Who be di four Israeli hostages wey Hamas release for di latest swap?

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Alex Boyd
- Role, BBC News
- Read am in 9 mins
Hamas release four female Israeli sojas on Saturday, dis na di second hostage release of di Gaza ceasefire deal.
Dem hand Karina Ariev, Daniella Gilboa, Naama Levy and Liri Albag to di Red Cross for Gaza City.
In exchange 200 Palestinian prisoners wey Israel hold dem go free dem.
Di four women bin dey serve as observers for di Nahal Oz army base for di border wit Gaza wen Hamas attack Israel on 7 October, 2023.
Dia release na part of di second exchange since di ceasefire come into effect last Sunday. Three hostages and 90 Palestinian prisoners na im dem release for di first swap.
In total, 33 hostages na im dem go free ova six weeks for di first phase of di ceasefire, wey come into effect on 19 January, 2025.
About 1,200 pipo die for di 7 October attack and dem take 251 back to Gaza as hostages.
More dan 47,200 Palestinians, majority of dem na civilians, die for Israel offensive attack since den, na wetin Hamas-run health ministry tok.
Karina Ariev

Wia dis foto come from, Reuters
Karina Ariev, 20, bin dey serve for di Nahal Oz army base wen dem kidnap on 7 October, 2023.
Her sister Alexandra tell BBC say she hear shooting as Karina call her during di attack, and later she see wey show how dem carry Karina enta one car.
"She call me to tell me bye- bye, we bin hear shooting," she tok.
"She bin dey fear, she bin dey cry, she bin panic. Her last message na 'dem dey hia', for di bomb shelter. Dis na di last contact we bin get wit her."
Den Alexandra see di viral video of her kidnapping for Telegram. "We identify her, blood bin dey her face, she bin dey scream.
"I no go ever wish make anybody feel dis feeling," she tell BBC. "Time stop."
Naama Levy

Wia dis foto come from, Reuters
Dem feem Naama Levy, 20, as dem bundle her enta one jeep, her hands bin dey tied behind her back. Na Hamas release di video and circulate widely on social media. According to her mother, di teenager bin just begin her military service.
But she bin previously take part of one Israeli-Palestinian peace initiative, and her family call her " peace seeker".
For di video of her kidnapping from di Nahal Oz army base, she bin dey tell pipo wey capture for English say: "I get friends forPalestine."
For May 2024 her brother, Amit, say her family release di footage to "encourage all sides to go back to di table" to solve "an unbearable humanitarian issue".
"We feel like say she handle di situation like di true superhero wey she be, like hero wey dey fight for her life."
Daniela Gilboa

Wia dis foto come from, Reuters
Daniela Gilboa, 20, wound for leg wen dem kidnap her along wit oda female sojas for Nahal Oz.
She bin dey several videos, and for one last year she ask di Israeli goment why dem "abandon" and "discard" her while war rage around her.
Madam Gilboa mother, Orly, tell Jerusalem Post say di video show say her daughter bin dey "strong and determined" and add say di wounds wey she suffer on 7 October no dey as serious as dem dey fear.But, she say she bin dey concerned about her "poor mental state".
Meanwhile, her boyfriend father tell Maariv say im son dey wait for her to return - and plan to propose.
"My son ask her parents for her hand in marriage, and dem answere yes, even though dem dey only 19-20 years old. Right afta dat, im shout to di sky - 'I go propose to you!'" di father tok.
"Im pray say she go come back soon and go reunite wit am and her family."
Liri Albag

Wia dis foto come from, Reuters
Liri Albag bin dey 18 years old and she just start military training as an Army lookout wen Hamas attack di Nahal Oz base on 7 October 2023.
Her cousin Aya Albag, a corporal for army, tok she bin tell her say she bin dey "proud" of her for passing her observation course bifor she go di base
"She bin dey gingered and she bin dey so happy say dem assign her to Nahal Oz," she tell di Jerusalem Post. "She begin her role on Thursday, and a day and a half later, on Saturday morning, dem kidnap her.
Her family say she bin manage to pass messages back to dem through released hostages.
For January 2024, Hamas release footage of Albag, now 19 years old,.
"I dey only 19 years old. I get my entire life in front of me, but now my entire life dey on pause," Dia hear her dey tok am .
"Di world don dey start to forget about us. Nobody care about us. We dey live for nightmare."
Hostages wey dem don already release for di latest ceasefire
Three female Israeli hostages wey dem don already release as part of di latest ceasefire and hostage release deal.
Romi Gonen, 24, dem capture her as she bin try to escape di Nova music festival wen militant group bin target am as part of di 7 October 2023 attack.
Dem free her alongside Doron Steinbrecher, 31, one veterinary nurse, and Emily Damari, 28, wey holds dual British-Israeli nationality.
All three bin arrive back for Israel on Sunday afta Hamas release dem for Gaza, wia dem reunite wit dia families.
Romi Gonen

