Death toll for Indian landslides rise to ninety-three as dozens dey trapped

Wia dis foto come from, Reuters
At least 93 pipo don die and dozens dey trapped afta heavy rains trigger massive landslides for di southern Indian state of Kerala.
Di landslides hit areas wey dey for hill for Wayanad district early momo on Tuesday, 30 July.
Rescue operations still dey go on, but heavy rain and di collapse of one veri important bridge dey affect am.
"We go dey able to know di extent of di damage only afta few hours," state minister AK Saseendran tell BBC Hindi.
India army say dem don mobilise more dan 200 personnel to di area to assist security forces for dia search and rescue efforts.
Local hospitals dey treat at least 70 injured pipo, and around 250 pipo na in dem don rescue, shift go rescue camps so far.
Apart from di 36 confam deaths for Wayanad, dem don find nine bodis for di Chaliyar river, wey flow enta neighbouring Malappuram district.
Wayanad na district wey dey on top hill for di Western Ghats mountain range, e too dey get landslides during monsoon season.

Wia dis foto come from, Reuters
Di landslides don hit several areas for di district, including Mundakkai, Attamala, Chooralmala and Kunhome.
Videos for social media show as muddy water dey run through di streets and forest areas, dey wash away pipo house, den e kon make dem stranded.
One bridge wey connect Chooralmala to Mundakkai and Attamala don collapse, isolate di two places and make am difficult for rescue personnel to reach families wey dey trapped.
Rashid Padikkalparamban na resident, im tell Reuters news agency say na at least three landslides don hit di areas since around midnight, and wash di bridge comot.
State and national disaster relief teams dey do rescue operations, and army personnel dey expected to reach di area soon. Several area pipo too dey help wit di rescue.
Oga Saseendran also say dem don ask di army and air force make dem airlift families wey dey trapped plus build one temporary bridge.
Raghavan C Arunamala, dey live for di area, im describe di horror wey dey happun for di area.
“I see one man wey dey trapped inside di debris dey shout for help. Firefighters and rescue workers don dey try reach am for di last few hours," im tok.
“We fear say hundreds of pipo dey trapped inside di villages," im add.
Wayanad district and neighbouring areas dey on alert sake of forecast of heavy rains.
Schools and colleges don close for 10 of 14 districts.
For 2019, landslide kill 17 pipo for Puthumala for Wayanad, around 10km from di areas wey dey currently affected.
Prime Minister Narendra Modi post on X (formerly Twitter) say im don tok to Kerala Chief Minister Pinarayi Vijayan and assure am of federal goment help in relief efforts.
Modi also announce compensation of 200,000 rupees ($2,388; £1,857) to families of victims and 50,000 rupees to pipo wey wunjure.










