Iron Dome of Israel: Aerial defense weapon wey dey stop air-strikes for di Israel Palestine conflict - See wetin you need to know

See rockets for night sky wey dem fire towards Israel from Beit Lahiya for di northern Gaza Strip (14 May 2021)

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, See streak of light as Israel Iron Dome system intercept rockets wey dem launch from Gaza

Di Palestinian militant group Hamas don launch attack on Israel, wit dia fighters wey dey enter communities near di Gaza Strip, e kill residents and take hostages.

More dan 1,200 don die for both sides afta Hamas launch ogbonge attack by Hamas early mor-mor on Saturday.

Rockets still dey fly from Gaza enta southern Israel even afta 36 hours of di first attack.

Israel ansa to air strikes don make 123,000 Palestinians for Gaza to run comot dia house. About 74,000 of those carry demselves go school to find wia to keep head according to di UN.

Hospitals for Gaza don full taya even as dem just dey take light anyhow.

Di UN say fuel fit finish for Gaza last power supply source wey be dia power plant in few days.

Israel don deploy many tins including di Iron Dome to resist Hamas attacks from Gaza.

What is Iron Dome?

Iron Dome na air defense system wey Rafael Advanced Defense Systems and Israel Aerospace Industries develop.

Dem design di defence system to intercept and destroy short-range rockets and artillery shells.

Iron Dome don dey operational since 2011 and dem consider am among di most advanced defence systems for di world.

Di Iron Dome dey use radar to identify and destroy incoming threats before dem fit cause damage.

Dem design di all-weather system specially to help combat shorter-range rudimentary weapons like di kain rockets wey dem dey fire from Gaza.

Di Iron Dome bin dey expensive to develop, but manufacturers say e dey cheap now, sake of di technology wey im dey use to differentiate between missile wey dey likely to hit areas wey don develop and di one wey go land for empty locations.

Graphic showing how Israel's Iron Dome missile defence system works

Static and mobile units dey only launch interceptor missiles to shoot-down anytin wey e feel say dey dangerous.

Ten years since di Iron Dome become operational, Israel now get 10 batteries wey dem deploy across di country, each wit three to four launchers wey fit fire 20 interceptor missiles.

"Di number of Israelis wey don die and injure go dey far higher if to say di Iron Dome system no dey, wey don become a life saver as e dey always be," tok-tok person for Israeli military Lt Col Jonathan Conricus tok.

But some analyst say, di intensity of recent pressure from Gaza suggest say militant groups dey attempt to overwhelm di Iron Dome - wey dey raise concern about di possible limitation of di defense system.

Wetin we call dis Video, (November 2012) The BBC's Ben Brown describes how Israel's Iron Dome works

Some of di worst violence wey don happun for many years for Israel and Gaza don lead to dramatic image of confrontation across di sky for di regions.

Hamas don fire more dan 4,500 rockets from Gaza into Israel since di surprise attack start, according to figures from di Israeli military.