Wetin be hantavirus wey dem confirm on one Atlantic cruise ship?
- Author, Yang Tian
- Read am in 2 mins
Three pipo don die afta suspected hantavirus outbreak for one cruise ship wey dey sail for Atlantic Ocean, according to World Health Organization (WHO).
One hantavirus case don dey confirmed, wit five more suspected cases wey dem still dey investigate, e tok.
WHO tell BBC say, "detailed investigations" into di suspected hantavirus cases "still dey go on, including more laboratory testing".
Di outbreak report come out onboard di MV Hondius cruise ship, wey dey travel from Argentina go Cape Verde.
Dis na wetin we know about hantavirus.
Wetin be hantavirus?
Hantavirus na group of viruses wey rodents dey carry, and e dey mainly spread go humans wen dem breathe in particles wey dey air from dry rodent poo poo.
Infections dey usually hapun wen di virus enter air from rodent urine, poo poo, or saliva, according to di US Centers for Disease Control and Prevention (CDC).
Though e rare, e fit still spread through rodent bite or scratch.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di virus fit cause two serious sickness. Di first one, Hantavirus Pulmonary Syndrome (HPS), dey usually start wit tiredness, fever, and muscle pain, before headache, dizziness, chills, and stomach wahala follow. If breathing problem start, di death rate na about 38%, according to CDC.
Di second sickness, Haemorrhagic Fever wit Renal syndrome (HFRS), dey more serious and e dey mainly affect di kidney. Later symptoms fit include low blood pressure, internal bleeding, and sudden kidney failure.
How many cases of hantavirus dey reported globally?
Dem estimate say about 150,000 cases of HFRS dey worldwide evri year, mostly for Europe and Asia, according to one report from di National Institutes of Health. More dan half of di cases dey usually happun for China.
Di latest data from di US show say from 1993, wen dem start to dey monitor hantavirus, reach 2023, na 890 cases dem record for di country.
However, Seoul virus, one of di main types of hantavirus wey Norway rats (wey dem also dey call brown rat) dey carry, dey found worldwide, including for di US.
How dem dey treat am?
No specific treatment dey for hantavirus infections.
CDC recommend supportive care to treat symptoms wey fit include oxygen therapy, mechanical ventilation, antiviral drugs and even dialysis.
Patients wey get serious symptoms fit need to enter hospital for intensive care units. For serious cases, some fit need make dem intubate dem.
CDC recommend make pipo avoid contact with rodents for house or workplace to reduce exposure to di virus.
Di agency still recommend make dem seal places wey rodents fit enter house, like basement or attic.
Dem still suggest make person wear protective gear wen e dey clean rodent droppings so e no go inhale contaminated air.
Dem don record recent hantavirus cases?
For February 2025, Betsy Arakawa, wife of Oscar-winning actor Gene Hackman, die from respiratory illness wey connect to hantavirus.
Medical investigators believe say Arakawa catch HPS - di most common strain for US - wey lead to her death.
Dem find nests and some dead rodents for di outbuildings of her house wia dem find her.
Police records show say Arakawa search internet for information about flu and Covid symptoms few days before she die.
Are you on the ship or do you know someone who is? If you feel able to do so, please get in touch












