Israel and Hamas reach Gaza ceasefire and hostage release deal

One view of damaged buildings for di northern Gaza Strip, as seen from Sderot for southern Israel (15 January 2025)

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 4 mins

Israel and Hamas don agree to one Gaza ceasefire and hostage deal afta meetings wit Qatar prime minister.

Qatar Prime Minister Sheikh Mohammed bin Abdulrahman Al Thani confam di agreement during one news conference for Doha.

Al Thani tok say di deal go now take effect on Sunday 19 January, and dem go determine di exact timing.

"Hopefully dis go be di last page," for di war, Qatari PM tok.

US President Joe Biden wey also confam di deal say, e go "stop di fighting in Gaza, and go bring in di much needed-humanitarian assistance to Palestinian civilians, plus reunite di hostages wit dia families afta more dan 15 months in captivity.

"I lay out di precise contours of dis plan on May 31, 2024, afta which di UN Security Council endorse am unanimously."

Di Israeli prime minister office tok say "plenty unresolved clauses" still dey but dem hope say agreement go fit dey finalised on Wednesday night.

One Hamas official bin earlier tok say di group don approve one draft from US, Qatari and Egyptian mediators.

US President-elect Donald Trump also write on social media: "We don get deal for di hostages for di Middle East."

Details of di three-phase plan neva dey published, but tori be say, during di first six weeks of di ceasefire, dem go exchange 33 of di hostages wey still dey Hamas captivity for Palestinian prisoners for Israeli jails at regular intervals.

Negotiations for di second phase – wey go monitor di release of di remaining hostages, full withdrawal of Israeli troop and a "sustainable calm" - go start afta two weeks.

Di third and final stage go involve di reconstruction of Gaza - something wey fit take years – plus di return of any remaining hostages' bodies.

Deal go begin wit six-week ceasefire and hostage release

Phase one na one initial six-week ceasefire. During dat period Hamas go release 33 of di hostages wey dem capture for di 7 October attack. E no dey clear how many of those 33 still dey alive.

In return for each hostage dem set free, Israel go release dozens of Palestinian prisoners.

Israel go comot dia sojas from areas where pipo plenty for Gaza Strip into one buffer zone on di eastern side.

Dem go immediately allow di supply of more aid and fuel to Gaza – and dem go manage di return of two million displaced pipo of Gaza back to diar homes.

One group of Israeli hostages still dey – men of military age – wey no dey part of di first release. Dem go decide dia fate for anoda round of toks wey go start 16 days into di ceasefire.

Na afta dat, key questions about Gaza future – like who go govern am, and whether Israel fully withdraws, go dey discussed.

Di Israeli military bin launch one campaign to destroy Hamas afta di group carry out attack on southern Israel on 7 October 2023, wey lead to di death of 1,200 pipo and dem take 251 pipo hostage.

More dan 46,700 don die for Gaza since then, according to di territory Hamas-run health ministry.

Most of di 2.3 million population also don scata, widespread destruction, severe shortages of food, fuel, medicine and shelter dey for Gaza sake of struggle to get aid to those wey need am.

Israel say 94 of di hostages still dey Hamas capacity, and dem reason say 34 of di hostages fit don die. In addition, four Israelis bin dey kidnapped bifor di war, two of dem don die.