Drone attack for Israel show how di Iron Dome strong reach

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Jonah Fisher
- Role, BBC News
- Reporting from, Northern Israel
- Read am in 4 mins
Drone dey slow, small and cheaper to make, but e don turn deadly headache for Israel for dis war wey don pass one year now.
Hezbollah attack on one army base near Binyamina for northern Israel on Sunday, wey kill four men and injure dozens na di most damaging drone strike for di kontri.
E don make pipo begin ask how Israel expensive air defence system dey equipped to stop dem.
Wen di Israeli Defence Minister Yoav Gallant go di damaged army base on Monday morning, e say dem go put "significant efforts" to solutions wey go prevent future drone attacks.
Some parts of di air defence systems dey work well. For northern Israel, we dey hear booms almost all di time as di Iron Dome dey block rockets wey Hezbollah dey fire from southern Lebanon.
Israel say e dey hit ova 90% of dia targets.
But di Iron Dome dey work bicos Hezbollah dey use local rockets and e dey possible to calculate wia di rockets go take off , so dem go fit block dem.
Stopping drones dey more complicated. And dat na why e don turn problem for dis war.

For July, drone wey Yemen Houthis bin fire land Tel Aviv. Earlier, for October, di Israel Defense Forces (IDF) say one drone wey Iraq bin launch kill two sojas for di Golan Heights. Na just last week anoda drone hit nursing home for central Israel.
Dr Yehosua Kalisky, wey be senior researcher for di Institute of National Security Studies for Tel Aviv tell di BBC say, "most, if not all, of di drones na Iran manufactured dem and den, dem go supply am give armed groups for Lebanon, Iraq and Yemen".
Drones get small radar signature and fit fly for low altitudes wey dey make am hard for radar to get early detection. Sometimes dem even dey mistake dem for birds.
Dr Kalisky explain say "e also dey hard to use aircraft block dem sake of say, di UAVs (drones) dey fly slowly. Dem dey go like 200km/h compare to di 900km/h wey jet dey go".

Wia dis foto come from, Reuters
Israeli media reports dey suggest say on Sunday, two Haezbollah drones wey be like na Ziyad 107s, cross Lebanon air space above di Mediterranean.
Dem bin shoot down one but di oda disappear so no warning sirens bin come on. E later hit di canteen of one army base.
But Sarit Zehani from di Alma Research Institute wey specialise in security for di northern border, no tink say na luck make di drones enta.
She say, "dem plan am. Dem don dey try do dis for long."
Zehani dey live 9km from Lebanon border for western Galilee and she bin watch wetin happun on Sunday from her balcony. She say rocket fire and alerts bin dey all ova di border area as dem bin launch di drones wey "overwhelm" di air defence system and help di drones go through.
Di Alma Research Institute don count 559 times wey drones cross di northern border, weda for surveillance or attack missions since di war start one year ago.
Apart from Sunday attack for Binyamina, e say dem don get 11 victims from drone attacks.

Israel air defence system include di Iron Dome, plus oda systems like David's Sling, Arrow 2 and Arrow 3, all of dem dey designed to destroy ballistic missiles. And dem go soon add one Terminal High Altitude Area Defence (Thaad) battery from di United States wey almost 100 US military personnel go operate.
Dem dey currently develop more permanent solutions to fit take down drones.
Dr Kalisky say, "dem dey work on high powered lasers and di oda technology na to use microwave cannons to burn di drone electronics."
She say dis technology dem go dey "available for di very near future".