Wia dis foto come from, Reuters / Handout
Romi bin travel from her home for Kfar Veradim, northern Israel, to di Nova festival, wey take place for Negev Desert for south.
More dan 360 pipo die for di festival wen Hamas fighters cross ova di border, 2km (1.3 miles) to di west. Di desert landscape give partygoers limited cover and gunmen block di exit routes.
Wen sirens sound as di attack dey happun, Romi call her family. Her mother, Meirav, remember hearing shots and shout for Arabic for di final call wit her daughter.
Hamas militants ambush Romi as she try to run.
Di Hostages and Missing Families Forum say Romi bin go di festival "to do wetin she love, to dance" - something wey she don study for 12 years, she don appear for solo performances and becoming an "amazing choreographer".
One video wey di families' forum post last November describe her as "di girl wit di biggest smile, di brightest light, di greatest friend".
Di forum also say Romi bedroom for her home "remain exactly as e dey wen she bin leave", as dem wait for her return.
For video clip wey Israeli military share, Romi's father bin jump up for air bifor im break down in tears as im watch footage of im daughter release on Sunday.
Doron Steinbrecher

Wia dis foto come from, Bring Them Home Now / Handout
Dem kidnap Doron, a 31-year-old veterinary nurse, from her apartment for Kibbutz Kfar Aza - near Gaza north-western border - wen Hamas attacked.
Di community, na one of many Israeli villages along di border, wey armed militants bin heavily target during di 7 October attacks.
Israeli officials say Hamas burn homes and kill civilians, including whole families, as well as taking hostages.
Wen di assault start, Doron contact her family and friends via WhatsApp to say she bin dey hide under di bed as di militants advance, di Hostages and Missing Families Forum tok.
For her last voice message, dem hear her dey scream "dem don catch me " as shouting and gunfire dey sound for di background.
Doron family no receive information about her whereabouts for nearly four months.
"After an unbearable 471 days, our beloved Dodo don finally return to our arms," her family tok for statement release by di missing families forum on Sunday.
Dem add: "We want express our heartfelt gratitude to everybody wey support and accompany us along dis journey."
She study theatre and film for school, and develop love for animals wey lead her to becoming a veterinary nurse.
Emily Damari

Wia dis foto come from, PA Media
Emily, na 28-year-old British-Israeli national, wey dem also capture from Kibbutz Kfar Aza on 7 October 2023.
Dem shoot her hand na from her home dem carry her go Gaza during di attack, she also see as dem shoot and kill her dog. Photographs afta her release show Emily wit one bandaged hand and two missing fingers from dat attack.
Her mother, Mandy Damari, bin also dey kibbutz for her separate home on 7 October. Madam Damari hide for safe room and she bin dey saved by one bullet wey hit di door handle, wey make am impossible for attackers to get in.
As di assault dey happun Emily send her mother a text message wey contain a single heart emoji – dat na di last contact dem get.
Emotional images show Emily as she reunite wit her mother for Israel on Sunday, dem hug as dem dey on video call wit her brother.
"I wan thank everybody wey no stop to fight for Emily throughout dis ogbonge ordeal, and di pipo wey no stop to say her name," Madam Damari tok.
"For Israel, Britain, United States, and around di world. Thank you for bringing Emily home."
Dem born Madam Damari and raised her for UK, and she meet her husband for one holiday for Israel at di age of 20.
Emily, na di youngest of her four children, she get strong connections wit UK - she be Tottenham Hotspur fan and go often visit to see relatives.
More Israeli hostages wey dey due for release
Before di ceasefire, Israel say 94 hostages dey unaccounted for but dem believe say only 60 to still dey alive.
For di first phase of di ceasefire deal na 26 Israeli hostages dey due for hand ova. Israeli prime minister believe say most of dem dey alive.
Israel name dem as:
Itzik Elgarat, 69; Agam Berger, 20; Ohad Ben Ami, 55; Arbel Yahud, 29; Alexander (Sasha) Troufanov, 29; Sagui Dekel-Chen, 36; Omer Wenkert, 23; Yair Horn, 46; Oded Lifshitz, 84; Or Levy, 34; Eliya Cohen, 27; Ohad Yahalomi, 50; Tsachi Idan, 50; Keith Siegel, 65; Shlomo Mansour, 86; Gadi Moses, 80; Eli Sharabi, 52; Omer Shem Tov, 22; Tal Shoham, 39; Ofer Kalderon, 53; Yarden Bibas, 34; Shiri Bibas, 33; Ariel Bibas; Kfir Bibas.
Di list also includes two men Hisham al-Sayed, 35, and Avera Mengistu, 27, wey Hamas capture afta dem cross into Gaza from Israel bifor di war.












