Yoon Suk Yeol become South Korea first sitting president to chop arrest

President Yoon Suk Yeol addresses people

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

South Korea Yoon Suk Yeol don become di kontri first sitting president to chop arrest.

Im arrest don end a week-long standoff between investigators and im personal security.

Yoon failed attempt to impose martial law bin throw di kontri into kasala and parliament impeach am. Dem dey investigate am on charges of insurrection.

Technically, na im still be di president as a constitutional court gatz decide weda im impeachment dey valid.

Investigators bin use ladders and wirecutters inside di freezing cold to get to Yoon, wey im Presidential Security Service (PSS) personnel bin erect barricades to prevent im arrest.

South Korea president being escorted

Wia dis foto come from, Reuters

Di 64-year-old leader say im agree to agree bifor di Corruption Investigation Office for high ranking officials (CIO) to avoid bloodshed.

For one three-minute video message, Yoon say im go comply wit di investigation against am even though im dey against am.

E don consistently maintain say di warrant for im arrest no dey legally valid.

Yoon say im witness how authorities "invade" im home security perimeter wit fire equipment.

"I decide to appear bifor di CIO, even though na illegal investigation, in order to prevent any unsavoury bloodshed," e tok.

More dan 1,000 officers bin dey part of Wednesday dawn operation, wey mark di second time officers bin try to arrest am.

Di CIO wey dey investigate Yoon, previously attempt to arrest am on 3 January.

Dem bin obtain di warrant afta e ignore multiple summonses to appear for questioning.

Yoon People Power Party condemn im arrest as "illegal" and floor leader Kweon Seong-dong say Wednesday event dey "regretful".

On di oda hand, di floor leader of di opposition Democratic Party, Park Chan-dae, say Yoon arrest show say "justice for South Korea dey alive".

Dis arrest "na di first step toward restoring constitutional order, democracy and di rule of law," e tok during one party meeting.

Na Finance Minister Choi Sang-mok dey currently lead di kontri as as acting president. E assume power afta di first acting president, Han Duck-soo, also chop impeachment by opposition majority parliament.

Police officers cut a wire fence set up at the entrance to the official residence of impeached South Korean President Yoon Suk Yeol, as authorities seek to execute an arrest warrant, in Seoul, South Korea, January 15, 2025.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Despite freezing temperatures, authorities cut through barbed wire to reach Yoon

On Wednesday afternoon, investigators say dem dey question Yoon but im don invoke din right to remain silent.

Yoon dey expected to dey detained overnight at di Seoul Detention Centre for Uiwang, Gyeonggi Province, approximately 5km (3 mi) from di CIO office.

If a court no issue a detention warrant within 48 hours of Yoon arrest, however, e go dey released, and free to return to di presidential residence.

Pro-Yoon supporters don continue to protest against di arrest outside di investigating office, wia dem dey hold am.

Dem bin gada outside Yoon house on Wednesday morning, along wit dose wey dey oppose am.

Di anti-Yoon crowd cheer, clap and blast out a "congratulations and celebrations" song wen im arrest bin dey announced.

Di pro-Yoon camp, however, bin dey dismayed. "We dey veri upset and angry - di rule of law don dey broken down," a supporter tell di BBC.

While di vast majority of South Koreans agree say Yoon gatz dey held accountable for di martial law order, dem no fit agree on wetin accountability look like, Duyeon Kim, wey be adjunct senior fellow at di Center for a New American Security earlier tell di BBC.

On Wednesday morning, di two sides underscore di deep divisions for di kontri - a sign say di political crisis neva dey ova yet as more uncertainty loom.