Israel-Palestine crisis updates: World leaders react to Jerusalem crisis for Gaza, Tel Aviv

"What is happening in Palestine 2021": [Jerusalem crisis pictures]

Wia dis foto come from, Reuters

Di Israeli military don intensify attack for Gaza as Palestinian militants kontinu to fire rockets into Israel on di fifth day of fight-fight.

Israeli army say dem don mobilise air and ground forces for dia attack on Friday but dem neva enta Gaza.

Meanwhile video from Gaza City show di level of explosion from Israel.

More than 100 people don die for Gaza while seven for Israel since di fight start since Monday.

Also, Jewish and Israeli-Arab mobs dey do dia own fighting inside Israel.

And di presido for di kontri dey fear say dat one fit lead to civil war.

Dis latest gbege between Israel and Palestine na di worst since 2014.

And na di tension between di two for East Jerusalem na im cause am leading to destruction of lives and property.

How world Leaders don react to di crisis

"What is happening in Palestine 2021": [Jerusalem crisis pictures]

Wia dis foto come from, Getty Images

Di daily report of attacks, death and destruction of pipo houses dem don make world leaders to begin chook mouth on top di recent gbege.

UN Secretary-General Antonio Guterres:

UN Secretary General, Antonio Guterres say im no happy at all sake of di large number of deaths.

Di casualties include pikin dem from Israeli air strike for Gaza and rockets launched by di Palestinian militants.

E further yarn give say Israeli security forces must drop dia use of force.

Di UN chief also tok say di launch of rockets on Israeli pipo also no dey acceptable.

Di United States:

Di White House say Israel get legitimate right to defend imself itself from Hamas rocket attacks.

But US say Jerusalem "must be a place of co-existence".

White House tok-tok pesin, Jen Psaki say President Joe Biden's support for "Israel's security."

"And im legitimate right to defend itself and im pipo, no get shaking."

Nigerian President, Muhammadu Buhari:

Di Nigerian goment through di Foreign Ministry also chook mouth on top di kasala wey di happun between Israel and Palestine.

President Buhari goment ask both parties to stop di figh-fight.

Aso Rock also ask di two kontris to embrace di two-state solution.

And also make sure say dem ensure all citizens live in peace and dignity, Di Nigerian foreign affairs ministry tok.

Turkey:

Di Turkish foreign ministry say Israeli goment must finally understand say e no fit suppress di Palestinian pipo.

Turkey add say Israel no fit stop Palestine "legitimate rights and demands by using indiscriminate and disproportionate power."

British Prime Minister Boris Johnson:

UK Prime Minister Boris Johnson say di UK dey deeply concern sake of di growing violence and civilian casualties.

Oga Johnson call for urgent de-escalation of tensions between di two kontris dem.

European Union:

Di European Union say Palestinian rocket attacks into Israel dey "totally unacceptable."

European Union call on all sides to aim for reduction and to prevent more civilian deaths.

EU foreign policy chief Josep Borrell also condemn evictions of Palestinian families in East Jerusalem.

Borrell call am illegal and saying dem only dey try to fuel tensions.

Arab League:

Di Arab League chief, Ahmed Aboul Gheit say di Israeli air strikes dey "indiscriminate and irresponsible".

Families dey ontop vehicle

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Families wey dey live near di border don begin run comot

E yarn give say Israel dey responsible for wetin dem call dis "dangerous escalation" in Jerusalem.

Di Arab league call on di international community to act immediately to stop di violence.

Russian President Vladimir Putin:

Di Russian president, Vladmir Putin don ask both Israel and di Palestinians to stop di fight-fight.

Putin call dem to de-escalate tensions and peacefully resolve di cause of di problem.

German Foreign Minister Heiko Maas:

Di German Foreign Minister, Heiko Mass say di rocket attack on Israel dey unacceptable and must end sharp sharp.

E further yarn say Israel for dis situation get right to defend demselves and dat di way di violence di grow, dem no fit tolerate am.

Iranian Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei:

Di Iranian Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei say di language Israel understand na force.

Ayatollah say sake of dis, di Palestinians must increase dia power and resistance to force dem to surrender.

Dis go make dem stop wetin di Iranian Supreme Leader call dia brutal attacks.

"What is happening in Palestine 2021": [Jerusalem crisis pictures]

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Rockets from Israel Iron Dome missile defence system rise to block rockets from Gaza

Organisation of Islamic Co-operation [OIC]:

Di Organisation of Islamic Co-operation don praise di steadfastness of di Palestinian pipo wey station for di occupied city of Jerusalem.

OIC also hail dia response to di Israeli attacks on di holy site

International committee of the Red Cross:

Middle East director Fabrizio Carboni say international humanitarian law no allow anyhow attacks against civilians.

Any attack must be equal and dem must take all necessary precautions to avoid civilian deaths. Carboni add.

International Criminal Court [ICC]:

Di ICC Prosecutor, Fatou Bensouda say di International Criminal Court dey very worried about di possibility of war crimes.

Di chief prosecutor point West Bank, East Jerusalem, in and around Gaza as places wia war crimes fit happun.

She add say dem dey monitor developments.