Israeli PM declare war afta ova 100 pipo die sake of attacks from Gaza

Emergency personnel dey try quench fire

Wia dis foto come from, Reuters

At least 70 pipo don die for Israel afta Palestinian militant group Hamas launched dia biggest attack inside many years.

Militants bin cross to Israel from Gaza under cover of heavy rocket fire - and since don take dozens of Israelis as captive.

Di attack na major surprise as militants cross enta inside Israel from Gaza during heavy rocket fire.

Tori dey go round say di militants carry some hostages - both soldiers and civilians - back to Gaza.

Israel don launch waves of air strikes on targets for Gaza in response.

Israel say dem dey "at war" afta dozens of gunmen from di Palestinian militant group Hamas penetrate dia kontri from Gaza for one extraordinary attack.

Di militants bin cross one perimeter fence for early mor-mor on Saturday, as dem launch plenty rockets from Gaza.

Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu don vow say Hamas go "pay for wetin e no bargain for".

Di Israeli military tok say dozens of fighter jets dey carry out air strikes for Hamas sites in Gaza in response, plus dem don mobilise tens of thousands of reservists (sojas wey dey on reserve).

At least one Palestinian don die for di strikes, local health officials tok.

Palestinian militant group Hamas don claim responsibility for di attack, and dia armed wing tok say dem launch 5,000 rockets in 20 minutes.

Wetin we call dis Video, Rockets launched from Gaza streak across sky towards Israel

Di rocket blast from Gaza – wey di Hamas dey control – start just afta dawn on Saturday, di day wey di Jew dey observe di Jewish Sabbath and di day dem dey do di festival of Simchat Torah.

As sirens begin sound across Israel, di IDF announce say "terrorists" don enta Israeli territory "for different locations".

Di IDF tell civilians wey dey di southern and central areas say make dem stay next to shelters, and inside shelters for di area surrounding Gaza.

Fotos wey dem post online show how group of heavily armed Palestinian militants wey wear black fatigues dey drive around Sderot for inside one pick-up truck.

For one video, e show like say di same militants dey exchange fire wit Israeli forces on di streets of di town, wey be only 1.6km (1 mile) from Gaza.

Also unconfirmed reports for di Palestinian media tok say militants don take unspecified number of Israelis captive by militants and footage wey dey spread show as Palestinians for Gaza dey drive Israeli military vehicles.

But di Shaar HaNegev Regional Council announced say dia leader, Ofir Liebstein, don die for di exchange of fire wit militants wen e go defend im community.

22 pesin die, more injure

One motor dey burn

Wia dis foto come from, Reuters

At least 22 Israelis don die for di unprecedented attacks according to emergency services.

Israel health ministry tok say at least 545 pipo injure for di Palestinian attacks, according to di Reuters news agency.

Di rocket barrages continue throughout Saturday morning, and Israeli media report say dem don so far launch more dan 2,500 projectiles towards Israel.

One initial report from Israel Magen David Adom ambulance service bin tok say di Palestinian rocket fire don kill one pesin.

Later, one hospital for di southern city of Ashkelon tok say for dia side, dem dey treat 68 casualties alone, while another hospital for Beer Sheva report 80 odas.

Why Hamas launch rocket against Israel

Mohammed Deif, leader of di Islamist militant group, tok say dem fire 5,000 rockets inside Israel early on Saturday to launch wetin dem call “Operation Al-Aqsa Storm”.

“We don decide say enough is enough,” Deif tok.

“We don already warn di enemy before. Di occupation don commit hundreds of massacres against civilians. Hundreds of martyrs and wounded die dis year sake of di crimes of di occupation.

“We announce di start of Operation Al-Aqsa Flood, and we announce say di first strike, wey target enemy positions, airports, and military fortifications, pass 5,000 missiles and shells.”

We dey at war - Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu

"Citizens of Israel we dey at war, dis no be operation, no be escalation, na war," Prime Minister Netanyahu tok for one statement.

"This morning Hamas bin launch one murderous surprise attack against di State of Israel and im citizens."

"I call di heads of di security system, first of all I order dem to clean di settlements of di terrorists wey bin penetrate – dem dey carry out dis operation as we dey tok now."

"At di same time, I order extensive reserve mobilization plus a retaliatory war wit a strength and scope wey di enemy no ever know."

One senior Hamas military commander don announce di start of di operation for one broadcast on Hamas media, e call on Palestinians everywhere to fight.

"Dis na di day of di greatest battle to end dilast occupation on Earth," Mohammed Deif tok.

Reaction from around di world

Ursela von der Leyen don condemn di attacks

Wia dis foto come from, Getty Images

One advisor to Iran Supreme leader Ali Khamenei tok say im support Palestinian attack on Israel.

"We congratulate di Palestinian fighters," ISNA news agency dey quote Rahim Safavi.

"We go stand by di Palestinian fighters until di liberation of Palestine and Jerusalem”, e tok.

French President Emmanuel Macron don strongly condemn di attacks, e say "I express my full solidarity wit di victims, dia families and loved ones"

European Commission President, President Ursula von der Leyen describe di attacks as “terrorism for di most despicable form.”

Germany foreign minister tok say "violence and rockets against innocent civilians must stop now"

America condemn di violence and advise both sides say make dem no retaliate.

Russia deputy foreign minister call for restraint.

Fotos of Palestinian rocket attacks on Israel

Foto of fire militants fire enta Israel

Wia dis foto come from, Reuters

Fire

Wia dis foto come from, EPA

One building for Tel Aviv catch fire afta di rocket assault

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One building for Tel Aviv catch fire afta di rocket assault
Rockets

Wia dis foto come from, EPA

Palestinians react as one Israeli tank catch fire on di Israeli side of Israel-Gaza perimeter fence (7 October 2023)

Wia dis foto come from, Reuters

One man stand in front of burning car

Wia dis foto come from, Shutterstock