Verified video and social media show how di supernova festival massacre happun

Pipo dey take cover for di festival

Wia dis foto come from, Telegram

    • Author, By Sean Seddon, Joshua Cheetham & Benedict Garman
    • Role, BBC Verify

Warning: Dis article get details wey fit dey uncomfortable for some pipo

Di last videos dem take before kasala burst, e be like any oda festival - young pipo dey dance for early mor-mor.

According to some accounts, up to 4,000 pipo attend di party. From di footage, e appear say dem go mostly dey under 30.

Dem bin gada for one remote area for southern Israel for di Supernova festival – one event wey promise dance, music, art and drinks for one secret location.

Na wen di time of di party dey almost reach, organisers tell di pipo wey hold ticket say make dem go one site, wey dey north of di Re'im kibbutz, about 6km (3.7 miles) east of Gaza.

Di party organisers promise dem a "journey of unity and love".

Wetin we call dis Video, Watch: A look inside the Supernova festival site

And true-true, plenty happy faces show for one video dem post for 07:22 local time, e show as pipo wey go di party dey laugh and dance for di weak morning light.

But above dia heads, small black clouds of smoke don dey signal di beginning of di terror wey dey come.

Dem be like plumes - feather- wey Israeli military leave behind to target di rocket wey dey enta from Gaza.

For di hours wey follow, Hamas go don fire thousands of rockets enta Israel.

Map wey show location of music festival in relation to Gaza barrier

BBC Verify don put togeda di events of di weekend festival bloodbath. Dem use video and social media posts wey dem don verify plus, facial recognition technology.

Di footage show as some of di festival-goers bin dey look di dark wisps above dia heads. Odas no even know wetin dey happun, dem just dey dance go.

For anoda video dem post shortly afterward, di music don stop.

Pipo don begin comot di festival site - some dey fear, odas dey find wia to hide, and some odas just dey go wia di exit dey.

One small drive away for di Gaza barrier, di next phase of di assault go soon start.

'Dem bin dey everywhere'

Screengrabs taken from one video of one festival for Israel

Wia dis foto come from, Social media

Wetin we call dis foto, One video from di site show as festival-goers dey dance as some begin to notice signs of wetin appear to be rocket fire overhead

E no clear how many minutes bin pass between wen di rockets begin dey blast and wen di gunmen begin dey fire, but eyewitness accounts suggest say everytin happun very fast.

"Rockets dey ground, den dey begin fire. E dey come from different directions, and e dey become louder and louder," 31-year-old Gilad Karplus, wey dey work as massage therapist for di festival, tell di BBC.

"I see pipo dey go down. As we see wetin dey happun, we just rush enta jeep and begin drive inside di fields."

One Instagram story wey one woman post bin show di rockets for sky and pipo wey dey comot di site.

"We bin go through one main road but afta a minute, one pesin begin shout say terrorists dey shoot," she write give her followers.

Wetin we call dis Video, Watch: Panic and fear as Israeli festival-goers run from gunmen

"But afta two minutes, for di oda direction [we] realise say more terrorists dey dia too."

E dey impossible to know if di militants know say di festival dey happun for dat location - but surely dem go don hear as music dey blast across di quiet countryside.

We also know say, weda dem see di site by accident or not, dem bin come prepared to kill.

Gili Yoskovich tell BBC News for di weekend, how di militants "bin dey everywhere wit automatic weapons" and how she hear as dem dey offload more weapons from one van.

All di accounts suggest say di camp bin dey well surrounded and dem block all di roads wey pipo fit enta and comot from di site.

Festival-goers bin dey run from all directions, but some bin still dey within di range of di gunmen.

Map of di festival site
Wetin we call dis foto, Map of di festival site

Slaughter dey captured on camera

While some pipo dey run enta fields and desert, di militants bin dey parade through di festival and dey kill on sight.

Dashcam footage wey dem time-stamp at 09:23, wey dem take from one parked car, show three of di gunmen wey take part of di massacre.

For di opening frame of di footage, e show one lifeless body wey lie and dey curled up next to one car.

Militant dey lead one man away

Wia dis foto come from, Social media

Wetin we call dis foto, Militant dey lead one man away

E show as one man wey dey armed wit automatic weapon dey order one man wey blood full im body to fall to di ground, e later grab am for neck and hold am by im T-shirt and carry am comot di camera eye. E no dey clear weda e survive.

Di body wey dey near di car move. Di man, wey e be like say dey pretend say im don die, raise im head up to see if di coast don clear.

Dat na fatal error.

As seconds later, anoda militant enta di frame and shoot am dead for di head at blank rage and waka comot.

One militant dey point gun to one man for ground

Wia dis foto come from, Social media

Wetin we call dis foto, One militant dey point gun to one man for ground

For anoda part of di footage, a group of men appear. Only one dey armed – e be like say dem dey dia to loot.

E show as dem dey check di pocket of di man dem kill near di car, e also show as dem dey go through one suitcase wey dey inside anoda parked vehicle.

Dem discover two pipo, one man and one woman, wey dey hide near one car and dem carry dem away.

Di woman wey dem take away suddenly reappear two minutes later. She jump and wave her arms for di air. She must think say help dey near - by dis time, di Israeli Defence Forces don begin dia efforts to stop di attack. But seconds later she fall to di floor as bullets bounce around her. We know no if she survive.

BBC don analyse di footage and run still images of di gunmen wey dey visible through one facial recognition tool.

E match one of di faces of di fotos of one man wey wear police uniform, wey dey available on di website of Gaza Nuseirat municipality.

We compare these through Amazon Rekognition software and get a similarity score of between 94-97% (some campaigners, however, don raise concerns say non-white faces fit dey falsely identified on facial recognition tools).

Counting di cost

According to rescue agency Zaka, dem don recover more dan 260 bodies reportedly from di site.

Mobile and drone footage show di scale of di Hamas assault, e show as bullets scata cars wey no fit make am comot for di site.

Di festival don become a warzone - and for some, di nightmare continue.

Hamas bin claim say dem take several hostages from di site, and di Israelis say dem dey hold about 100 pipo from across di kontri captive inside Gaza.

One of di tough videos wey comot from di festival na dat of one woman wey dem name on social media as Noa Argamani.

For one video wey Hamas post on social media, e show as militants bundle her for di back of one motorcycle and she dey cry and scream.

One video wey show say she dey alive don go viral for Gaza but e no clear if e dey genuine.

Her family, and di families of odas dem kidnap from di festival, dey wait for news of dia loved ones - and e neva still clear how di Israeli government dey plan to get dem back.