How dog help rescuers save man from South Africa collapsed building

Delvin Safers

Wia dis foto come from, Safers family

Wetin we call dis foto, Delvin Safers' family bin send a foto of im son Zyar to ginger am to stay alive under di rubble till help come

South African man Dion Safels and im family dey celebrate afta dem rescue in son from di collapsed building for South Africa afta three days.

Parents of 29 year old Delvin Safers follow BBC tok afta rescuers remove dia son from under di rubble of di building wey collapse on Monday for di South African coastal city of George.

Delvin Safers dey among di 29 survivors wey don dey free as rescue-and-search operations enta day three.

Di rescuers dey try to find 39 pipo wey still dey miss.

So far, authorities don confam say seven pipo die and dem don carry dia deadibody.

How dem take rescue Delvin

Delvin wey be one of di pipo wey bin dey trapped inside di rubble of di collapsed building attract attention sake of say im bin dey send heart to heart voice messages to im parents and girlfriend.

For di voice messages im bin dey tell dem how much im love dem. Im also express fear say im fit no come out alive.

Im father, Dion Safers, tell di BBC say im bin don dey panic, until on rescuer call dem for phone late on Tuesday to tell dem say dem don find Delvin.

Dem find Delvin wit di help sniffer dog wey start to barking to alert rescuers.

Di rescuers begin drill hole through di concrete until dem see im hand.

"Dem give am chocolate, water, mask and a pair of [protective] spectacles,” Dion add.

Delvin mama, Delmarie, tell di BBC say wen im bin dey trapped under di rubble, dem send am di picture of im two-year old boy, Zyar, to ginger am to stay positive.

"E work. E really work," she tok.

For one of im voice notes, for di Afrikaans language, to im girlfriend Nicole, Delvin say: “My love, my phone dey 5% now. E bin dey off. I just on am now to check"

Dem also hear as im dey cry wen im bin dey tok say: "I just hope say di [rescue teams] fit do dis tin sharp sharp because I no go fit make am. I no get any energy again. I don tire well well.”

Di site of di collapsed building

Wia dis foto come from, FB/George Municipality

Di five-storey apartment block wey bin dey under construction collapse on Monday for di popular tourist destination, along di scenic Garden Route for Western Cape province.

All di pipo wey bin dey trapped under di rubble, including Delvin, bin dey work for di site.

Out of di 29 survivors, six get life-threatening injuries and 16 dey critical condition for hospital.

Delvin wound well well for im his face, and all over im body.

Im bin no fit waka wen dem first bring am out, but im don dey waka now.

"He dey beta. Im dey smile. Wen I bin see as im dey waka na one of di greatest moments today," Delmarie tok, afta she visit am for hospital.

She add say "we dey hia to support all di oda families - dia sorrow na our sorrow grief".

Di rescue operation dey complex, and e involve 200 pipo wit sniffer dogs, heavy lifting equipment wey dey remove concrete blocks and debris by hand.

Di lifting equipment don move to di back of di site, to one underground car park.

Rescue teams say dem dey also deal wit collapsed areas wey dey difficult to reach.

Investigations still dey go on to know wetin cause di building collapse.

Dion say im dey vex say "brand new building just collapse", wey don cause deaths and injuries.

"We no fit believe am. Make dem hold di pipo responsible and pesin must go to jail for am," im tell di BBC.