Over 400 pipo die after Israel strike Gaza overnight, Hamas ministry tok

Wia dis foto come from, Getty Images
More dan 400 die sake of Israeli air strikes on Gaza, according to di Hamas-run health ministry.
Di Israeli military tok say dem dey carry out "extensive" strikes afta di tok wey dem try to extend ceasefire fail. Na di biggest wave of strikes since 19 January, ween ceasefire start.
One eyewitness from Gaza City tok say, "Dem unleash di fire of hell again on Gaza."
One Palestinian official tell BBC dis say di attacks dey come afta talks to extend di Gaza ceasefire don fail, as di US dey accuse say Hamas dey make demand wey dey call "entirely impractical" for di meetings in Qatar.
Prime Minister Benjamin Netanyahu office tok say Israel go "from now on act against Hamas wit increasing military strength," dem accuse Hamas of "repeated refusal to release our hostages," and dey reject di proposals to extend ceasefire.
Hamas accuse Israel of attacking "defenceless civilians," and dem tok say mediators suppose hold Israel "fully responsible" for "violating and overturning" di ceasefire.

Wia dis foto come from, Reuters
Israel tok say 59 hostages still dey for Gaza, and up to 24 of dem dey alive. One group wey represent di hostage families accuse di Israeli goment say dem "choose to give up di hostages" by launching new strikes.
More dan 50 children and 28 women dey among di pipo wey don die for di strikes wey target several areas across di region.
Di Israeli gonment tell White House before dem launch di strikes, one Israeli official tell BBC US partner CBS.
For di last hour or so, di calm don return small for Gaza, but hospitals tok say dem don receive more dan 250 pipo wey injure.
Some of dem dey in very critical condition, and dem dey try manage di lack of facilities and medical equipment.
Di intensity of di air strikes don reduce small since dem start around 02:00 local time, but dem still dey go on.
Most of di pipo for dat time bin dey prepare di pre-dawn Ramadan meal, so dem go don dey awake wen di attacks happun.
Since di ceasefire, pipo bin dey live for tents but at least dem no dey fear until di shocking news last night.
As di strikes dey kontinu, many pipo don start dey run to areas wey dem tink say e safe. Israel don advise Gazan pipo to go to Khan Younis for di south, or western areas of Gaza City.

Wia dis foto come from, Getty Images
Our big fear don happun, Israeli hostage families group tok
"Di biggest fear of di families, di kidnapped pipo, and di citizens of Israel don come true," na wetin di Hostages and Missing Families Forum talk.
"Di Israeli goment don choose to give up di hostages." Dia statement show shock and anger over wetin dem call "deliberate dismantling of di process to return our loved ones". Dem tok say Israel and Hamas "must return to di ceasefire" and dem call on US President Donald Trump, wey tok say e go end di war, to "kontinu to act as e don tok and act so far". Israel tok say 59 hostages still dey for Gaza, wit up to 24 wey dem believe say dem still dey alive.
Dis morning, Israeli PM Benjamin Netanyahu office tok say di air strikes today na response to Hamas "repeated refusal to release our hostages", and to Hamas "rejection of all di proposals" to extend di ceasefire.
Some fotos wey show destruction across Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images








