Who get Gaza?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Ethar Shalaby
- Role, BBC Arabic
- Read am in 7 mins
On Tuesday, US president Donald Trump propose to take over ownership of Gaza Strip and say im kontri "go do job with am too."
Im suggestions include to develop di Strip again and turn am into di "Riviera of di Middle East,".
Dis dey come afta im bin don first suggest say im go "relocate" Palestinians permanently to Egypt and Jordan.
Trump bin dey speak afta one meeting wit Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for White House, wia Netanyahu describe di suggestion as "worth paying attention to," come add say "dis na di kain thing wey go reshape di Middle East and bring peace."
Dis tok spark reactions from world leaders including Britain Prime Minister Keir Starmer, while plenty questions dey ground on weda dis fit spark new tension over di piece of land wey dey di Mediterranean Sea.
Who dey control Gaza now?
Since 2007, Hamas na di governing body for Gaza.
E win parliamentary elections for di occupied territories last year and reinforce im power for Gaza afta e remove im rival Fatah from di place.
Di group – wey Israel United States and some oda Western goments call terror organisation – don dey in control of di Strip for long.
Di Strip na one stretch of land wey dey surrounded by Israel, Egypt and Mediterranean Sea dey 41km (25 miles) long and 10km wide.
Since den, Hamas and Israel don fight major conflicts. Every round of fighting kill pipo on both sides, majority of dem Palestinians for Gaza.
On 7 October 2023, Hamas fighters launch assault from Gaza, killing about 1,200 people for Israel and dem take more dan 250 hostages.
Dis one lead to massive Israeli military offensive for Gaza, wey last for a continuous 15 months.
More dan 47,540 pipo na im die, majority of dem women and children, according to di Hamas-run health ministry.
For January 2025, Israel and Hamas agree to a ceasefire deal - afta months of indirect negotiations - to pause di war.
Di deal dey target to bring permanent end to fighting and to free hostages wey dey held by Hamas in Gaza in exchange for Palestinian prisoners wey dem hold for Israel.

Wia dis foto come from, Reuters
Trump fit take over Gaza Strip?
No details dey yet about how Trump plan to take over Gaza.
However, im announcement receive global condemnation, wit many kontris including Britain, France, Germany, Brazil, Australia, Russia and China rejecting di plan.
For di Gulf region, Saudi Arabia reject any attempts to displace Palestinians as e describe im position as "clear and explicit".
Jordan and Egypt bin also loud dia opposition to di "displacement of Palestinians".
Under International law, attempt to forcibly transfer populations dey strictly forbidden, and Palestinians as well as Arab kontris go see dis as notin but clear proposal to expel and ethnic cleanse Palestinians from dia land.
Domestically, before Trump election, to chook hand inside foreign conflicts bin no look like im top priority.
Di economy and immigration bin be top issues for Trump supporters. Ipsos and YouGov polls wey dem bin release, before di presidential vote, show say America pipo want dia goment to focus on cost of living.
E no clear weda taking over of Gaza go involve sending US troops.
Wen tori pipo ask weda American troops go dey involved, Oga Trump say "we go do wetin necessary".
According to US Constitution, Congress need to approve resolutions authorizing use of military force.
Currently, di congress wit im two chambers get ruling Republican party majority.
Congress approval dey required for major foreign arms sales, wit State Department notifying key committees before dem proceed.
Hassan Mneimneh, wey be professor for Middle East Institute for Washington, tell BBC say, "Trump no need to worry about Congress because im get strong congressional support".
Trump no speak about details of large scale spending on Gaza renovation, becos di idea still dey "vague," according to Mneimneh, wey believe say Trump plan to use money from Arab states to rebuild Gaza and West Bank.
Historically, who get Gaza Strip?
Before Israel establishment for 1948, Gaza bin dey under British colonial rule.
Di day afta Israel declare independence, five Arab kontris surround and attack am wit dia army.
