Wetin happun to Hamas most popular leaders?

Israel don kill many of Hamas top leaders since di group attack Israel on 7 October 2023, and dis one give big blow to di group.
Dis na wetin don happun to Hamas most popular leaders:
Yahya Sinwar

Wia dis foto come from, Getty Images
Yahya Sinwar na di brain behind di 7 October attacks, wey kill about 1,200 pipo and land 251 odas as hostages for Gaza.
Im also be one of Israel top targets from dat day.
Sinwar na di leader of Hamas for Gaza, but become di overall head of Hamas afta di assassination of Ismail Haniyeh for Tehran for July dis year.
Sinwar, wey dem born for Gaza Strip for 1962, join di movement for young age.
Na im establish Hamas security service, wey dem sabi as Majd, wey dey manage internal security mata, investigate suspected Israeli agents, and track down Israeli intelligence and security service officers.
Israel bin arrest Sinwar three times. Afta im number three arrest for 1988 dem sentence am to four life terms in prison.
However, im bin follow among di 1,027 Palestinian and Israeli Arab prisoners wey Israel release in exchange for one Israeli soldier wey Hamas bin capture for more dan five years.
Sinwar return to im position as popular leader for Hamas and dem appoint am head of di group political bureau for Gaza Strip for 2017.
For 2015, United States include Sinwar for blacklist of "international terrorists".
Israel Defence Forces kill Sinwar for Rafah on 16 October 2024.
Ismail Haniyeh

Wia dis foto come from, Getty Images
Ismail Haniyeh na Hamas overall leader until di group confam im death for Iran on 31 July 2024.
Haniyeh na gbonge member of di movement for di late 1980s, wey Israel lock for prison for three years for 1989 as e dismantle di first Intifada or Palestinian uprising wey begin for 1987.
Dem send am on exile for 1992 to one no-man's-land between Israel and Lebanon, togeda wit some Hamas leaders.
Afta one year for exile, im return to Gaza.
For 1997 dem appoint am head of di office of Hamas spiritual leader, dis one make im position stronger.
President Mahmoud Abbas appoint Haniyeh di Palestinian prime minister for 2006 afta Hamas win di most seats for national elections, but dem dismiss am one year later afta di group remove Abbas Fatah party from Gaza Strip inside one week of deadly violence.
Haniyeh reject im sack onto say e dey "unconstitutional", kon stress say im goment "no go abandon im national responsibilities towards Palestinian pipo", and continue to rule for Gaza.
Dem elect am as di head of Hamas political bureau for 2017.
For 2018, United States Department of State list Haniyeh as terrorist.
Im bin live for Qatar for di last several years.
Mohammed Deif

Wia dis foto come from, Media sources
Mohammed Deif bin be head of Hamas military wing - al-Qassam Brigades – and dem believe say im be key planner of di 7 October attack.
E bin be like shadow wey Palestinians sabi as Di Mastermind, and Israelis dey call am Di Cat wit Nine Lives.
Israeli authorities put am for prison for 1989, na afta dat time im form di al-Qassam Brigades wit di aim of capturing Israeli soldiers.
Afta im release, im help engineer wit di construction of tunnels wey bin allow Hamas fighters to enta Israel from Gaza.
Deif na one of Israel most-wanted men, wey dey accused of planning and supervising bus bombings wey kill many Israelis for 1996, and for im involvement for di capture and killing of three Israeli soldiers for mid-1990s.
Israel put am for prison for 2000, but im escape for di beginning of di second intifada.
For one assassination attempt for 2002, Deif survive but lost one of im eyes. Israel say e also lost one foot and one hand, and say e get difficulty in speaking.
Israeli security forces again fail to assassinate Deif during di 2014 assault on Gaza Strip, but dem kill im wife and two of im children.
Israel say dem eventually kill Deif for one air strike wey dem do for one compound for Khan Younis for July 2024.
Marwan Issa

Wia dis foto come from, Media sources
Marwan Issa bin be di deputy commander-in-chief of al-Qassam Brigades and belief dey say im too play big part for di planning of di 7 October attack.
E don tey wey im dey for Israel most-wanted list, and bin wunjure wen dem attempt to assassinate am for 2006.
Israeli forces detain Issa during di first intifada, between 1987-1993, sake of im activity wit Hamas.
Palestinian Authority arrest am for 1997, but dem release dem afta di second intifada begin for 2000.
Israeli warplanes destroy Issa house two times during invasions of Gaza for 2014 and 2021, wey kill im broda.
Israeli media give Issa di nickname Shadow Man, sake of im ability to dodge and nobodI fit find am, and and nobodi bin sabi wetin im look like until 2011, wen im appear for one group photo taken during one reception for exchanged prisoners.
Israel say dem kill Issa for one air strike inside one tunnel under one refugee camp for central Gaza Strip for March 2024.
Khaled Meshaal

Wia dis foto come from, Getty Images
Khaled Meshaal, wey dem born for West Bank for 1956, na pesin wey dem bin see as one of di founders of Hamas.
Under direct instructions from Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, Israel Mossad spy agency attempt to assassinate Meshaal for 1997 wen im dey live for Jordan.
Mossad agents enta Jordan wit fake Canadian passports and dem inject Meshaal wit one toxic substance as im de waka for street.
Jordan authorities discova di assassination attempt, come arrest di two Mossad members.
Di late King Hussein of Jordan ask Israel prime minister for di antidote for di poison wey dem inject Meshaal.
Wit serious pressure from US President Bill Clinton dat time, Netanyahu later give di antidote afta im initially reject di request.
Meshaal, wey dey live for Qatar, visit Gaza Strip for di first time for im life for 2012.
Palestinian officials receive am and crowds of Palestinians pipo come out to welcome am.
Hamas elect Ismail Haniyeh to succeed Meshaal as head of im political bureau for 2017 as Meshaal become head of di group political bureau abroad.
Mahmoud Zahar

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem born Mahmoud Zahar for Gaza for 1945 to Palestinian papa and Egyptian mama.
Israel dey see am as one Hamas most ogbonge leaders, and member of di movement political leadership.
Im go school for Gaza and university for Cairo, kon work as doctor for Gaza until Israeli authorities dismiss am sake of im political position.
Mahmoud Zahar bin chill for Israeli prisons for 1988, months afta di establishment of Hamas.
Im dey among pipo wey Israel deport go southern Lebanon for 1992, wia im spend one year.
As Hamas movement win Palestinian general elections for 2006, Zahar join di Ministry of Foreign Affairs for Prime Minister Ismail Haniyeh newly formed goment bhis for dem eventual dismissal dem.
Israel attempt to assassinate Zahar for 2003, wen one plane drop bomb on im house for Gaza City.
Di attack leave am wit minor injuries, but kill im eldest son, Khaled.
Im second son, Hossam, wey be member of al-Qassam Brigades, die for one Israeli air strike for Gaza for 2008.









