Children dey among eighteen pipo wey die for New Delhi station crush
- Author, Dilnawaz Pasha, Abhinav Goel & Alex Therrien
- Role, BBC Hindi and BBC News
- Reporting from, Delhi and London
- Read am in 3 mins
A crush at New Delhi Railway Station don leave around 18 pipo dead and at least 10 bin injure.
Thousands of pipo bin reportedly jampack inside di railway station on Saturday night as dem try to board delayed trains.
Four of di victims na children, while 10 na women, according to one list wey officials release.
Indian Prime Minister Narendra Modi say im thoughts dey "wit all dose wey lost dia loved ones" according to m post for X.
Crowd crushes dey common for India wia dem get frequent overcrowding for religious events, festivals and public spaces.
Di incident dey come weeks afta 30 pipo die for a pre-dawn crush for di religious festival, Kumbh Mela, in northern India, wia tens of millions of Hindus bin gada to bathe in sacred river waters on one of di holy days of di six-week event.
For Delhi, witnesses tell BBC Hindi say a "huge crowd" bin gada for di station, wey many pipo bin dey travel to and from di Kumbh Mela, wey dem hold for Prayagraj city in neighbouring Uttar Pradesh state.
Hundreds of pipo bin dey wait for trains to oda places.
According to officials, two trains don dey delayed for di station, while di third one wey dey head to Prayagraj bin dey wait to depart.
Ruby Devi say di crowd for di Indian capital main railway station dey so big she dey unable to get inside.
Umesh Giri, wey im wife Shilam Devi die for di crush say di crowd dey "uncontrollable" as e try to board di Prayagraj Express.
Dharmendra Singh wey dey also travel to Prayagraj, tell India PTI news agency say e get" far more pipo dan I don eva see at dis station".
"In front of me, dem carry six or seven women away on stretchers.
KPS Malhotra, deputy commissioner of police (railways), say authorities dey investigate wetin lead to di crush.
"Dis happun due to a delay for two trains wey dey arrive and more pipo gada for di station," e tok.
Opposition leaders don criticise di goment and accuse dem of administrative failure.
"Considering di large number of devotees wey dey go Prayagraj, beta arrangements suppose dey for di station," Rahul Gandhi, di leader of opposition for India parliament, post for X.
How you fit survive crush?
Di US goment Centre for Disease Control and Prevention (CDC) get advice for pipo make dem no hook inside crush, and wetin to do if you dey inside.
Di first tin dem suggest na to find di emergency exits and medical services wen you enta di event.
If you find yourself inside crush, di CDC dey advise say:
Keep your hands for di front of your chest like boxer and stand gidigba.
No resist di force of di crowd.
Wen di movement don pause, waka diagonally to di edge of di crowd.
Try to stay standing.
If you fall, protect yourself and form ball wit your bodi.
Stay calm and stand up as soon as you fit.










