At least thirty die and 90 injure for stampede for India Kumbh festival
At least thirty pipo don die and 90 odas injure for one crush wey happun for one very big religious festival for north of India.
India officials wey finally announce di number of victims more dan 14 hours afta di stampede happun, say dem don fit identify 25 out of di thirty wey die.
Pipo wey dey involved for di incident include those wey travel from states like Gujarat and Assam to attend di festival, officials tok.
Di incident happun between 1am and 2am local time (19:30 and 20:30GMT) wen some pilgrims bin try jump over police barricades to reach Sangam Nose.
Sangam Nose na di point wia India most sacred River Ganges meet Yamuna and di mythical Saraswati rivers.
Wit more dan 12 hours since di crush, authorities neva still give official confirmation of how many pipo wey wunjure or die, though sources tell BBC say at least 12 pipo na im dem kill for di crush.
Prime Minister Narendra Modi for one post on X (formerly Twitter) offered im condolences to devotees wey lost family members.
"Di accident wey happun for Prayagraj Maha Kumbh dey extremely sad. My deepest condolences to devotees wey don lost dia loved ones for dis," Modi write on X.
Im post na di first official confirmation say pipo die for di crush.
Earlier, Chief Minister of Uttar Pradesh, Yogi Adityanath, confam say di crush happun and also tok about serious injuries, but im no mention deaths.
Modi say im dey constantly in touch wit di state goment and im don speak wit Adityanath about di incident.
BBC Samira Hussain describe di site of di crush as "absolute chaos" for di river bank, wit clothes, shoes, blankets and backpacks wey dem thruway for ground as crowds try to escape.
Officials say up to 100 million pipo n aim dem bin expect to attend today – dem say more dan 36 million don already baff by 10:00 India time.
Kumbh Mela na one of one of di world biggest religious festivals, and Wednesday na di most important day for bathing during di festival.
Na di day wey dem dey celebrate as Mauni Amavasya, di day for silent introspection.
But, despite say di organisers bin suspend di famous baff ritual, BBC Vikas Pandey say "tens of thousands still dey try take di holy dip."
Now dem say dem go to Sangam for di baff but dem go reduce di number of pipo wey go follow for di procession.
Twelve hours afta di crush, pipo still dey arrive for di festival.
Many still dey baff quietly away from di crowded Sangam Bathing on smaller banks.
Dis baff spot dey about 2km (1 mile) away from di confluence and get modest number of pipo wey dey deep demsef for di Ganges.
Many of of di pipo for di small banks chose to go dia instead of going to di confluence afta dem hear about di crush.

Wia dis foto come from, UP Information department
Why so many pipo dey visit Kumbh Mela?
Dem recognise Kumbh Mela dey recognised as di biggest gathering of human beings for world.
Di gathering dey dey so bg sotey you fit see am from space.
Di festival wey dem dey do once every 12 years, dey attract tens of millions of pilgrims, holy men and tourists.
Although dem dey do di Hindu festival for four Indian cities - Prayagraj, Haridwar, Nashik and Ujjain - di most wonderful gathering dey always occur for Prayagraj.
Worshippers dey come here in large numbers to bathe for Sangam – di meeting point of di sacred Ganges River wit Yamuna and mythical invisible Saraswati rivers.
Di worshippers believe say during Kumbh, di waters of di sacred rivers dey dey filled wit amrit (nectar) and to baff inside during di festival go clean dem of dia sins, help dem break free from di cycle of birth and death and help dem attain salvation.
Di presence of holy men wit ash on dem, some of dem dress only wit marigold garlands, na also big draw for many pilgrims wey come to ask for dia blessings.
Dis time, di crowd dey even bigger as goment authorities don declare di festival as Maha - great - Kumbh wey dey only happun afta 144 years.
Many of di pilgrims tell BBC say dem dey visit di Mela as dem no go get di opportunity again for dis life.
Anxious relatives dey search for missing loved ones
Anita Devi, wey come to attend di festival from di central city of Jhansi, dey desperately look for her husband.
"Im need im medicines but dem dey wit me. Wen di crush huppen, I lost hold of im hand and im disappear just like dat," she tell BBC.
"E don reach so many hours but I fit find am. Dis year dem get so many lost-and-found centres wey I no know wia im fit don go. I dey pray hard say im dey alive and safe."
Many pilgrims like her for Kumbh Mela still dey look for dia loved ones.
To loss for di festival na common tin, dat na why dem get lost-and-found centres for di festival site. Pipo dey go dia to request make dem make announcement for dia loved ones.
Some people wait for hours and even days but most dey eventually reunited wit dia families.
Di news of Wednesday crush don make many pipo more anxious dis time as dem fear di worst.

Why crowd crush too common for India
Crowd crushes na common tragedy for indiea wey dem mostly lead to loss of lives.
Just dis month, six pipo die for one crush for one of India richest temple for di town of Tirupati for southern Andhra Pradesh state.
Last year, over 120 pipo na im dem kill for Uttar Pradesh Hathras district during one religious gathering.
According to goment informate, 47 crush na im happun for India for 2021 and 2022, though e no clear how many pipo die for all dis crush.
Di main cause na very serious overcrowding for religious events, festivals, and public spaces.
While authorities dey generally okay for managing large gatherings, poor planning, inadequate crowd control, and lack of accountability dey make dis kain disasters inevitable.
Tight spaces, sudden surge, and di absence of emergency exits dey make di risk worse.
Even urban areas no get immunity from crowd crush - like di 2017 Mumbai railway station crush, wey kill 22.
Di tragedy occur for one footbridge during morning rush hour.
One 1997 cinema hall fire for Delhi, one of India worst fire tragedies, kill 59 pipo sake of toasphyxiation and injured 103 inside one panicked crowd crush during one screening of one Bollywood film.
Inside total darkness, balcony viewers bin rush go di exits without emergency lights or staff to guide dem.
Despite repeated tragedies, safety measure still remain weak, and authorities dey rarely face consequences.
Opposition leaders criticise goment for 'mismanagement'
Indian opposition leaders criticise di goment as dem allege say mismanagement na im lead to di Kumbh Mela crush at the Kumbh Mela.
"Mismanagement, mismanagement and administration special focus on VIP movement instead of common devotees dey responsible for dis tragic incident," Rahul Gandhi, opposition leader for parliament, post on X, as e call di incident "extremely sad".
President of Gandhi Congress party, Mallikarjun Kharge, also criticise Uttar Pradesh goment for "half-baked arrangements" and prioritising movement of VIPs.
Na Prime Minister Narendra Modi Bharatiya Janata Party dey govern Uttar Pradesh.










