'Na criminal conspiracy' - Indian preacher Bhole Baba tok afta ova 120 pipo die for religious gathering

Relative of one of di victims crying

Wia dis foto come from, Reuters

Na for one religious gathering for India ova 120 pipo bin die and di preacher wey dey in charge, Bhole Baba, don come out to tok im own side of di tori.

Di preacher wey lead di gathering don deny blame wey dem dey put ontop im head afta di incident bin happun on Tuesday, 2 July.

One lawyer to di preacher tell di BBC say di crush wey happun and di deaths na sake of "some anti-social elements". Di lawyer say na "criminal conspiracy hatched against" im client.

Bhole Baba wey im real name na Narayan Sakar Vishwa Hari say im go fully co-operate wit di investigation, im lawyer AP Singh say.

On Thursday, police say dem don arrest six pipo wey dey part of one committee wey organise di event.

'I bin hear screams den pipo begin fall ontop each oda' - Eyewitnesses recount horror of Hathras stampede wey kill ova 100

Na more dan 120 pipo don die for one religious gathering for northern India, according to wetin officials tok.

Di incident take place for satsang (one Hindu religious event) for Hathras district for Uttar Pradesh state.

Di victims wey dey affected bin include large number of women and some children wey dem still dey identify.

Man hold woman wey dey cry

How di incident take happun

Pipo wey survive di incident bin describe how di disaster bin happun as dem dey try comot di event for Mughalgarhi village.

One eyewitness tell BBC say everitin bin dey "go fine", until e reach one time wey pipo begin dey suddenly scream and fall ontop each oda.

"I bin hear screams and bifor I know wetin dey happun, pipo dey fall ontop each oda. Many pipo dey crushed and I no fit do much. I just dey lucky to survive.”

Anoda woman Shakuntala tell di Press Trust of India news agency say na wen di sermon for di gathering bin end pipo start to dey run out.

"Pipo bin fall for one drain by di road. Dem begin fall ontop each oda one by one and na dia dem dey crushed to death”

Umesh Kumar Tripathi wey be chief medical officer from di neighbouring district of Etah, tell reports say "stampede" bin kill at least three children.

Fotos wey fit turn pesin belle dey go round online.

Some videos show di pipo wey injure as dem dey take dem go hospitals for inside pick-up trucks and even motorbikes.

One clip wey BBC see bin show several bodies wey dey lie for di entrance of one local hospital as family pipo dey cry for help.

One family pesin say na "ogbonge accident wey happun but no single senior officer bin dey present at dat time. Where di administration dey?"

Mr Kumar say di venue dey too overcrowded and dem don form committee wey go investigate di incident.

"Di primary focus of di administration na to provide all possible help to di pipo wey wunjure" e tok.

Anoda official wey be Satya Prakash for district of Etah say dem go determine wetin cause di matter and dem go investigate am.

For Hathras, na different family members dey scream for local hospital as many pipo dey try find dia loved ones.

Na plenti bodies dem neva claim wey dey di hospital.

Tori be say shortage of ambulances dey and one bus dey bring two to three bodies as di whole Hathras dey filled wit pain.

Accidents na one tin wey dem dey always report during religious events for India sake of say ogbonge crowds dey always gather for tight spaces wey dem no go listen to safety instructions.

For 2018, around 60 pipo die afta one train run into crowd of pipo wey dey watch celebrations for Dusshera Hindu festival.