US strikes on Yemen oil terminal kill at least 74 - Houthis tok

Foto of cars wey dey burn inside fire

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di US military say di attack aim to restrict supplies and funds for di Iran-backed Houthis
    • Author, David Gritten
    • Role, BBC News
    • Reporting from, London
    • Author, Yang Tian
    • Role, BBC News
    • Reporting from, Sydney
  • Read am in 6 mins

US air strikes for one ogonge oil terminal for Yemen Red Sea coast wey di Houthi movement dey control don kill at least 74 pipo and wound 171 odas, di Houthi-run health ministry tok.

Di US military tok say dem don destroy Ras Isa "to eliminate dis source of fuel for di Iran-backed Houthi terrorists and no allow dem access illegal revenue".

Di Houthi-led govment for north-west Yemen tok say di terminal na civilian facility and say di strikes constitute "war crime".

Na di deadliest known attack since President Donald Trump order increase of di US bombing campaign last month for response to Houthi attacks on Red Sea shipping and Israel link to di Gaza war.

Some hours afta di strikes on Ras Isa, di Israeli military tok say dem don intercept one missile wey dem launch from Yemen.

Sirens bin sound for some Israeli areas but no reports of any casualties or damage.

Houthi-run Al-Masirah TV bin report say 14 air strikes hit Ras Isa late on Thursday.

Videos wey dem post online show some explosions, large fires and destroy fuel tankers for di facility, wey be about 60km (35 miles) north of di Red Sea city of Hudaydah.

"We bin run away. Di strikes bin come one afta di oda, den everitin dey on fire," one man wey tok say e bin work there tell di channel.

On Thursday afternoon, Houthi health ministry tok-tok pesin Anees al-Asbahi say di death toll don reach 74, add say di rescue teams still dey search for casualties.

Al-Masirah don earlier cite local health authorities as say many of di dead were workers for di Ras Isa. Dem also report say five paramedics dey killed for secondary US strikes as dem reach di scene.

Di casualty reports no fit dey immediately verified, but graphic footage from Al-Masirah show at least 10 body dem wey don wound well near di burning tankers, including one driver, as well as men wey dey kollet treatment for serious burns for hospital.

"We affirm say di targeting of di Ras Isa oil port na full-fledged war crime, as di port na civilian facility and no be military one," di Houthi-run govment tok for statement.

"We hold di US administration fully responsible for di consequences sake of result from im escalation in di Red Sea," dem warn.

Di US military Central Command tok for statement say di "objective of these strikes na to degrade di economic source of power of di Houthis, wey continue to exploit and bring great pain upon dia fellow countrymen".

"Di Houthis, dia Iranian masters, and those wey knowingly aid and abet dia terrorist actions suppose dey put on notice say di world no go accept illicit smuggling of fuel and war material to a terrorist organisation," e bin add.

Iran foreign ministry tok say dem strongly condemn di strikes as "barbaric".

 Footage from Houthi-run Al Masirah TV show as first responders dey recover some bodies near burning fuel tankers

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Footage from Houthi-run Al Masirah TV show as first responders dey recover some bodies near burning fuel tankers

On Thursday, di Houthis leader give aggressive speech wia e bin claim say di recent US strikes no stop dia attacks.

Abdul Malik al-Houthi say di group forces don carry out almost 80 operations wey involve around 170 missiles and drones since mid-March, including 30 attacks wey target di US aircraft carrier USS Harry S Truman and 26 attacks on Israel.

Yemen don dey devastated by civil war wey escalate 10 years ago, wen di Houthis bin seize control of di kontri north-west from di internationally-recognised govment and one Saudi-led coalition wey di US support bin chook mouth for effort to bring back di rule.

Di fight don reportedly leave more dan 150,000 pipo dead and trigger humanitarian disaster, with 4.8 million pipo displaced and 19.5 million - half of di population - in need of some form of aid.

Since November 2023, di Houthis don target dozens of merchant vessels wit missiles, drones and small boat attacks in di Red Sea and di Gulf of Aden. Dey don sink two vessels, seize one third, and kill four crew members.

Di Houthis don tok say dem dey act in support of di Palestinians in di war between Israel and Hamas for Gaza, and don claim - often falsely – say dem dey target only ships wey link to Israel, di US or di UK.

Di Houthis no dey worried by di deployment of Western warships in di Red Sea and Gulf of Aden to protect merchant vessels last year, or by multiple rounds of US strikes on military targets wey former President Joe Biden bin order.

Afta e take office for January, Trump bin redesignate di Houthis as "Foreign Terrorist Organisation" - sometin wey di Biden administration don remove sake of wetin dem say be di need to mitigate di kontri humanitarian crisis.

Last month, Trump order large-scale strikes on areas wey di Houthis dey control and threaten say dem go dey "completely annihilated". E don also warn say make Iran no arm di group – sometin wey dem don repeatedly deny say dem do.

Houthi-run authorities don tok say di strikes don kill dozens of civilians for recent weeks, but dey don report few casualties among di group members.

Earlier dis month, Trump bin posted one black-and-white video from one aircraft wey show one strike wey target about 70 pipo wey bin gather for circle wey e bin identify as Houthis. But di Houthi-run Saba news agency bin cite one source say na "a social Eid visit" for Hudaydah province.

Israel don also carry out air strikes against di Houthis since last July to retaliate for di hundreds of missiles and drones wey di Israeli military say dem don launch for di kontri from Yemen, most of which dem don shot down.