Rivers state Govnor Fubara dey locked out of assembly complex as e go present budget, Wike justify action

Wia dis foto come from, Rivers State Govt House Media
Di political crises for Rivers State take anoda turn wen di Assembly members refuse to open gate for di state govnor wen e go to present di 2025 state budget to dem for dia Assembly quarters for Port Harcourt.
Rivers State Govnor, Siminalayi Fubara bin go di Rivers State House of Assembly to present di budget as requested by di members of di state assembly but meet a locked gate and all effort to reach di lawmakers to open di gate no work.
Di govnor through di secretary to di state government bin don officially write to di speaker of di assembly to inform am say e dey come present di budget on Wednesday 12 March 2025.
Di govnor wey come with media pipo come tell dem say, e arrive di location to comply with di demand of di lawmakers but meet di situation wia dem lock am out and all efforts to reach dem no dey successful.
“I don make several attempts by phone call to reach di speaker and oda members. I also send a letter personally to di honourable speaker for dia particular invitation but e dey unfortunate say we dey di gate and di place dey completely sealed and no sign dey say anytin go happun today.
Di reason why we dey do dis na for di interest of our pipo wey be di most important tin.
Well I no tink dia is anytin to worry about. Maybe dem dey work on di letter and I expect to hear from dem maybe after dis hour. “ di govnor tok.

Wike justify assembly decision
Meanwhile, di minister of di Federal Capital Territory, FCT, Nyesom Wike don justify di decision of di Rivers State House of Assembly to lock out di govnor, Sim Fubara, from di Assembly quarters wen di govnor go present di 2025 budget in obedience to di Supreme Court judgement.
Wen dem ask am about di development for Port Harcourt, specifically as di govnor no fit see di assemblymen for di budget presentation, Wike say di govnor suppose wait for a response from di Assembly before e go dia.
Wike say na di govnor bring down di assembly complex and make dem to dey sit for di assembly quarters.
According to Wike, Fubara suppose respect di privacy of di legislators and know say dem and dia family members fit no dey ready to receive am for di quarters as at di time e reach dia. (about 11:00 am).
Wike say di decision of di govnor to go dia wen e never hear from di legislators dey nonsensical.
Wike also blame di govnor of Bayelsa State and all oda govnors of di PDP and members of di NWC wey insist say di party zonal congress wey hold for Calabar no get head.
E also dare any of di PDP govnors to look at am for eyes and tell am say di south south congress no go stand, even as e say e no get any plans to quit di PDP.










