How Israel kill Hamas leader Sinwar for one by chance encounter
- Author, Graeme Baker
- Role, BBC News
- Read am in 6 mins
Israeli troops bin dey find Hamas leader for more dan a year, im bin disappear for Gaza immediately afta im mastermind di 7 October attacks.
Yahya Sinwar, wey be 61 years bin spend most of im time for tunnels under di Strip wia im bin dey hide, along with bodyguards and one "human shield" of hostages wey dem seize from Israel.
But ultimately, e be like say im meet im end for one by chance encounter with one Israeli patrol for southern Gaza. Im bin no get plenti guards. Dem no see any hostages too.
More details still dey come out, but dis na wetin we know so far about how Israel kill Sinwar.
Routine patrol

Wia dis foto come from, IDF
Di Israel Defence Forces say one unit from dia 828th Bislamach Brigade bin dey patrol for Tal al-Sultan, one area of Rafah, on Wednesday.
Three fighters bin dey dia and di Israeli troops bin identify and engage dem - and dem kill all of dem.
For dis stage, e be like say dem bin no achieve anytin wey dey particularly remarkable about di fight and di sojas no go back to di scene until Thursday morning.
Na dat time, as dem dey inspect di deadi body, one of dem resemble di Hamas leader well-well.
Dem leave di deadi body for di place sake of suspected ambush and instead, dem cut part of im finger wey dem send go Israel for test.
Dem finally remove im body, carry am go Israel later dat day wen di area bin don dey safe.
Daniel Hagari, di IDF tok-tok pesin, say di forces "bin no know say im dey dia but we continue to operate".
Im say im troops bin identify di three men as dem bin dey run from house to house, and engage dem before dem separate.
Di man wey dem identify as Sinwar "bin run alone into one of di buildings" and dem kill am afta drone locate am.
Dem believe say none of di hostages wey Sinwar bin dey use as human shield bin dey present and im small assistants suggests weda im bin dey try to move unnoticed, or im bin don lose many of di pipo wey dey protect am.
Yoav Gallant, Israel defence minister, say: "Sinwar die wen dem bin dey beat am, trouble am and im bin dey run – im no die like a commander, but like pesin wey bin. only care about imsef. Dis na clear message to all of our enemies."
Video allegedly show Sinwar last moments
Drone footage wey di Israeli military release late on Thursday bin show Sinwar final moments before dem kill am.
Di video look like wetin dem record from drone wey dey fly through di open window of a mostly destroyed building.
Di drone meet one man, wey cover im head, im sit down for one small armchair for di first floor of a house wey dirty full evriwia.
Di man, wey look like say im bin wound, bin throw wetin resemble stick towards di drone and di video end.

Sinwar 'killed'
Israel bin first announce say dem bin dey "investigate di possibility" say dem don kill Sinwar for Gaza on Thursday afternoon local time.
Within minutes of di announcement, pictures wey dem post for social media show di body of one man wey resemble di Hamas leader, wey bin get catastrophic head wounds. Di images no too good to republish.
However, officials warn say "for dis stage", dem neva fit confam di identity of any of di three men wey dem kill.
E no waste time afta dat, Israeli sources tell BBC say leaders dey "increasingly confident" say dem don kill am. However, dem tok say dem go do all necessary tests before dem fit confam di death.
Di tests no waste time. By Thursday evening, Israel don announce say dem don complete di tests and confam say Sinwar "don die".
Benjamin Netanyahu, di Israeli prime minister, say "evil" don "collect blow", but im warn say di Israeli war for Gaza neva complete.

Wia dis foto come from, Getty
Israel bin dey close in on Sinwar
Even though dem no kill Sinwar killed during one targeted operation, di IDF tok say dem bin don dey operate for di areas wia intelligence show say im dey dia.
In short, Israeli forces bin narrow Sinwar rough location to di southern city of Rafah, and dem bin dey move to di place small - small to get am.
Sinwar bin don dey run and hide for more dan one year. E sure say im bin don dey feel di pressure from Israeli wey dey grow as dem kill oda Hamas leaders, like Mohammad Dief and Ismail Haniyeh, and as Israel bin destroy di infrastructure wey im bin use to prosecute di atrocities of 7 October.
For statement, di IDF say dia operations in recent weeks for di south bin "restrict Yahya Sinwar operational movement sake of say di forces bin dey pursue am wey lead to im death".

Wia dis foto come from, Getty Images
Major goal, but e neva end
Killing Sinwar na major goal for Israel, wey mark am for death soon afta di 7 October attacks. But im death no go end di war for Gaza.
While Netanyahu say im bin "settle di score", im insist say di war go continue - at least to save di 101 hostages wey Hamas still hold.
"To di dear hostage families, I say: dis na important moment for di war. We go continue full force until all your loved ones, our loved ones, come back home."
For Israel, families of hostages say dem hope say ceasefire fit happun now so dat di hostages fit comeback home.

Wia dis foto come from, Getty Images












