Police use tear gas pursue women wey block road as Wike show for Abalama inside Rivers state

Protesting women
Wetin we call dis foto, Some women block di road leading to di community to protest as di FCT Minster Nyesom Wike bin dey come di community
Read am in 4 mins

Police use tear gas pursue some women wey go block di road to Abalama, one community for Asari-Toru local goment area of Rivers State For southern Nigeria.

Reports say di protesting women wey wear black cloth and tie white cloth round dia head block di road as di arrival of di FCT Minister Nyesom Wike bin dey expected for one grand reception wey some of im supporters for Kalabari land dey hold for am for Community Secondary School field Abalama.

Di women dey react to di alleged insult wey dem claim say di FCT Minister do to Ijaw pipo for one interview wey e grant for Abuja wia e call ijaw pipo 'minority of minorities' on Wednesday 12 March 2025.

Dis na as di FCT Minister wey be di immediate past govnor of Rivers State also don dey in a political crises with im successor, Govnor Siminalayi Fubara, wey be Ijaw for a while now.

Protesting women

Earlier on, di grand reception for Wike bin don dey cancelled by di traditional institution to avoid possible break down of law and order becos di Eastern zone of di Ijaw Youth Congress IYC bin don also call for emergency meeting for di same venue, Community Secondary School field Abalama, wia di grand reception suppose hold.

For statement signed by seven Kalabari traditional rulers led by HRH, King Lawrence O. O. Odum (Odum Barboy IX), Amanyanabo of Bakana and Chairman, Degema Area Council of Traditional Rulers and Chiefs, di Forum of Traditional rulers of Kalabari Ethnic Nationality cancel any activity dia.

Dem call on di state, di govnor and heads of various security agencies for di state to stop a potential violent clash for Kalabari land between two opposing groups wey fit lead to bloodshed.

"We dey concerned say di clash of venues for di planned events by di two opposing groups, if not addressed, fit cause a possible breach of peace and order for di area.

Dis fit potentially threaten di existing peace for Abalama Community and di rest of Kalabari land.

Di Traditional Rulers of di Kalabari Ethnic Nationality therefore appeal to both parties to relocate dia events elsewia, possibly outside Kalabari land, to stop a possible violent clash for di area." Di statement bin tok.

Despite dis, organisers of di grand reception for Wike still go ahead with di occasion before di women protesters go block di road.

FCT minister Nyesom Wike

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, FCT Minister Nyesom Wike dey Abalama for thanksgiving and grand reception

Meanwhile, di FCT Minsiter Nyesom Wike land Abalama community for di thanksgiving and grand reception wey im supporters, di N.E.W. Rivers Associates, organise for am and e bin mengtion di protest and oda issues.

"Ijaw pipo no be evil pipo. My interview bin dey misunderstood," na wetin Wike tok wen e land for di grand reception wey im supporters organise for am for Abalama, Asari Toru LGA.

E say ordinarily, e no dey like tins like dis but e come di reception becos some pipo bin say e no go fit come Kalabari land and e wan prove dem wrong.

Wike appreciate di reception for am wey happen despite reactions to im Abuja interview for media as e say pipo dey misunderstand wetin im tok and dey take am anoda wey.

Wike explain say wetin e tok be say, "all of us dey work togeda and if we no work togeda, e for dey difficult to produce a govnor.

Wike say wen dem be dey decide who go be di next govnor, di present govnor bin say e no go run but some prominent elders for di state naim insist say di next govnor suppose come from Ijaw extraction make e no be like say na only one side dey rule.

"So no be becos of di strength or power of Ijaw but na becos we dey work togeda. Live and let live. So you no go fit at evri time dey tok anyhow and make nobodi at anytime associate anytin evil to Ijaw. Ijaw pipo no dey evil.

But no be say evri time sometin happen, di next tin you go dey hear na say dem go blow pipeline. No! Engage pipo intellectually. Engage pipo diplomatically and you go get whatever you wan get.

Di world we dey today don pass wia you go dey threaten anybodi." Wike tok.

Wike also say im bin tok say di 27 lawmakers no go lose dia seats and na so e don happen.

E also say wetin dem do, call am local goment election no go stand and now e dey cancelled come add say, im no need to be govnor to know say wetin dey illegal dey illegal and as for any fight, e go fight am constitutionally and follow due process as di rule of law dey key.