Who go run Gaza now and how dem take reach peace deal between Israel and Hamas

One Palestinian pikin for Gaza and one Israeli woman and one man for Tel Aviv smile for di news of di ceasefire agreement

Wia dis foto come from, Anadolu / Getty Images

Wetin we call dis foto, Crowds for Gaza (L) and Israel (R) dey celebrate di ceasefire deal
Read am in 8 mins

Israel and Hamas don reach ceasefire deal to end 15 months of war.

Qatari Prime Minister Sheikh Mohammed bin Abdul Rahman Al Thani say di agreement go take effect on Sunday, as long as Israeli cabinet approve am.

Di deal na ogbonge breakthrough for di war, wey begin wen armed Palestinian group Hamas attack Israel on 7 October 2023.

US President Joe Biden say e go "stop di fighting for Gaza, surge much-needed humanitarian assistance to Palestinian civilians, and reunite di hostages wit dia families afta more dan 15 months for captivity".

To get to dis points take months of serious indirect negotiations, becos Israel and Hamas completely no trust each oda.

One Palestinian girl inspect her family house wey scata afta di Israeli air strike for Al Maghazi refugee camp, central Gaza Strip, on 3 January 2025 - according to reports from di Hamas-run Ministry of Health in Gaza, at least nine members of the Abu Libda family die for di Israeli air strike for di refugee camp

Wia dis foto come from, Mohammed Saber / EPA

Wetin we call dis foto, One Palestinian girl inspect di destroyed house of her family afta di Israeli air strike for Al Maghazi refugee camp, central Gaza Strip on 3 January 2025

Hamas want a complete end to di war bifor dem go release di hostages, somtin wey bin dey unacceptable to Israel.

Di ceasefire go press pause for di war while dem carry out di terms.

But, e no dey clear weda e mean say di war don end kpatakpata.

One of Israel koko for di war na to destroy Hamas military and governing capabilities. Although Israel don damage am well-well, Hamas still get some capacity to operate and regroup.

Freeing hostages and prisoners

Families of hostages wey Hamas hold for Gaza and dia supporters carry photo of hostages outside di Likud Party headquarters on 8 January 2025, during one protest wia dem bin call for ceasefire and hostage release

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, As part of any peace deal, Isreal want Hamas to return di hostages

E no dey which hostages dey alive or dead, or weda Hamas know di whereabouts of all dose wey remain unaccounted for.

For dia part, Hamas dey demand for di release of some prisoners wey Israel say dem no go free. Dem include dose wey get hand for di 7 October attacks.

Also e no dey clear weda Israel go agree to pull out of di buffer zone by a specific date, or weda dia presence go be open-ended.

One boy wey hold water bottle dey push wheelchair for Khan Yunis refugee camp for southern Gaza, di buildings around am dey destroyed

Wia dis foto come from, Bashar Taleb / AFP / Getty Images

Any ceasefire dey likely fragile.

Ceasefires between Israel and Hamas wey bin stop previous wars na arguments scata am, and e eventually break down.

Di timetable and complexity of dis ceasefire means say even one small incident fit turn into major threat to peace.

How di ceasefire fit work?

Palestinian women stand for window of one damaged building, amid ceasefire negotiations wit Israel, for Gaza City on 15 January 2025.

Wia dis foto come from, Mahmoud Issa / Reuters

Dis ceasefire dey expected to happun in three stages.

While both sides now don agree to am, Israel security cabinet and goment go need to approve di deal bifor dem fit implement am.

Phase one: Hostage and prisoner releases

For im speech announcing di deal, Israeli goment tok-tok pesin David Mencer say 33 hostages – wey dem expect to be women, including female sojas, children, di elderly and di sick or injured – go dey exchanged for Palestinian prisoners.

Afta dis, e no clear how many of di oda remaining hostages dey alive.

Three hostages go dey released straight away, one Palestinian official tell BBC, di rest of di exchange go take place ova six weeks.

During dis stage, Israeli sojas go begin pull out of di populated areas for Gaza - but e no dey clear how long dis go take.

Israel go also allow displaced pipo now for di south of Gaza to begin to return to di north.

Almost all of Gaza 2.3 million pipo don leave dia house becos of Israeli evacuation orders, Israeli strikes and fight-fight wey dey ground.

One pikin cova hersef wit blanket as she stand among buildings wey dey destroyed

Wia dis foto come from, Getty Images

Qatar Prime minister Sheikh Mohammed Bin Abdulrahman al-Thani confam say dem go intensify humanitarian aid deliveries to all parts of Gaza strip, as well as di rebuilding of hospitals.

Di exact amount of aid na anoda detail wey no dey confirmed.

Asked how much confidence im get say di deal go progress beyond phase one, im say negotiators get faith, but e depend on di parties wey dey involved. "We expect di parties to follow di agreement," Im add.

