All allegations Rivers House of Assembly members sama Govnor Fubara and im deputy

Di political crisis for Rivers State dom enta anoda stage as di State House of Assembly lawmakers dey accuse Govnor Siminalayi Fubara and im deputy Prof. Ngozi Odu of gross misconduct.
Twenty-six members of di Rivers Assembly raise di allegation for two letters wey dem send to di speaker Martin Amaewhule
Dem say di action dey "in compliance wit Section 188 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended) and oda extant laws" wey mandate say such allegations go dey signed by at least one-third of di House members and specify di particulars of di misconduct.
Do letters wey dey signed by di 26 lawmakers bin dey presented during Monday plenary session in compliance with Section 188 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria (as amended), 1999.
Di Speaker dey required to ensure say di notices dey served on di office holders and all members of di House within seven days of receipt.
Allegations against Govnor Siminalayi Fubara

Di allegations give five specific instances of gross misconduct in separate notices addressed to both di govnor and di deputy govnor.
Dis na di allegations wey dem sama di govnor:
- Reckless and unconstitutional expenditure of public funds.
- Hindering or obstructing di Rivers State House of Assembly wey be anoda arm of di goment.
- Appointment of pesins to occupy offices/positions in di Rivers State goment witout allowing di requirement of screening and confirmation.
- Seizure of salaries, allowances and funds wey stand to di credit of members of di legitimate Rivers State House of Assembly.
- Seizure of di salary of di Clerk of di Rivers State House of Assembly, Emeka Amadi.
Govnor Fubara neva comment on dis allegations.
Allegation against Deputy Govnor Ngozi Odu
Dis na di allegations against di deputy govnor, Prof. Ngozi Odu.
- "Conniving and supporting di illegal appointment of pesins to occupy offices/positions in di Rivers State goment witout allowing for di requirement of screening and confirmation".
Lawmakers dey wait for Govnor Fubara response
Upon receipt of di notice, Amaewhule transmit same to Govnor Fubara and say di allegation dey raised by "not less than one-third (1/3) of di membership of di Rivers State House of Assembly".
Speaker Amaewhule ask Fubara to reply to di allegations against am wey dey di 'Notice of Allegations of Gross Misconduct' accordingly".
"To do dis, your attention dey drawn to di provisions of Section 188(3) of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended), wey provide thus:
’Within 14 days of di presentation of di notice to di Speaker of di House of Assembly (weda or not any statement made by holder of di office in reply to di allegation contained in di notice) di House of Assembly go resolve by motion, without any debate weda or not di allegation go dey investigated'," na so di speaker tok for di letter e send to Govnor Fubara.
Dis development na anoda significant twist for di political tensions within Rivers State.
But e no dey clear how Govnor Fubara and im deputy go respond to dis allegations or address di increasing pressure from di legislative arm of goment.
Also, di State Assembly pass a resolution inviting di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to investigate di Secretary to di State Goment, Dr. Tammy Danagogo ova allegations of financial recklessness during im tenure.










