TikTok Users don dey run go Chinese app RedNote as US ban dey near

Pesin dey look at RedNote

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, "TikTok refugees" dey run enta Chinese app RedNote bifor di US ban
    • Author, Koh Ewe
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

TikTok users for di US don dey migrate to Chinese app wey dem dey call RedNote as na just days remain till di ban hit.

Di move by users wey dey call demselves "TokTok refugees" don make RedNote di most downloaded app for Apple' US App Store on Monday.

RedNote na TikTok competition wey dey popular wit young pipo for China, Taiwan and oda places wey dem dey speak Mandarin.

E get like 300 million monthly users and look like collabo of TikTok and Instagram. E dey allow users, wey be mostly young city women to exchange lifestyle tips from dating to fashion.

Supreme Court justices go soon rule for law wey set 19 January deadline for TikTok to either sell dia US operations or face ban for di kontri.

TikTok don tok plenti times say dem no dey sell dia US business and dia lawyer don warn say ban go go against free speech protections for di 170 users of id app for di US.

RedNote don dey welcome dia new users wit open arms. Pipo don post about 63,000 piece of content on top di topic of "TikTok refugees" and for dia dem dey teach new users how to find dia way round di app and also dem go fit use basic Chinese phrases.

One new US user write say, "to our Chinese hosts, thank you say go get us, abeg no vex about di kasala in advance."

But like TikTok tori dey say censorship for RedNote also dey wen e come to di mata of criticizing di Chinese goment.

For Taiwan, public officials no fit use RedNote sake of alleged security risks of Chinese Software.

As more US users dey enta RedNote, some Chinese users don dey use play-play dey call demselves say dem be "Chinese spies". Dis na bicos of US official concerns wey say TikTok fit dey used by China to take spy and do political manipulation.

RedNote Chinese name Xiaohongshu mean Little Red Book but di app say no be bicos of di Chinese communist leader Mao Zedong book of quotations wey get di same name.

But security concerns no dey worry di users wey dey run enta RedNote.

Serah Fotheringham wey be 37 year old school canteen worker for Utak say she move go RedNote to "snub" di goment.

Ms Fotheringham tell BBC for RedNote message say "I just be simple pesin wey dey live simple life. I no get anytin wey China no get and if dem want my data like dat, make dem carry am go."

Marcus Robinson wey be fashion designer for Virginia, say im create im own RedNote account ova di weekend so im go fit share im clothing brand and "dey ahead of di curve".

Oga Robinson tell BBC say e bin fear just small bifor im accept di terms and conditions to use di app wey dem bin write for Mandarin.

E tok say, "I bin no fit read am so I worry small but I just take my chance."

TokTok ban protesters

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo don dey protest di ban since e bin dey announced

While ban no go mean say TikTok go disappear immediately, e go mean say app stores no go offer am again wey go kill am overtime.

But even if TikTok no get banned again, e no go mean much to di di pipo wey dey go oda platforms.

Some social media users tell di BBC say dem dey scroll for RedNote pass TikTok.

Tennessee tech worker Sydney Crawley tell BBC say "even if TikTok stay I go kontinu to dey use my platform wey I build for RedNote".

Ms Crawley say she bin get ova 6,000 followers within 24 hours wey she create her RedNote account.

Ms Fotheringam, di canteen worker tok say RedNote don "open my world up to China and im pipo."

She say, "I now see tins wey I for neva see. Regular Chinese pipo, dey find out about dia culture, life, school, everytin and e be fun."

Oga Robinson di designer tok say, di community so far don dey "super welcoming".

"I love RedNote so far... e just remain for me to learn Mandarin."