By di time di fighting end wit an armistice for 1949, Israel dey controlled most of di territory, and agreements leave Egypt occupying di Gaza Strip, Jordan occupying di West Bank and East Jerusalem, while Israel occupy West Jerusalem.
Still, di history between Israel and Palestine fight go way back pass like dis.
But since Hamas enta power for Gaza, e don fight many major wars wit Israel including for 2008-09, 2012 and 2014.
Di major conflict between di two sides for May 2021 end in ceasefire afta 11 days.

Wia dis foto come from, Reuters
Gas and oil dey Gaza?
According to United Nations, e get unrealised potential of oil and gas for di occupied Palestinian territories.
For 2019, one report by United Nations Trade and Development Organisation (UNCTAD), say at least 3 billion barrels na im dey dia.
"Geologists and natural resources economists don confam say di Occupied Palestinian Territory sidon on top sizeable reservoirs of oil and natural gas wealth, for Area C of di occupied West Bank and Mediterranean waterside of di Gaza Strip," di report tok.
E point to new discoveries of oil and natural gas for di Levant Basin, wey sidon for di Mediterranean, and say e dey up "to 122 trillion cubic feet of natural gas wit net value of $453 billion (wit 2017 prices) and 1.7 billion barrels of recoverable oil wit net value of about $71 billion."
Some experts believe say Trump proposals fit dey related to extracting oil and gas resources.
However, odas dey argue say di interest in Gaza dey more political dan economical.
Laury Haytayan, na energy policy expert wit special interest in geopolitics of energy for di Middle East, im tell BBC say dem make oil and gas discoveries for Gaza Marine fields for di 2000s and discussion don dey ground since den about developing di sector.
She say, dis "fit be one of di factors" Trump carry for mind as im dey propose im suggestion of Gaza takeover, but not di only reason.
"Dem need to do more work to properly assess di amount of oil and gas for Gaza, and we need to manage our expectations," she tok.
Maher Tabaa, anoda economic expert from Gaza, say, "Trump get di gulf plus kontris wey dey richer in gas and oil compared to Gaza. Di focus for Gaza get has more political drive".
Speaking to BBC, former US envoy to Israel say Donald Trump dey see di crisis for Gaza as "real estate building problem".
Dennis Ross say: "I really tink say e be like im intend dis more as: 'We go transform area wey don always dey under poverty'."
Wetin Palestinians dey tok about Trump announcement?
Palestinians dey look at Trump proposal as notin more dan direct expulsion from dia land.
Palestinian President Mahmoud Abbas don oppose any plans to expel Palestinians from Gaza, calling Trump calls a "serious violation of international law".
Im say: "we no go allow any infringement of di rights of our pipo, wey we don struggle for many years and don make great sacrifices to achieve".
Di leader of di Palestinian delegation to United Nations, Riyad Mansour say make dem allow Palestinians to reclaim wetin bin be dia home before, "for those pipo wey wan send Palestinian pipo to a 'nice place', allow dem to go back to dia original homes for wetin now be Israel,".
For di Strip, ordinary Palestinians dey call am act of punishment.
Mahmoud Almasry, one 43-year-old for Gaza tell BBC say, no single pesin for Gaza agree to wetin Trump suggest. "Even if we stay inside di destruction, we no go ever leave our houses. Trump go like make anyone ask Americans to leave and resettle permanently somewhere?" im ask.
Sanabel Alghoul, 28, describe Trump proposals as "extremely dangerous".
She say im (Trump), believe say "di pain, starvation, destruction, and death wey we face go push us to easily give up on our right for Gaza."
Youssef Alhaddad, na Palestinian lawyer, im tell BBC say Trump dey use di idea of reconstructing Gaza as "pressure tool" wey aim at "forcing Gazans to leave dia homeland" something wey dem call "malicious".
Some Palestinians like Nevin Abdelal say dem go rather plan for redevelopment, wey "Palestinian hands" go do, adding say Gazans fit move to "beta available places for di Strip until dem finish di redevelopment, but make nobody leave."










