50,000 pipo don die for Gaza, Hamas-run health ministry tok

Woman holding a baby in the middle of ruins following an attack, with others comforting each other or looking through the rubble

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Much of Gaza has been destroyed during the war
    • Author, Tom Bennett
    • Role, BBC News
    • Reporting from, London
  • Read am in 4 mins

More dan 50,000 Palestinians don dey killed during Israel military campaign for Gaza, di territory Hamas-run health ministry announce.

Dat number - 50,021 - na about 2.1% of di 2.3 million pre-war population of di territory, or around 1 in 46 pipo.

A total of 113,274 odas don injure for di same period, di health ministry tok.

Figures from di Gaza Ministry of Health (MoH) don dey widely used throughout di war and dey seen as reliable by di United Nations (UN) and international institutions. But Israel don consistently discredit data wey Gaza authorities publish.

International journalists, including di BBC, dey blocked by Israel from entering Gaza independently, so dem no dey able to verify figures from either side.

Di figures wey di MoH release for di number of pipo wey dey killed no differentiate between civilians and fighters.

For November, di UN Human Rights Office tok say analysis show say close to 70% of verified victims ova a six-month period na women and children.

For January, Di Lancet medical journal bin publish one study wey suggest say death toll fit in fact dey sustainably higher dan official figures wey MoH bin report - by up to 41%.

Na Hamas attack on Israel on 7 October 2023 trigger di war - na about 1,200 pipo, mainly civilians, dem kill and take 251 odas hostages.

Israel bin respond to di 7 October attack wit massive military offensive, wey don cause ogbonge destruction to homes and infrastructure, in addition to dose wey dem kill or injure.

Di MoH also bin report on Sunday at least 39 deaths inside di last 24 hours, to bring di total number of pipo wey dey killed to 673 since Israel resume im military operations for di territory on Tuesday.

Israeli air strike kill top Hamas official for Gaza

Salah al-Bardaweel speaking into a number of microphones on 15 February 2015 in Gaza city

Wia dis foto come from, NurPhoto via Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem kill senior Hamas figure Salah al-Bardaweel for Khan Younis. Na 2015 dem take dis photo

Meanwhile, one Israeli air strike on di southern city of Khan Younis for Gaza don kill top Hamas political leader Salah al-Bardaweel, one Hamas official tell di BBC.

Locals say di air strike bin kill both Bardaweel, wey dem regard as Hamas highest-ranking political leader, and im wife. Israeli officials neva make comment.

Israel bin resume heavy strikes on Gaza earlier dis week - and dis end di first phase of ceasefire wey last almost two months. Dem blame Hamas for rejecting one new US proposal to extend di truce.

Hamas, in turn, bin accuse Israel say dem abandon di original deal - wey Qatar, Egypt and di US bin mediate. Dem envisage di withdrawal of Israeli troops and di subsequent release of Israeli hostages and Palestinian prisoners - in addition to negotiations to end di war entirely and reconstruct Gaza.

For one statement on Sunday, Hamas say Bardaweel, 66, bin dey play wit im wife wen Israeli missile strike dia tent.

Bardaweel na papa of eight, and im na one of Hamas most prominent political figures.

Dem born am for Khan Younis refugee camp - e dey known to dey close to Hamas leader Yahya Sinwar and e dey considered part of di second generation of Hamas leadership, following di movement founders.

Im bin head di political wing of Hamas parliamentary bloc and dem re-elect am to di group political bureau for 2021.

Afta di killing of Sinwar and Rawhi Mushtaha during di ongoing war, Bardaweel bin dey regarded as Hamas highest-ranking political leader.

Di airstrike wey kill Bardaweel na part of one of di most intense waves of aerial bombardment for southern Gaza since di collapse of di ceasefire agreement last Tuesday.

One tok-tok pesin for di Palestinian Red Crescent Society tell di BBC say Israeli forces bin dey surround several of di organisation ambulances as dem attempt to reach one area wey Israeli strike bin hit for Rafah.

E add say several paramedics bin dey wounded, and contact don dey lost wit one of di trapped teams, wey don dey besieged for hours.

Di Israeli military bin issue evacuation orders for residents of di Tel al-Sultan neighbourhood for western Rafah afta di area bin dey hit by heavy shelling and limited ground assault.

Di attack bin include tank fire from Israeli forces wey dey positioned along di Philadelphi Corridor on di border wit Egypt, and helicopters also take part in di assault.

Alaa al-Din Sabah, a resident of di neighbourhood, say for one voice message to di BBC: "Bullets dey rain down on us like e dey pour. Dem shoot one woman and she dey bleed. Ambulances no fit reach her."

"I fit see one of di paramedics wey dey lie on di ground, dey scream."