Who be Peter Hegseth wey Trump nominate for secretary of defence?

Peter Hegseth, Trump defence secretary nominee dey face Senate Committee

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Former Fox News host and military veteran Pete Hegseth, wey U.S. President-elect Donald Trump nominate for defence secretary, dey hot seat for Senate committee.

Hegseth na di first among pipo wey Oga Trump nominate wey Senate don grill as part of di process to approve or deny dem di office wey di president-elect nominate dem for.

If di U.S. Senate approve im nomination, 44 years old Hegseth go be di youngest Pentagon chief in many many years.

One of di reasons wey make dem fire Hegseth plenty question na sake of say many dey see am as outsider for dis job sake of say im no get experience.

Hegseth bin face many challenging questions from Senate Including wetin in tink about women for military, di LGBTQ community, di war for Gaza and sexual misconduct allegations, wey top Democratic Senator, Jack Reed, say dey "extremely alarming."

Tins to sabi about Peter Hegseth

By choosing Fox News Channel host Pete Hegseth to lead di Department of Defence, Oga Trump select military veteran and popular conservative media personality wey get im own plenty followers.

Hegseth bin don develop close connection wit Trump tey tey, sotey im bin wan give am post for im first administration.

For im latest book, im say dem need to "clean house for di military, as "woke" generals and leaders of elite service academies don make di military dangerously weak make dem dey behave like women, by promoting inclusion and diversity.

Like Trump, im sharply criticise NATO supporter wey im say, no dey spend enough money on dia own defence.

E call NATO "self-righteous and impotent kontris wey dey ask us to honour olden-days, one-sided defence arrangements wey even dem no send."

Hegseth writing no approve policies, laws and treaties wey limit warfighters for battlefield, including di rules of engagement and Geneva Conventions, wey im say na olden-days method against enemies wey no dey obey dem.

Di defence secretary nominee no get time for di moral kwesions wey concern war.

Wen im tok about how America drop nuclear bombs on Japan to end World War II, im write for im book say, "Dem win. Who care."

Im don dey beg for presidential pardon for some US soldiers wey dey face crimes

Im want make dem change di name Defence Department back to im original name, War Department.

E also want make dem implement one 10-year ban on generals wey dey work for defence contractors afta dem retire from military.

But wen Senator Elizabeth Warren ask am weda im too go agree to di 10 years ban policy, im ansa say, "I no be general, senator."

Di defence secretary nominee no believe say women suppose dey for military.

During one interview for "Di Shawn Ryan Show" podcast to promote im new book, Hegseth say "I straight up just dey say we no suppose get women for combat roles — e no make us us more effective, e no make us more lethal, e don make fighting more complicated."

By opening combat slots to women, "we don change di standards we we take put dem dia, which mean say you don change di capability of dat unit,"

But for di hot seat, im say di women wey im bin serve wit na some of di best soldiers wey im don work wit. Still im say, e dey important to make sure say di standards na di same for both men and women.

Who be Peter Hegseth

Peter Hegseth na journalist and military veteran, although im lacks senior military or national security experience.

Afta im graduate from Princeton University for 2003, dem commission am as infantry officer for di Army National Guard, wey serve overseas for Afghanistan and Iraq as well as Guantanamo Bay.

Im be former head of Concerned Veterans for America, one group wey conservative billionaires Charles and David Koch dey support, and also unsuccessfully contest for Senate for Minnesota for 2012.

Im get master degree in public policy from Harvard University John F. Kennedy School of Goment.

For 2016 Trump bin consider Hegseth to run di Department of Veterans Affairs. Later for 208, im consider am for again wen Secretary David Shulkin face criticism before dem remove am from office.

As Co-host of Fox News Channel "Fox & Friends Weekend," Hegseth be contributor to di network for for 10 years.

Im don also write several books including "Di War on Warriors."

As Trump bin dey announce Hegseth nomination, im compliment di book say, "nine weeks on New York Times best-sellers list, including two weeks as NUMBER ONE."

If Hegseth succeed, im go lead Pentagon wit all di plenty palava wey e dey face for different sides, including Russia war for Ukraine, di attacks wey dey happun for Middle East, di war between Israel and Hamas and Hezbollah, and worry about growing alliance between Russia and North Korea.

For Trump first administration, na five men bin serve as defence secretary inside four years.

Many of di generals wey bin work wit am for di first administration — both on active duty and retired — say im dey unfit to serve for di Oval Office. Im sef condemn dem too.