Israel confam say dem kill Hamas leader Yahya Sinwar

Head of Hamas Yahya Sinwar

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 6 mins

Israel Defence Forces (IDF) don release one statement wey say dia troop kill Hamas leader Yahya Sinwar for one operation for south of Gaza on Wednesday afta one "year-long pursuit".

For one statement, IDF say: "Yahya Sinwar dey eliminated afta hiding for di past year behind civilian population of Gaza, both above and below ground for Hamas tunnels for di Gaza Strip," im tok.

Di Israeli military say e bin dey operate for southern Gaza following intelligence "wey indicate di suspected locations of senior members of Hamas".

Earlier, Israeli Foreign Minister Israel Katz bin announce on Thursday say Hamas leader Yahya Sinwar don die.

"Mass murderer Yahya Sinwar, wey dey responsible for di massacre and atrocities of October 7, IDF (Israeli military) soldiers kill am today," Katz tok for one statement.

Hamas never release official statement.

Israel President Isaac Herzog commend Israeli forces for killing di Hamas leader, saying Yahya Sinwar bin dey "responsible for heinous acts of terrorism against Israeli civilians, citizens of oda kontris, and di murder of thousands of innocent pipo".

"Now, more dan ever, we gatz act in evri way possible to bring back di 101 hostages wey Hamas terrorists still dey hold in horrific conditions for Gaza," im tok for one post for X.

Earlier, Israeli military say e dey “check di possibility” say dem don kill Hamas leader Yahya Sinwar afta one operation for di Gaza Strip, wey dem say bin target three militants.

"At dis stage, di identity of di terrorists never dey confam," e tok for one statement.

But one Hamas-linked website, Al-Majid, wey di group dey usually use publish security issues, don beg Palestinians to wait for information about Sinwar from di group imsef and not from Israel tori pipo.

Israel Army Radio say di incident happun wen dem do one ground operation for di city of Rafah for southern Gaza Strip wia dem kill three militants carry dia deadibodi.

E say di evidence wey dem see dey suggest say one of di men fit be Sinwar and dem dey do DNA.

Inside one joint statement wey di Israel Defence Forces and Israel Police release, dem say dem submit Sinwar dental images to one forensics lab.

Dem say dem compare dis samples from di alleged bodi to records wey Israel get of Hamas leader as a result of di 22 years wey Sinwar spend for Israeli jail.

Wetin Sinwar death mean for di Middle East?

Yahya Sinwar na Israel number one target for Gaza wey dem accuse say im dey responsible for organising and directing di 7 October attacks last year, wen thousands of armed men break through Gaza fence, kill about 1200 pipo plus kidnap more dan 250 hostages back to Gaza.

Sinwar death na di most significant death since di killing of Hezbollah leader Sayyed Hassan Nasrallah last month.

Israel say dem kill Nasrallah for airstrike for villages wey dey south of Lebanon capital, Beirut.

Nasrallah death na heavy blow to di Hezbollah group.

As for Sinwar death, e go increase tensions for di Middle East wia fear dey grow everyday say di Middle East conflict fit expand more as Israel dey plan im response to October 1 missile attack wey Iran do afta Israeli airstrikes.

Di commander of Iran Revolutionary Guards bin draw ear give Israel earlier on Thursday against attacking di Islamic Republic.

"We tell you (Israel) if you commit any aggression against any point, we go painfully attack di same point of yours," Hossein Salami, di Revolutionary Guard commander-in-chief tok for one televised speech.

Salami add say Iran fit penetrate Israel defences.

Some pipo dey expect say Israel fit strike Iran nuclear facilities, as dem don dey threaten to do for long and oda options include attacks on dia vital oil sites.

Israel don kill several commanders of Hamas for Gaza as well as senior figures of Hezbollah for Lebanon.

Sinwar death no go immediately end di Israel fight for Gaza but di hope be say Israeli military operations against Hamas for Palestinian territory, wey don kill hundreds of civilians, fit bring di end of di war a little closer.

Who be Yahya Sinwar ?

Israel label am "Di Face of Evil." Sinwar dey operate in secret, moving constantly and using trusted messengers for non-digital communication, according to three Hamas officials and one regional official.

Im never show for public since October 7, 2023.

Sinwar na di sole decision-maker for di many months of failed ceasefire toks, wey Qatar and Egypt bin lead, wey focus on swapping prisoners for hostages, three Hamas sources tok.

Negotiators go wait for days for responses wey dey filter through secret chain of messengers.

Sinwar high tolerance for suffering, both for imsef and for di Palestinian pipo, show well wen im bin help negotiate di 2011 exchange of 1,027 prisoners plus imsef, for one kidnapped Israeli soldier wey dem hold for Gaza.

Di few pipo wey sabi Sinwar tell tori pipo Reuters say di kain poverty wey im carry im eyes see as small pikin for Gaza, plus brutal 22 years wey im spend for Israeli prison, including one time for Ashkelon, di town wey im parents bin call dia home bifor dem run afta di 1948 Arab-Israeli war, na im make am wetin im be today.

Sinwar become member of Hamas soon afta dem establish am for di 1980s, adopting di group radical Islamist ideology, wey wan establish Islamic state for historic Palestine plus oppose Israel existence.

Dem born Sinwar to one refugee family for Khan Younis, southern Gaza.

Im bin member of di generation wey grow under di leadership of prominent Muslim Brotherhood Gaza figures like Sheikh Ahmed Yassin and Dr Abdel Aziz al-Rantissi, and im be mate wit Ismail Haniyeh.

All three of dem become leaders of Hamas at one point or di oda. Dem assassinate all three of dem, Yassin and Rantissin for early 2000s, Haniyeh earlier dis year.

Early Hamas career

For middle of 1980s dem bin appoint Sinwar as di head of Munazamat al-Jihad wa al-Da’wa (Organization of Holy War and Preaching).

E bin lead di security and punishment unit wey dem dedicate to eliminate Palestinians wey dem bin suspect say dey collabo wit Israel, and planning attacks on Israelis.

Wen di First Palestinian Intifada happun for December 1987 Yassin immediately create Hamas to capitalize on di increasing mood of anger of Palestinians against Israeli military occupation, and Sinwar na di main di main part of early Hamas cadres.

But dem arrest am weeks afta di Intifada begin, kon send am to prison on consecutive life sentences for Israel for planning di killings of Israeli soldiers and suspected Palestinian collaborators.

Im go prison as young man, come out as middle-aged man.

Na for dia im learn Hebrew and spend years studying Israelis veri close.

Afta dem release am for October 2011, Sinwar tell im supporters wey bin dey celebrate im freedom say: "You fit say I be specialist in Jewish pipo history, more dan many of dem."

Di killing of Sinwar fit be opportunity to finally complete di ceasefire deal wey US say don already reach 90% complete, and bring Israel hostages home.

But e also risks doing di opposite: Driving angry Hamas members more away dan eva from any kain of compromise.