At least 34 pipo die after tornadoes hit US

Wetin we call dis Video, US tornadoes: Extreme weather cause destruction
Read am in 4 mins

At least 34 pipo don died for US - including 12 for Missouri alone - after deadly tornadoes tear through some south-eastern states, destroying cars and pipo homes.

For Kansas, at least eight pipo die after more dan 55 vehicles bin dey involved inside one crash due to dust storm.

State of emergency don dey declared for several states, including Arkansas, Georgia and Oklahoma, wia more dan 100 wildfires dey burn.

More dan 250,000 properties no get light across seven states - including Michigan, Missouri and Illinois - overnight into Sunday, according to tracker PowerOutage.

More severe weather dey expected for di region, with tornado watches wey don dey issued across eastern Louisiana, western Georgia, central Tennessee and di western Florida Panhandle.

Woman stand in di middle of destruction for Poplar Bluff, Missouri on March 15, 2025

Wia dis foto come from, Getty Images

Six deaths also dey reported for Mississippi by Governor Tate Reeves, as several tornadoes spread across di state.

Flash flooding and flood warnings don also dey issued for central Mississippi, eastern Louisiana and western Tennessee; as well as parts of Alabama and Arkansas.

Di National Weather Service (NWS) don say dis flash floods fit dey deadly.

Multiple tornado warnings also dey issued across Alabama on Saturday night.

NWS warn of "multiple intense to violent long-track tornadoes" for those areas, describing di situation as "particularly dangerous".

Di meteorological agency say: "If you live for dis areas, go to di strongest structure you fit access and remain in place until di storms pass."

Dem don record wind of up to 60mph (97km/h) for Shelby, Tennessee, according to NWS data.

Missouri emergency management agency say initial reports show say 19 tornadoes strike 25 counties so far.

One home belonging to one of di 12 pipo wey die for Missouri bin dey torn apart by a tornado.

"E dey unrecognisable as a home. Just destruction field," Coroner Jim Akers of Butler County tell CBS News, as rescuers go di scene.

"Di floor dey upside down. We bin dey waka on walls."

Arkansas don record three deaths and 29 injuries - wey make Govnor Sarah Huckabee Sanders to declare a state of emergency.

Georgia govnor, Brian Kemp, also declare a state of emergency, while Oklahoma Govnor Kevin Stitt confirm say one person don die for di state.

Four deaths don dey recorded for Texas.

Di destructive storms cause more dan 100 wildfires inside several central states and overturn multiple semi-trailer trucks, CBS report.

For Oklahoma, one of those fires, known as di 840 Road Fire, don already burn 27,500 acres and e remain 0% contained, according to di Oklahoma Forestry Service. Di agency don issue a "red flag" warning for di state panhandle area.

House wey destroy for Missouri

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For Missouri, officials don confam 11 deaths so far

Wetin be tornadoes?

Tornadoes dey form wen moist, warm air rise, mixing with cold air above to form thunderclouds.

Winds wey dey blow from different directions go cause di air to rotate, creating one show of air moving upwards.

Four states wia dem don confam tornado-related deaths inside di past day lie within a path wey dey dey frequently hit by dis weather phenomenon.

Dem don name dat stretch of US di unofficial name Tornado Alley, because im geography dey ideal for tornado formation.

For 2024, 54 pipo die for tornado-related incidents, according to Noaa. Nine pipo die for Texas. Eight for Oklahoma, five for Arkansas and one for Missouri.

Peak tornado season for Tornado Alley na from May to June - but meteorologists warn say tornadoes fit happun at any time of di year.

Meanwhile, Georgia Govnor Brian Kemp declare a state of emergency on Saturday, as di deadly severe weather pattern dey predicted to hit im state by Sunday morning.

"Be prepared ahead of time and remain weather aware as long as dis system dey di state," e tok inside one post on X.

More severe weather don dey predicted for parts of di southeast through to Sunday morning.