Five major tins wey don happun since Hamas attack Israel and wetin go happun next

E don pass 24 hours since Palestine militants, Hamas, launch di kain attack wey dem never ever attack before on Israel.

Since den some major tins don occur as di two sides continue to attack demsef. Dis na di five major ones wey don happun.

Wetin we call dis Video, Watch: How Hamas' shock attack on Israel unfolded

More dan 800 pipo don die

At least 500 Israeli pipo don die so far for di fight and almost 2,000 odas dey collect treatment for hospitals – 19 dey for critical condition.

For di Palestine side, authorities say 313 pipo na im don die so far and about 2,000 wunjure for inside Gaza sake of Israel revenge attacks.

Palestine militants also capture some Israel soldiers plus civilians carry dem go Gaza.

“Long and difficult war”

Israel pipo dey in shock for Hamas attack

Wia dis foto come from, Reuters

Israel Prime Minister Benjamine Netanyahu don tell im konti pipo say na “long and difficult war” na im dey dia front so.

Netanyahu, for one overnight message wey im send give im pipo, say dis war, “dem force am on us by di murderous attack by Hamas.”

Di PM add say di first stage go soon end in few hours wen dem wipe out di militants wey dey inside Israel territory.

Di goment also say e go cut off electricity, fuel plus oda supplies make dem no enta Gaza.

Palestine pipo dey check damage wey Israel sir stirkes cause

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Palestine pipo dey check damage wey Israel sir stirkes cause

Eight “points of engagement”

Israel military say dem still get eight “points of engagement” wit Hamas militants wey dey inside dia territory.

Some Hamas militants from Gaza, enta plus kolobi some communities of Israel territory.

Although di military claim say dem don regain control of 22 of dia locations wey Hamas kolobi for south of di kontri, di militants say serious fight still dey happun inside Israel.

Hamas leaders house, banks among 150 targets

Palestine pipo run go UN schools to hide from Israel air strikes

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Palestine pipo run go UN schools to hide from Israel air strikes

Israeli warplanes don hit 150 targets since dem start dia revenge attack, one Palestine security source tell BBC.

Di targets include several compounds wia dem believe say Hamas leaders dey live.

Di Israeli Air Force also say dem target two banks wey dem claim say "belong to Hamas terror organisation for terror funds."

Dem say dem also destroy one "floating weapons production" site wey belong to "Islamic Jihad terrorist organisation" (dis na separate group to Hamas).

Anoda building "including offices and storage units" wia dem dey keep weapons and military equipment.

Lebanon Hezbolla group don join fight

Lebanese militant group Hezbollah don also join di fight. Dem say na dem bomb Mount Dov, one land wey Israel, Lebanon and Syria don dey drag, but Israel occupy.

To revenge dis attack, Israel Defence Force fire drone enta Lebanon go bomb building wey belong to Hezbollah for Jabal Rus area.

Di group wey Iran dey support, say dem bomb Mount Dov to show dia “solidarity wit di Palestine resistance.”

Israel-Lebanon border bin dey calm since Israel and Hezbollah fight war for 2006. But tension between di two bin don dey rise for some months now.

Israel territory wey Palestine near di Gaza Strip
Wetin we call dis foto, Israel territory wey Palestine near di Gaza Strip

Hamas attack shock Israel, but wetin go follow next?

Fifty years don pass since di Yom Kippur War wey bin begin wit surprise attack against Israel from Egypt and Syria.

Now Palestine militants don launch dia own major surprise attack on Israel. Nobody bin expect dis attack on anoda Jewish holiday.

Tension bin don dey rise for di Gaza Strip for some time before dis attack, but di believe bin be say Hamas, di Islamic group wey dey govern Palestine and Israel no go want make tins worse pass as dem bin dey.

But Hamas bin dey plan one complicated and organised attack.

Afta di serious conflict between Hamas and Israel for 2021, Egypt, Qatar and UN bin do indirect peace tok tok to help get permit for pipo from Gaza to work inside Israel plus relax oda restrictions in exchange for at least small quiet.

Wit dis new attack, Israel dey see di possibility for war wey fit open happun from different sides at di same time.

Worst case of wetin fit happun, be say Hamas go drag Hezbollah, di powerful Lebanese militant group.

Meanwhile, Israel military don order heavy reinforcement of dia troop even as dem still dey bomb Gaza. E say e still dey plan to enta Gaza do ground operations.

For now e dey hard to get full view of wetin dey happun, one tin wey dey clear be say Israel intelligence and security leaders go dey ask demsef how dem no see say dis attacks fit happun and how dem no fit prevent di kain damage wey e cause.