One Palestinian official say detailed negotiations for di second and third stages go begin on di 16th day of di ceasefire.

Dem neva finalise If, wen and how Israeli sojas go leave di Philadelphi Corridor wey get border wit Egypt.

One Israeli sojas waka towards di entrance to one tunnel wey lead to Egypt, for di Philadelphi Corridor area for southern Gaza, on 13 September 2024

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One Israeli soja dey waka towards di entrance of one tunnel wey lead to Egypt, for Philadelphi Corridor area of southern Gaza

Phase two: More release

Dem go finalise di details of phase two and three during di implementation of phase one, Qatar Prime Minister Sheikh Mohammed Bin Abdulrahman al-Thani tok.

Phase two go involve negotiating "a permanent end of di war", US President Joe Biden tok for one press conference to announce di deal. If negotiations last pass six weeks, di ceasefire go continue, Biden tok.

Pipo visit di site of di Nova festival, on 7 November 2024, six months afta di deadly 7 October attack

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Hamas militants kill hundreds of pipo for di Nova music festival on 7 October 2023

Tori be say di remaining male hostages – sojas and civilians – dem go release dem in return for more Palestinian prisoners.

Israel tok say dem don agree to release hundreds of Palestinian prisoners, while one Palestinian official tok of more dan 1,000 wey go dey free.

About 190 dey serve sentences of 15 years or more. One Israeli official tell BBC say dose wey chop murder conviction, dem no go release dem for di occupied West Bank.

Also for di deal na full withdrawal of Israeli troops from Gaza and di start of a "sustainable calm". Dat dey defined for previous proposals as "a permanent cessation of military and hostile operations".

Phase three: Rebuild Gaza

Di third and final stage go involve di reconstruction of Gaza - somtin wey go take years.

President Biden say for dis phase, displaced Palestinians go fit return to neighbourhoods for all areas of Gaza.

Dem go also return di final remains of dead hostages to dia families, im tok.

Trump fit take di credit for di ceasefire?

US President-elect Donald Trump wave as im visit a caucus site for Horizon Event Center in Clive, Iowa, U.S. January 15, 2024. REUTERS/Sergio Flores

Wia dis foto come from, Reuters

President-elect Donald Trump claim credit on social media for di ceasefire deal between Israel and Hamas. Im say, di "epic ceasefire agreement only happun sake of di result of our historic victory for November".

For Doha, Qatari Prime Minister Sheikh Mohammed Bin Abdulrahman al-Thani take questions from tori pipo afta im announce di deal.

Di first na why we reach di deal now and if na pressure from di incoming US president wey make am happun.

Oga Al Thani say Qatar don undergo "momentum" wey start to build in recent months.

"We don see steps wey US don take recently wey don yield to dis moment," Im tok.

Im add say wetin we don see from US in di last few days na collabo wey go beyond both administrations, wey im describe as a clear commitment to reach a deal.

How dem go enforce di deal ?

Qatar's Prime Minister Sheikh Mohammed bin Abdulrahman bin Jassim al-Thani address tori pipo for Diwan Annex for Doha on 15 January 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Israeli cabinet still need to approve di deal for vote. But dem dey expected to do so, despite objections from some ministers for di far-right flank of di goment.

Tori pipo ask di Qatari PM for news conference how much confidence im get say di deal go progress beyond phase one.

Im say dem get faith and all depend on di parties for di agreement.

Pressed on di mechanisms wey dey in place to ensure both sides follow di deal, im say three kontris - US, Egypt and Qatar - go monitor di implementation of di agreement.

"We expect from di parties to follow di agreement," im add, but im also recognise say dis dis types of deals dey complex.

Who go run Gaza?

Supporters of Israeli hostages, wey dem kidnap during di deadly October 7 2023 attack by Hamas, hold torches as dem attend a protest to demand a deal to bring every hostage home at once, as Gaza ceasefire negotiations dey go on, for Tel Aviv, Israel, on 15 January 2025.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Supporters of Israeli hostages dey hold vigil for Tel Aviv di day dem announce di deal

Which parties go run Gaza afta di war na one of di great unanswered questions.

Di Palestinian Authority (PA) gatz be di sole governing power for Gaza afta di war, Palestinian Prime Minister Mohammad Mustafa tok on Wednesday bifor dem announce di ceasefire deal.

Israel no gree let Hamas continue to govern di territory. Dem also refuse di PA to run Gaza, wey dey administer parts of di Israeli-occupied territories for West Bank.

And Israel wan retain security control ova Gaza afta war finish.

But dem dey work wit US and di United Arab Emirates on a plan for a provisional administration to run Gaza while di PA dey reformed. Di new administration go den take ova as di permanent goment.