny Gantz bin say di govment sabi wetin bin happun to di Bibas family, but say dem no fit provide details yet.

Wia dis foto come from, FAMILY HANDOUT
Karina Ariev, one 20-year-old soldier, dey serve for di Nahal Oz army base wen she dey kidnapped. Her sister Alexandra bin tell di BBC say she hear shooting as Karina bin call her during di attack, and later she see one video wey show Karina as dem take am away for vehicle.
Ofer Kalderon, 53, dey taken by Hamas from Nir Oz, along wit im two children, Erez and Sahar. Two oda family members - 80-year-old Carmela Dan and her granddaughter, Noya, 12 - dey killed for di attack. For November 2023, Erez and Sahar dey released.
Omri Miran, 47, dey abducted from Nahal Oz. Im wife, Lishay, tok say she bin last see am dey drive am away in im own car. She and dia two small daughters no dey taken wit am.
Liri Albag, 19, bin just start military training as one Army lookout for di Nahal Oz base wen Hamas bin attack. Her family say she don manage to pass messages back to dem through released hostages.
Ohad Yahalomi, 50, dey abducted from Nir Oz, along wit im 12-year-old son, Eitan, wey dey released during di November ceasefire.
Tal Shoham, 39, dey taken from Kibbutz Be'eri. Im wife, Adi, dia two young children, and im mother-in-law, Dr Shosham Haran, also dey captured but released for November 2023. Dr Haran husband, Avshalom dey killed during di attack.

Wia dis foto come from, Jonathan Dekel-Chen
Sagui Dekel-Chen, 36, one American-Israeli citizen, don dey missing since Hamas attack on Nir Oz. Since im abduction, im wife Avital don give birth to dia third child, one girl, her name na Shahar.
A number of pipo dey abducted from di Supernova music festival for southern Israel. Among dem:
Omer Shem Tov, 21, initially bin escape for im car but dem capture am wen e bin try to rescue im friends, Maya and Itai Regev. All three dey taken captive - di Regev siblings dey released in November 2023, but dey say dey bin dey wit Omer for captivity.
Yosef Ohana, 24, bin dey di festival wit one friend, wey e bin tell im mama say im and Yosef remain to help pipo escape di gunfire bifor dem run demselves. Several weeks afta di attack, Yosef mama hear news from Israeli army say e bin dey captive for Gaza.
Avinatan Or, 31, dey kidnapped along wit im girlfriend, Noa Argamani. She dey rescued from central Gaza for June, and say dem dey separated during di abduction.

Wia dis foto come from, Family handout
Guy Gilboa-Dalal, 23, bin attend di festival wit im broda for June, one unnamed released hostage dey reported say e say dem dey one room wit Guy afta dia capture.
Eitan Mor, 24, dey work as security guard for di festival. For June, im papa bin tell Israeli radio say "di last sign of life" im family see of Eitan na four months previously, but e no give any details.
Alon Ohel, 23, na Serbian citizen wey bin dey attend di festival. Hamas footage bin show am as dem take am away as hostage, but im mama tok for August say she neva see or hear of am since den.
Maxim Kharkin, 36, dey invited to di festival for di last moment. E bin text im mother twice afta di attack, but e neva dey seen or heard of since.
Segev Kalfon, 26, bin dey run away from di festival, across di highway, wen e dey captured by Hamas.
Romi Gonen, 24, dey ambushed as she try to escape from di Supernova festival. Her mama, Merav Leshem Gonan, bin address di UN Human Rights Council for June, wen she appeal for international help to release di hostages.
Bar Kuperstein, 23, dey work for di festival wen di attack take place. Im family say dey bin identify am for one video of Israeli prisoners, posted by Hamas. Since den, dey say dey never get further informate.
Eliya Cohen, 27, and im girlfriend initially hide from di attackers for one shelter, but e dey discovered, and driven away. For June, Hamas footage dem release show di moment Cohen and odas dey taken as prisoners.
Elkana Bohbot, 35, bin go to di party wit friends and, bifor e lose contact, e bin tok to e wife and mama tell dem say e dey help evacuate di wounded, di Times of Israel bin report. Hours later, im family find one video of am posted online by Hamas, wey don dey seen by BBC Verify.
Rom Braslavski, 20, bin dey work on security for di festival. According to one account published by Hostages and Missing Families Forum, e bin dey try to rescue one injured pesin for di attack wen e dey caught for di volley of fire. E never dey heard from since.
Omer Wenkert, 23, na restaurant manager, e send message to im family to say e dey go to one safe shelter but dem lost contact. Im family say dey bin see Hamas video footage of Omer, including foto of am handcuffed and e wear only underwear.

Wia dis foto come from, Family handout
Evyatar David, 23, bin dey di festival and di morning of di attacks, e bin text di family to say "dem dey bombard di party". Im family say dem later receive text from one unknown number, wey contain video footage of Evyatar handcuffed on di floor of one dark room. According to Israel foreign ministry, e dey held captive by Hamas for Gaza.
Or Levy, 34, run from di festival wit im wife Eynav, and phone im mama to say dem dey hide for one bomb shelter. Israeli forces later tell di family say Eynav bodi dey found for di shelter and dat Or don dey kidnapped.
Thailand govment say six of im citizens still dey hostage for Gaza.
Dia names na Watchara Sriuan, Bannawat Seatho, Sathian Suwannakham, Nattapong Pinta, Pongsak Tanna and Surasak Lamnau.
Hostages wey don die
Some number of hostages now dey known to don die while dem dey captivity. Among dem na di following:
On 1 September, di IDF announce say im forces don recover bodies of six hostages - Carmel Gat, Eden Yerushalmi, Hersh Goldberg-Polin, Alexander Lobanov, Almog Sarusi and Master Sgt Ori Danino. Di IDF tok say dem dey murdered by Hamas shortly bifor Israeli forces fit reach dem.
On 8 August, e dey announced say di bodies of Abraham Munder, Alex Dancyg, Yagev Buchshtab, Chaim Peri, Yoram Metzger and Nadav Popplewell - all of wey don die for Hamas captivity – don dey extracted from Gaza by di IDF and return to Israel.
For November 2023, di bodies of 19-year-old soldier Noa Marciano and 65-year-old Yehudit Weiss dey found by Israeli troops for buildings close to Al-Shifa Hospital for Gaza City.
For December 2023, di Israeli military bin express "deep remorse" afta soldiers mistakenly kill three hostages for northern Gaza wey bin escape from dia captors. Dem dey named as Yotam Haim, 28, Samer Talalka, 22, and Alon Shamriz, 26.
Hostages wey dia deaths don dey reported, but not confamed, include Shiri Bibas and her two young children, Ariel and Kfir.











