'I get one child and I lose am' - North Macedonia mourn nightclub disaster wey kill ova 50 pipo

Wia dis foto come from, Reuters
Marija Taseva bin dey enjoy a night out with her sister for di Pulse club for Kocani, North Macedonia, on Saturday wen disaster strike.
Dem bin dey watch DNK, one popular hip-hop group for di kontri, wen fire break out, wey kill at least 59 pipo and injure 155 odas.
"Everybody start to dey scream and shout 'get out, get out!'" di 19-year-old tell Reuters.
Pipo try hard to escape di flames but na only one exit dey for around 500 pipo, as di only oda door for di back of di venue bin dey locked.
"I no know how but I end up for ground, I no fit get up and at dat moment, pipo start to dey match me," Ms Taseva tok.
She eventually manage to get to safety, but her sister no fit.
"My sister die. I safe and she no safe."
Police don detain 15 pipo, with Interior Minister Pance Toskovski wey say grounds dey "for suspicion say bribery and corruption" dey linked to di fire.

Wia dis foto come from, Getty Images
Many don dey pay respects to di young victims
Di fire start around 02:30 local time (01:30 GMT) on Sunday wen sparks from pyrotechnic devices hit di ceiling, wey bin dey made of highly flammable material, Toskovski tok.
Di local press describe di club as "improvised nightclub", di venue dey town around 100km (60 miles) east of di capital, Skopje and e no get a legal licence to operate, Toskovski tok.
E be carpet warehouse before, and police dey investigate.
"Most of di dead suffer injuries from di stampede wey happun during panic while trying to exit," di head of di Kocani hospital, Kristina Serafimovska, tell reporters.
"Seventy of di patients get burns and carbon monoxide poisoning," she tok, according to AFP news agency.
Vladislav Gruev, wey be specialist in reconstructive and plastic surgery for di University Clinic for Surgical Diseases, dey treat survivors.
"Most of dem get serious burn injuries, above 18% surface body area, second and third degree burns for head, neck, upper torso, and upper limbs - hands and fingers," e tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
'Many young lives dey lost'
Inspections on Sunday show several "abnormalities" for di venue, including "deficiencies" for di fire-extinguishing and lighting system, public prosecutor office spokesman Biljana Arsovska tok.
Speaking outside di hospital, Red Cross volunteer Mustafa Saidov say di majority of those wey die be young pipo.
"Inside wia dem dey identify di victims, di situation dey far worse. You see say di parents also be young pipo, in dia 40s. Dia children be 18 or 20 years old."
"Di situation dey brutal, chaotic, di stories dey very sad, and unfortunately many young lives dey lost."
One man, wey im nephew injured for di fire, say some pipo never fot locate dia children.
Victims families dey wait for news of dia loved ones outside of di hospital.
Many dey vex and dey search for answers, like Dragi Stojanov, wey lose im only child for di fire.
"Make I tell you in front of everybody. Film me. I be dead man, I lost everything… di whole of Europe suppose know," e tell reporters.
"After dis tragedy, wetin I need dis life for? I no need am.
"I get one child and I lose am."
North Macedonia President Gordana Siljanovska-Davkova say dey need to be accountability for wetin happen.
"None of those wey responsible dis time suppose avoid di law, di justice and punishment too," she tok.
"Nothing dey worthier dan human life, specifically young life."
Dem carri di most seriously injured for treatment for specialist clinics for Bulgaria, Greece, Serbia and Turkey, she add.
Government don declare seven days of national mourning, and e go hold an emergency session as part of ongoing investigations into how di incident happen.









